MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday, 7 May 2017

AFTA ALL Di BEATING WEY CHRIS BROWN BEAT AM IN THOSE DAYS,RIHANNA DON STILL PHONE CHRIS BROWN AND TELL AM SAY,"I LOVE YOU" DURING Di GUY BIRTHDAY


Dis tin call love ehn,e be like juju.
If e don catch you,e don catch you be dat.
All di black eye wey Rihanna get wen she dey frend Chris Brown and upon say court settle di mata say make Chris stay away from her,e don clear say she neva fit remove di guy from her mind.
Chris Brown selibrate him birthday on Friday and akordin to pipo wey dey di birthday groove,di bobo resiv call from Rihanna to wisham hapi betday.
Dem also yarn say Chris Brown dey veri hapi as di babe call am.
Di last word wey come out from riri mouth wen she call na,'I love you' to show say she still dey kolo for Chris.
Chris selibrate him 28 years old birthday on May 5.
Na anoda new chapter dis pipo won use sense open so o,
We dey watch.

Saturday, 6 May 2017

NO BE BY FORCE TO TAKE CARE OF YOUR PAPA AND MAMA WEY BORN YOU ACCORDING TO GAYMAN,BISI ALIMI



Notin pesin no go hear for dis kpangolo world wey we dey.
Gay craze,Bisi Alimi,don yarn tori pipo say no be by force to take kia of di papa and mama wey bring you come dis world.
Wetin you dey expect from pesin wey fit yarn say him nor biliv in God.
Pesin wey choose not to love woman but to love him fellow man,wetin remain for dat kain pesin brain?
If I choose to helep my momsie and popsie,na my life Abeg craze enta one corner wit yor yarns.
Yeye dey smell.

Friday, 5 May 2017

MAN U COACH,JOSE MOURINHO,DON HAIL MARCUS RASHFORD AS PLAYER WEY DEY IN LOVE WIT FOOTBALL



Wen your coach kontiniu to sing your praises,make you know say,e get wetin you dey do right.
Jose Mourinho di coach of Manchester United,don praise him 19 years old playa as sombodi wey dey in love wit football afta di bobo score Di only goal wen dem play di first leg Europa league match wit Celta Vigo for inside Spain last nite.
Rashford bend one wicked free kick like Beckham enta di net for di 67 minute as dem give CeltaVigo one kondo.
Mourinho say make dem forget age for Rashford mata bicos di boy get mature heart to dey pepper difendas.
He say wen evribodi don dey go house afta dem train finish,Rashford go stil kontiniu to dey train.
Akordin to Mourinho he say,di boy dey work,work and work and na dis one make am say,Rashford dey in love wit football.

Thursday, 4 May 2017

FORMA ENUGU STATE GOVNOR SULLIVAN CHIME,DON YARN SAY,PDP DON DIE AND DEM DON BURN TO ASHES


Forma Enugu state gofnor Sullivan Chime,don yarn say him forma party PDP,don die and dem don burn to ashes.
Sullivan talk dis one wen he dey follow tori pipo yarn for Enugu.
Akordin to di forma Gofnor he say,di rizin why him enta APC na bicos,many pipo dey look up toram for direction and APC na di only party wey fit giv you good life.
He say him pray say wetin appun to PDP make he no appun to APC.
Politicians una well done.

Wednesday, 3 May 2017

NAIJA AND GHANA BORN ACTRESS YVONNE OKORO,DON TELL TORi PIPO SAY,WHY SHE NOR GET BOY FRIEND FOR TWO YEARS NOW NA BICOS GUYS DEY FEAR TO TELLAM ABOUT LOVE


Nollywood and Ghollywood actress Yvonne Okoro don yarn say di reason why she dey single for two years now na bicos guys dey fear to tell her about love.
She yarn dis one for one intaviu wen dem dey launch di Glam Magazin for Accra,Ghana.
She say di rizin why boys dey fear her be say,dem dey feel say she don alreadi get boyfriend.
Dis week as guys don know her sikrit,di toasting for dis babe go cause traffic.
Yvonne,which nomba I dey?
You go like my lyrics.

Tuesday, 2 May 2017

BREAKING NEWS!!! PROPHET TB JOSHUA DON YARN SAY HIM DON DEY MAKE ARRANGEMENT TO CARRY HIM SYNAGOGUE CHURCH GO ISRAEL SINCE DEM NO VALUE AM FOR NAIJA.


Prophet TB Joshua wey be di founda and owna of di Synagogue Church of All Nations for Ikotun,Lagos,don dey make sirios arrangement to take carry him Church to Israel veri soon.
He say na dia him papa from heaven come from.
Akordin to di prophet him say,dem no value am for Nigeria so diafor make he go were dem go valuam.
He say him Synagogue Church naim dem hate pass for di world and pipo wey hate am akordin to TB Joshua,naim own pipo,Africa pipo.
Di prophet also yarn say,him don yarn wit three big names for yonda..di mayor of Jerusalem,Tiberians and di Jordan Valley and dem don even promise to givam land to build him Church.
Hmm,we dey watch.

Monday, 1 May 2017

Di BIGGEST HEAVYWEIGHT BOXER FOR Di WORLD RIGHT NOW,ANTHONY OLUWAFEMI JOSHUA,Di NAIJA BOBO WEY DEY REPRESENT BRITAIN,SAY NA EBA AND EGUSI SOUP DEY GIVAM POWER


Bifor pipo go say,siddon look na dog name on Saturday nite,Naija born boxer,Anthony Joshua wey dey represent Great Britain for ring,don win Vladimir Klitchko as he knock am out to bikom di nomba one heavyweight boxing champion for di world.
Naija international jonalist Oma Akatugba,bin do one sharp sharp joinbodi intaviu wit Anthony Joshua as dem meet during di Laureus World Sports Awards for obodo oyibo.
Di big man tell Oma say,di sikrit of him success na di koret Pounded Yam,Eba and Egusi Soup wey him dey wack.
He yarn many tins about Naija for dis video wey I want make you watch.
Oya no dulling,klik and watch am for bottom hia...


LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...