MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday, 7 December 2016

OUR LEADERS GET TO DO SOMETHING ABOUT OUR KONTRi AS UNITED NATIONS DON PICK 'KIGALI' WEY BE Di CAPITAL OF RWANDA AS Di MOST BEAUTIFUL CITY FOR AFRICA



Two years ago,Wen my forma oga comeback from Kigali wey be di capita of Rwanda,he tell us say dat place neat die.
And now wey United Nations don choose am as di most biutifu city for Africa,I nor dey soprise.
Na only bad tins we for dey carry first.
Last year,na Port Harcourt airport win di most worwor airport for di world.
War niali skata Rwanda for ground and dia Lida's still get mind like dis.
E be like say na to sell dis kontri naim remain.

Tuesday, 6 December 2016

IF U WAKE UP AND HEAR SAY GOVMENT DON BAN SUYA AND ISI-EWU ONE DAY,NOR SURPRISE BICOS MINISTA OF HEALTH,ISAAC ADEWOLE SAY ALL DIS FOOD DEY KILL NAIJA PIPO EVRiDAY


Na wa o!
Dem Don carry rish wia enjoyment dey?
I nor sure say dis one go work o,as many Naija pipo don disagree wit di minista of health professor Isaac Adewole say eating of suya,isi-ewu,kilishi,nkwobi,ngwongwo dey kill.
Akordin to di minista,all dis food nor good for bodi bicos dem dey add plenti salt and salt nor too good for bodi.
Also Mineral and all dis chocolate nor good for bodi too bicos of plenti sugar wey full inside.
He say all dis tins dey cause highpatenshon wey fit result to heart and stroke ploblem.
Di minista yarn all dis one for Lagos during di joinbodi sidon wey dem call,"first annual black tie gala" wey Tristate Heart Foundation organaiz.
Dem organaiz dis joinbodi sidon to raise N500 million naira wey dem go fit take dey trit pipo wey get dis ploblems.
But talk true Oga minista,
You nor dey eat all dis wackis wey u talk say make all mehn stop to eat?

Monday, 5 December 2016

"SHUT UP YA MOUTH! KOREDE BELLO DON MAKE OVER N100 MILLION"..DIS NA WETIN DON JAZZY TELL ONE AMEBO BABE FOR INSTAGRAM WEY SAY KOREDE BELLO NA YEYE MUSICIAN



Some pipo own na to dey look for cheap populariti by fire,by force.
E nor tire you?
Don Jazzy don reply one babe on top Instagram wey say Korede Bello na di worst investment wey di Mavin Oga don sign.
Jazzy nor waste time to carpet her as he tell her to shut up her mouth and respet pipo wey dizav respet.
He say,Korede Bello wey she dey call worst investment don make over 100 million naira so make di babe show us her own worst investment wey don make dat kain money.
Di Mavin Oga also yarn say,nor be beans for Korede to get 1.9million followas for Instagram if he nor tight.
But Don Jazzy u for ask yor boy make he look di babe pishor weda na one of dose gehs wey he don break dia heart.
Dem nor dey know finish.
Worst investment ke!

Sunday, 4 December 2016

HALLELUYA! UGANDA PROSTITUTE DON SURRENDER PACKET OF CONDOMS FOR CHURCH AS SHE GIVE HER LIFE TO CHRIST



Dis babe ashaworism bin strong bifor o!
Omo!
See as condom full ground.
Dis Uganda babe Niisima Allen,repent afta she attend Robert Kayanja Ministries Crusade for Uganda.
Dis one show say,even tho u be badoo for bad bizness,e nor dey late for you to giv yor life to Christ.
For you to make heaven akordin to di biliv of kristians U must give yor life to Jesus and dat na exactli wetin dis babe don do.
So wetin you dey wait for?

Saturday, 3 December 2016

FORMA KENNIS MUSIC ARTISTE,JAYWON,DEY VEX AS HE SAY,INSTEAD OF KENNIS MUSIC TO DEY SHOOT VIDEO FORAM AS DIA ARTISTE,NAIM KON DEY PAY TO DO VIDEO FOR IMSEF


Forma Kennis miuzik artiste,Jaywon,don tell tori pipo say,as dem epp him karia,na so some kain tins wey Dem do toram make am vex.
Akordin to Jaywon,he say,can you imagine?
some of him vidios wey u dey watch for tv,naim use hin own money shoot dose vidio so diafor,make u nor tink say na Kennis miuzik do evritin foram.
Hey!
O boy!
Dis na beta sikrit o.

Friday, 2 December 2016

BAD MARKET FOR EDO STATE AS GOFMENT DON SACK 12 AUCHI POLYTHECNIC LECTURERS BICOS DEM NOR DEY USE EYE SEE GIRLS WAIST


Federa gofment don vex sack 12 lecturers for Auchi politeknic for Edo state and di reason na bicos dem too do.
Dem nor dey use eye see gehs waist.
Instead of dem to tish student,na to attack girls pant from left,right,senta naim dem sabi and na dis one make gofment giv dem sack letters.
Pesin wey announce dis sack for Kaduna na di exekutiv seketri of Nashona Board for teknika studies,Dr Masa'udu Adamu-Kazuare and he say di minista of education wey be Mallam Adamu Adamu, put stamp on top dis sack.
Dem also reduce di position and rank of 15 other lecturers wey dey guilty for dis mata.

Thursday, 1 December 2016

DiS BOY DEY ON FIRE AS ENGLAND FOOTBALL ASSOCIATION AND DiA FANS DON CHOOSE VICTOR MOSES OF CHELSEA AS Di PREMIER LEAGUE PLAYER OF Di MONTH OF NOVEMBA


Wen yor time don rish,you yorsef nor fit stop yorsef from shining.
Three years afta Chelsea always dey loan am to clubs like Liverpool,Stoke City,Westham, dia new coach Antonio Conte say no way!Moses must stay dis time around.
Victor Moses true true nor fall di coached hand as he don epp Chelsea win plenti match and dey top of di table.
Bifor u go say,sidon look na dog name,di football association of England and di fans don vote Victor Moses as di premier league playa of di month of Novemba.
Out of di ova 40,000 votes,Moses get 18,756 why Swansea Sidgurdsson carry second position wit 7,791,third position na Watford Nordin Arabat why anoda Victor,our own Victor Anichebe take nomba four position as di bobo sef  dey form.
Congratulabia Victor Moses from Ogakpatakpata.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...