MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday, 11 November 2016

IMAGINE FOR DIS KAIN HARD TIMES,NAIJA BAD GIRL,MAHEEDA,CARRY N500,000 TAKE DO ARMPIT OPERATION SO DAT SHE NOR GO DEY SWEAT FOR ARMPIT AGAIN



For pesin to wake up say na armpit surgery naim she won do,make you know say soup full dat pesin pot.
Naija Bad geh,Maheeda,carry 500k go do armpit operation so dat she go stop to sweat for armpit.
Dat money go do plenti tins for some pipo on top dis kondishon wey gofment put us.
Well na her money if she like she use am cook mess chop.
Oya Watch di vidio for bottom hia...


Thursday, 10 November 2016

CHiNEKE! ONE REGGAE MUSICIAN KINGSLEY ENO,DON BEG GOFMENT MAKE DEM STOP TO ARREST iGBO SMOKERS BICOS HE SAY,iGBO DEY CURE PARALYSIS,TUMOR AND OTHER SICKNESS


Winning Jah
Akordin to tori wey dey reach our table,Kano state born Reggae miuzishan,Kingsley Eno Osagie a.k.a 'Winning Jah', don yarn say smoking of igbo dey cure paralysis,tumor,depression and other sickness.
Bicos of dis one,him dey beg gofment make dem stop to arrest and jail igbo smokers.
Winning Jäh dey use him new song to preach to gofment say igbo good for di bodi.
Ok o we don hear.
But wait o..since wen Kano pesin don start to bear Kingsley Eno Osagie?
Anyway,di mesage wen he yarn,we don passam to our readers.

Wednesday, 9 November 2016

JEALOUSY! AFTA WIZKID WIN MTV EUROPE BEST AFRICA MIUZISHAN AWARD,TANZANIA PIPO DON DEY VEX BETA VEX AS DEM SAY,NA DiA PESiN ALIKIBA,NAiM SUPPOSE WIN Di AWARD


Tanzania pipo won start wetin dem nor go fit finish as dia boys and gehs don dey para for intanet say na dia bobo Alikiba naim sopose win di award wey Wizkid win for di MTV Europe Music awards for Rotterdam,Holland.
Wizzy win two awards.
Best Africa miuzishan and the best Worldwide miuzishan but now Tanzanians don start to konplain say na Alikiba award dem carry give Wizkid.
If you rememba last month,Wizkid and Alikiba bin get one small gbege for Kenya wen dem go play one show togeda wit Americana,Chris Brown.
Alikiba say naim popular pass Wizkid for dat area so diafor,make Wizkid first go stage biforam.
As if dat one neva rish,Tanzania pipo don start anoda round of wahala.
Una won turn una bronze to GOLD ovanite?
Make una kpror and go sidon for wia kontain una bicos di Starboy and Golden boy Wizkid,work hard for dis awards.
Ask Drake.

Tuesday, 8 November 2016

AFTA 10 YEARS WEY DEM STOPAM,MULTICHOICE NIGERIA DON ANNOUNCE Di RETURN OF ''BIG BROTHER NAIJA'' FOR JANUARY 2017


Na ten years ago naim dem do di first and last Big Brother Nigeria.
But now MultiChoice Nigeria don announce say dem Don readi to do anoda fresh one for January 2017 but dis time around na Big Brother Naija dem go call am.
Akordin to dem,na both DStv and GOtv go dey showam.
Wen di Genera Manager of MultiChoice Nigeria Mr John Ugbe yarn,he yarn say,dem don re-arrange di show afta dem sorsid for di arrangement of Big Brother Africa.
Dem also announce say,di audition for Big Brother Naija go appun for Lagos for 26 and 27 of Novemba.
Di money wey dem go win sef na gboah as na $100,000 dollars naim be di money wey dem win 10 years ago.
Katung Aduwak naim be di first winna.

Monday, 7 November 2016

NOLLYWOOD STAR,MERCY JOHNSON DON YARN SAY,E GET ONE TIME WEY FILM MAKERS NOR DEY GIVE HER WORK BICOS OF HER BLACK COLOUR AND BICOS SHE NOR BE YELLOW PAWPAW


Nollywood big name and actress Mercy Johnson,don yarn tori pipo say,e get one piriod wey her black kolor make many film makers nor gree dey givam Film to act.
Even for blackman land too?
Na wa o.
Abi na crime to be black again.
Dis kain tritment naim dey make some gehs dey bleach dia skin.

Sunday, 6 November 2016

Di OWNER OF COVENANT UNiVASiTi,BISHOP DAVID OYEDEPO,DON TALK SAY,NA GOD DEY IN SUPPORT OF Di HIGH SCHOOL FEES OF N814,500 WEY STUDENTS DEY PAY FOR Di SCHOOL


David Oyedepo,di bishop of di living faith church worldwide,don yarn say, God soport and approve di high school fees wey students of di school dey pay.
Akordin to wetin we find out,di shidren dey pay N814,500 as school fees and for one joinbodi sidon as e take concern Shiloh 2016 wey di bishop for talk,he say Baba God dey in soport ofam.
He also yarn say,make pipo wey dey yarn bad about di plenti school fees stopam if not,God go ponish dem.
Oyedepo say na so him heal one man of strong mouth odour and di man confess say he get dat mouth odour afta he yarn against di school fees.
Hmm..na wa for wire road.

LIE OR TRUE? AT 23 YEARS,DAVIDO DON TALK SAY HIM DEY MAKE OVER N35 MILLION FOR ONE WEEK


Abeg Davido,show me di babalawo wey do di jazz for you wey you take dey get 35 milla for one week.
I won dasham money.
Many pipo go soprise say di bobo yarn say,at di age of 23 him don dey make $100,000 America dollar dat is ova 35 million naira for Nigeria money.
Diaries God o!
I nor know weda make I biliv or not.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...