MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday, 7 January 2017

ONE NAiJA BOBO DON YAB ONE TANZANIA BABE,MICHELLE, ON TOP TWITA SAY TANZANIA PIPO TONGUE DON WEAK AFTA Di BABE SAY,GHANA JOLLOF RICE SWEET PASS NAiJA JOLLOF




Wen dis Naija and Ghana jollof rice war go end?
Since dem born me naim I dey hear Ghana pipo and Naija pipo dey drag say na dia jollof swit pass.
Oda kontris don dey shook mouth for dis jollof war.
Di ansa wey one Tanzania babe get from one Naija bobo on top twita afta she say Ghana jollof swit pass Naija jollof,go shock you.
Di bobo just reply di babe say Tanzania pipo tongues don weak naim make to know swit food dey hard dem.

Friday, 6 January 2017

ABI NA JOKE? COMEDIAN SEYI LAW,DON YARN FOR STAGE SAY NA SINGA TiMi DAKOLO,NAiM INTRODUCE AM ENTA 'MMM'


All dis komedians don too yarn so tay we nor dey know wen dem dey yarn truth.
One of di spiritual Bank 'MMM' wey pipo put money and wey also don make pipo faint anyhow,don resiv one ogbonge konfeshon.
Top komedian Seyi Law don yarn say na West Africa Idol Winna Timi Dakolo naim pusham enta MMM.
He yarn dis one for comedy big name, Alli Baba new year day groove for inside Eko hotel.
Trap don katch many pipo money since dis spiritual bank announs say dem won take small break bifor dem go come back for January 14.
Out of June 12 and January 14,I nor kon know di one wey popular pass.
We go bring una more tori as e take konsign Timi Dakolo anytime wen he respond for di mata wey dey ground.

Thursday, 5 January 2017

GOVNOR ABIOLA AJIMOBI OF OYO STATE DON YARN SAY TO RULE Di STATE NOR BE BEANS,AS HE SAY Di STATE DEY GIVAM HEADACHE BICOS E TOO HARD TO RULE


Dis kain konfeshon fit make pesin loose election bicos pipo nor go get one single konfidens for you.
Oyo state Gofnor,Abiola Ajimobi don yarn say,to rule Oyo state nor be beans at all.
Make di bigness of Oyo state nor go givam high patenshon bicos akordin to di gofnor,he say only Oyo be like 7 states put togeda.
He yarn dis one for Oyo state 2017 inter-faith service for Ibadan.
Oga Gofnor,if Oyo too big for you,step down for me,i sabi rule welwell.
Ruling na MY calling.

Wednesday, 4 January 2017

CONGRATULABIA TO MICHAEL JACKSON JUNIOR SISTA,JANET,AS SHE DON FINALLY BORN HER FIRST PIKIN AT 50 YEARS AND NA BOUNCING BABY BOBO


Notin God nor fit do.
At 50 years,God don do am for Janet Jackson di junior sista to Michael Jackson as she don welkom her first pikin wit Arab hosband and billionaire Wissam Al Mana.
Akordin to her tori assistant,she born yestaday and evritin go siriri wereren,evritin go smooth as she dey born di bouncing baby bobo.

Tuesday, 3 January 2017

SEKEM DANCE FOUNDER,MC GALAXY,DON TELL TORi PIPO SAY,IF HIM NEW SONG 'YOUR LOVE' NOR BLOW,HE SAY HE GO PACK AND GO BACK TO VILLAGE


Sekem singa Mc Galaxy,don yarn tori pipo say if hin he nor blow wit hin new song for 2017,e go pack go back to village.
Di song,Your Love akordin to di bobo get evritin wey go change di industri.
Okay,we dey wait.
We go remind you if e nor blow but if you blow wit di song,we go join u thank God.

Monday, 2 January 2017

NICE ONE BABA: DON JAZZY DON DEY FIND 120 PIPO TO GIVE WORK FOR 2017,YOUR OWN NA JUST TO SEND YOUR CERTIFICATE TO QUALIFY YOU FOR ANY OF Di POSITION


Mr Don Jazzy,don dey give pipo opotuniti to work foram as he don reliz positions wey get vacancy for Mavin Records.
Positions like bizness executives,content developers,image experts and plenti oda jobs for 120 pipo.
Nice one don baba j.

Sunday, 1 January 2017

JUST LIKE BISHOP OYEDEPO WEY SAY NA GOD SAY MAKE HE INKRiZ SCHOOL FEES,OLAMIDE PRODUCER,YOUNG JOHN DON ALSO YARN SAY NA GOD NICKNAME AM 'WICKED PRODUCER'


Udomboso John Saviour a.k.a Young John di 'Wicked Producer', don yarn tori pipo say him nickname wicked producer come from God.
He say e nor get wen him sidon tink about di name or sidon write di name down.
He say di name just come on hin own and na so God take dey do him work.
Young John if u dey follow up,na him be one of Olamide main producer and naim produce all those wicked wicked Olamide songs like Bobo,Story for the gods and Kiss Daniel 'Mama'.
Di Akwa ibom state born producer say him also hope to work wit 2face and Wizkid one day.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...