Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Tuesday, 7 March 2017
FROM TOMOROW,IF ANY AIRLINE TELL YOU TO PAY MAKE YOU ENTA DIA PLANE GO ABUJA,MAKE U KNOW SAY NA 419 BICOS,GOVMENT DON CLOSE Di AIRPORT DOWN FOR SIX WEEKS
Gofment don finalli announce say from tomorow Wednesday 12 a.m,dem go close Abuja intanashona airport for six weeks make dem for fit do sirios mentaynance wey go benefit efribodi.
Dis one no be rumor or lie at all bicos,na Di minista for infomayshon,Lai Mohammed naim announce dis one for Abuja.
Di minista of transport,Rotimi Ameachi also yarn say,make we dey use di Kaduna airport for now until dem finish work for Abuja airport.
Monday, 6 March 2017
ZIMBABWE HIGH COURT DON STOP TEACHERS FROM FLOGGING SHIDREN FOR SCHOOL FOR DIA KONTRi
Afta one woman konplain about di injuri wey tisha giv her 6 year old pikin wey dey class one,Zimbabwe high court don ban tishas from flogging shidrens for dat kontri.
Linah Pfungwa say just bicos dem nor sign for di daughta book to confam say she don do her homework,naim make tisha bulala di pikin niali die.
Sunday, 5 March 2017
WONDAMENT! SPAIN GOVMENT DON APPOINT MINISTER OF KEREWA AFTA DEM FIND OUT SAY HUSBANDS AND WIVES NOR TOO GET TIME FOR DIA SEF AGAIN
| Edelmira |
Di Spanish gofment don krate new ministri and dis ministri na Ministri of Sex.
Why bicos,dem say dia population don dey rediuz evri year.
Hosband and wife nor dey gree born too much for yonda again.
Di exkiuz wey some of dem give be say,dem dey tire afta dem don spend plenti hours for work and late nite waka sef kon join.
Wen dem finalli rish house,dem go don tire and weak like dodo.
Na dis won kon make di gofment for Spain krate dis kerewa ministri.
Di minista of kerewa akordin to di Spain gofment na Edelmira Barreira.
Dis woman naim go do evritin posibo to make sure hosband and wife go carry kerewa for head and produce shidrenses.
Saturday, 4 March 2017
TONTO DIKEH HUSBAND FAMiLi PESiN DON TALK SAY,TONTO DON BOAST BIFOR SAY,SHE GO SPOIL HER HUSBAND NAME BICOS OF DiA QUARREL
Nor be news again say Tonto Dikeh and her hosband Churchill get kwanta for dia marage as di babe don pack comot from dia house for ova a month now.
Di rumors wey we hear be say,di bobo dey do touchingbodi bizness wit one of di girls wey dey work foram.
Since she remove from di marage,she don yarn many tins about di hosband.
She say most of di tins wey she bin take dey boast say Churchill buy foram,na lie she dey lie dat time.
She even yarn say Churchill giv her bedroom disease.
Now of one of Churchill famili pesin don defend him broda say,make anybodi nor take Tonto Dikeh yarning sirios bicos,she bin don boast say,she go show her hosband pepper since dem start dia kworel.
From di way wey tins dey go so,we go see more drama on top dis mata as Tonto Dikeh don say she go yarn more tins wey appun for dia marage.
Friday, 3 March 2017
LAGOS COURT DON FINALLY SKATA AND END EMEKA IKE MARRIAGE AFTER HIM WIFE TALK SAY SHE NOR WANT TO MARRY AGAIN
Lagos court don end Nollywood star,Emeka Ike marage to him wife Susanne Emma finally.
Di wife bin pack comot from dia house afta she say Emeka Ike take her dey do punching bag and di tin kon tire her.
She don carry di mata go court since and now court don finalli judge di mata.
Akordin to wetin di Lagos court talk,dem don say make Emeka be Di pesin wey go dey baff and take kia of di shidren but di woman get right to visit di shidren too.
Na wa o.
Wetin dey appun to Nigeria selibritis marage sef?
Thursday, 2 March 2017
MILLITANTS FOR NIGER DELTA DON GIVE SOUTH AFRICA COMPANIES 30 DAYS TO PACK COMOT FOR NAIJA BICOS DEM DEY FIGHT AND KILL NAIJA PIPO FOR DIA COUNTRY
Di xenophobia madness wey South Africa pipo carry for head go soon land dia konpinis for heavi wahala.
South Africa Boys dey kill kill oda Africa pipo for dia kontri gor years now and na diferen diferen excuse we dey hear dem dey give.
Now,militants don say dem give Dstv,Mtn,Shoprite 30 days to comot from Naija.
Nor be only Niger-Delta militants dey vex right now as National Assembly and National Association of Nigerian Students(NANS) don warn say South Africa konpinis naim go use head carry am if Dem nor stop di nonsense wey dem dey do for dia kontri.
Wednesday, 1 March 2017
FANI KAYODE SAY HIM GO EXPOSE Di NAMES OF PIPO WEY DEY BEHIND Di COLLAPSE OF TB JOSHUA CHURCH BUILDING WEY KILL OVER 120 PIPO FOR 2014
We don hear one ogbonge tori about one of di building of Pastor TB Joshua Synagogue Church of All Nations for Ikotun,Lagos wey kolaps and kill ova 125 pipo for 2014.
Di tori wey we gada be say,forma minister of Airport mata and PDP chief,Femi Fani-Kayode,don yarn say,him go soon xpose di pipo wey make dat building fall.
He say if u rememba for di video of how he take fall,you go see say,one eroplane dey fly around di building.
Fani-Kayode say dat plane nor be odnari plane as na pipo naim sendam.
He say na TB Joshua dem bin dey plan to kill.
Akordin toram he say,him still dey investigate di whole tori and wen he finish,he go yarn he mind.
So diafor make una kontiniu to visit ogakpatakpata to hear dat Fani-Kayode tori wen he dropam.
Subscribe to:
Posts (Atom)