MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday, 14 May 2017

COMEDIAN I GO DYE DON BUY VERY BIG BIUTIFU HOUSE FOR HIM MAMA AND NA ONLY FOR DREAM SOME OF US FIT SEE DAT KAIN FINE MANSION



Wen pipo bin dey say diaris heaven on earth,I dey tink say na joke.
Comedian I go dye don troway any doubt wey bin dey my head say heaven no dey dis earth.
Di kain big mansion wey I go dye build for him momsi no get part two.
Just to dey talk for stage naim dis guy take arrange dis kain bunk for him mileh,guy I dey enta street go talk for drum.
I just dey imagine di kain appiness wey go dey him mama mind now.
Mama banga rice dat year don dey enjoy di fruit of her labor.
I go dye you be man.
You don inspire crowd.

Saturday, 13 May 2017

NA OSHODI BRIDGE LAWYER 2FACE GET,DEM NO FIT DO ME ANYTING-BLACKFACE


Wen dis two Benue boys,Blackface and 2face fight go end sef?
Yestaday we bin yarn una say,2face lawyer,don write leta to Blackface say make he tell 2face sorry for all di tins wey him don yarn or else dem go carry am go court afta 7 days.
Blackface don reply 2baba say,na Oshodi undabridge lawyer him get bicos di man no sabi book naim make am dey write robish.
Di bobo say make dem do anytin dem like him no dey fear dem.
Di black one say on top say 2face tiff him miuzik,dem stil want make he say sorry,sorry for what?
Blackface say,apart from African Queen,2face also tiff 'Let somebody love you'.
2face na true?

Friday, 12 May 2017

2FACE LAWYER DON GIVE BLACKFACE 7 DAYS WARNING TO SAY SORRY TO 2FACE FOR ALL Di BAD TINGS WEY HIM DEY YARN ABOUT 2FACE OR DEM GO CARRY AM GO COURT


Di kpalava bitwin 2face and Blackface neva show sign of slowing down as 2face lawyer don serve Blackface warning paper say dem go carry am go court if he no tell 2face sorry for di bad bad tings wey him don dey yarn about am.
If you rememba,Blackface yarn some few weeks ago say 2face and him manager don tiff him song 'Let somebody love you' again  he tiff di first one 'Africa Queen'.
Di same song wey 2face take hama.
Now 2face camp don giv Blackface 7 days to say 'sorry' or else,two of dem go enta di same shokoto for court.
Dis ting don dey pass be kiafu o.
Una start as frends so make una try settle unasef bicos,2pac and Biggie famili still dey miss dem till today.
We nor won hia tori.

Thursday, 11 May 2017

BAYELSA STATE PRIMARY SCHOOL TEACHERS DON STRIKE BICOS DIA GOVMENT DEY OWE DEM 9 MONTHS SALARY


Bayelsa state primary school tishas don down tools say dem no dey tish again until di gofment for dat state pay dem dia 9 months salary wey dem dey owe dem.
I pity for dis kontri.
Bayelsa na only 8 local govment dem get and some states get over 20 local govment but dem nor owe dia tishas salary.
Dem dey kolet ova 9 billion naira for Federa Gofment hand evri month but dem nor fit pay tishas salari.
Meanwhy tishas from states like Anambra,Ogun wey dey resiv below 9 billion evri month nor dey konplain.
Dis kontri na real one chance.

Wednesday, 10 May 2017

DAVID ADELEKE A.K.A DAVIDO,DON BLESS ANODA DAVID ADELEKE FOR TWITA HIM NAMESAKE AFTA Di BOBO COMPLAIN OF MONEY TO ATTEND ONE JOINBODi MEETING FOR YANKEE



Davido don tell one bobowey be him namesake for twita make he sendam message make he arrange somtin foram base on say di bobo dey beg.
Di boy,David Adeleke wey also dey bear di same name wit Davido,need di money to take go Yankee for one joinbodi workshop for Yale univasiti.
As Davido siam,naim he telam say no shakement I go plasta,aftaraw u be my namesake.

Tuesday, 9 May 2017

NICKI MINAJ DON PROMISE TO PAY Di SCHOOL FEES OF SOME OF HER FANS WEY DEY UNiVASiTi


No be bad idea at all wen u give back to di Pipo wey dey support your karia.
Nicki Minaj bin dey do konpetishon on top twita wit her fans and Di plan Na to reward dem.
One fan kon tell Nicki say,she go prefa make she pay her school fees.
Nicki agree as she also agree to pay Di school fees for many oda fans too.
Nice one Nicki.
Life nor be only to dey naked and show us your yansh on top Instagram and twita.

Monday, 8 May 2017

YEMI OSINBAJO DON TURN TO PRESIDENT AGAIN AFTA BUHARI HAND OVA POWER TORAM BICOS HE TRAVEL GO LONDON FOR ANODA TRITMENT


Wen we dey play monkey post dat year for area,dem go say,two corners make one penariti.
If to say di nomba of times wey Yemi Osinbajo don be president anytime wey Buhari go for tritment dey count like di penariti ting,o boy di vice presido for don be di real president once and for all espeshali now wey Buhari don travel again to trit di sickness wey dey him bodi.
Rememba say president Buhari come back from London for March afta he spend two months go trit imsef for dia.
Yestaday Oga Buhari don travel again but dis time around nobodi no wen he go come back.
Well,I pray say bifor he go come back,make my frends wey dey stay Abuja no go sell dis kontri troway take buy kpof kpof share give hungri pipo.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...