Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Tuesday, 6 June 2017
GOVNOR NYESOM WIKE OF RIVERS,DON RUN GO COURT TO STOP POLICE TO SEARCH HIM HOUSE FOR ABUJA AND OTHER PLACES
Na wah o!
Wen all dis kain tori go dress comot for dis Gofnor Wike head sef?
Today naim and Rotimi Ameachi,tomorow naim and police,next tomorow naim and Benue state govnor.
Today tori wey we gada be say,Gofnor Nyesom Wike,don carry EFCC,State Sikioriti Service,SSS and inspector general of police,(IGP) Ibrahim Idris,go court so dat dem go allowram drink water put cup for ground.
He dey pray right now thru him lawyer make court stop all dis pipo from searching him house for Abuja and oda places.
Gofnor Abeg pity for dem,allow dem to search if na dia work dem kon do.
If u nor get skeleton for cupboard no need to shake.
Monday, 5 June 2017
KENYA SHAKARA BABE,HUDDAH MONROE,DON YAB NAIJA MEN SAY,WE BE BABA FOR ENJOYMENT BUT WE NO GOOD FOR MARRIAGE
Chai!
Naija men,Una don suffer.
Kenya shakara babe Huddah Monroe,don finish una for ground as she say,Naija men nor good for marriage but dem be ogakpatakpata of enjoyment.
Huddah yarn dis one on top Instagram wen one of her Naija fan beg her make she try marry Naija bobo so dat she go dey enjoy koret Naija jollof rice and moin moin.
Her reply to her fan don soprise many pipo as she say,she don follow many Naija men and dem sabi flex to pieces but she nor trust dem for marriage.
My queshon be say,she don marry Naija bobo bifor?
Her reply don make some Naija men dey grumble alreadi.
Sunday, 4 June 2017
AFRO FUJI SINGA DAMMY KRANE,FIT GET UP TO 40 YEARS FOR AMERICA PRISON ACCORDING TO Di TORi WEY WE GADA AFTA DEM ARREST AM BICOS OF 419
I won enta private jet,I won show my pictures for Instagram,I want make pipo See say pepper rest,I want make di girls dem dey craze for my mata.
All dis one naim put Afro Fuji singa,Dammy Krane for wahala so.
Yestaday we bring una tori of how he take do gibiti and wayo for America as he use anoda pesin credit card take book private jet.
Afta dem arrest di guy,Di owners of di private jet company,Tapjets,don talk say,Dammy Krane get case to ansa for court.
For di level of crime wey he komit,di informate wey we gada be say,Dammy fit spend up to 40 years for prison afta court judgement if he nor get luck.
I pity for him mama and di pains wey she dey pass thru right now.
Saturday, 3 June 2017
NICKI MINAJ DON SHOW WIZKID LOVE FOR INSTAGRAM
I nor know weda e get any man wey go see Nicki Minaj wicked shape and figure 8 wey no go trip.
Di guys wey dey line up to enta Nicki Minaj heart if space dey,go reach like 50 million.
One of such pipo wey dey trip for di sexy Nicki,either for her fineness or for her talent,na Wizkid.
Nor be today Wizzy don dey shout and like di babe pishors on top Instagram.
And now Nicki Minaj hersef don press di like button on top Wizkid foto.
For botom of dis pishor,Wizkid write say, "Ghetto yuth on top" and Nicki no waste time to press like to show soport to di young Africa legend.
1,1, na draw.
Like me,i like you God no go vex.
YAWA DON GAS AS DEM DON ARREST AFRO FUJI SINGA,DAMMY KRANE FOR MIAMI,AMERICA BICOS OF WAYO AND 419 WEY HIM DO FOR DiA
Akordin to di tori,na 7 point somtin million he don use for Di pesin credit card alreadi.
I still dey shake my head dey pity dis bobo for di kain yawa wey him put imsef.
Except say na magic he go do to free imsef from dis chukuchuku.
I still dey shake my head dey pity dis bobo for di kain yawa wey him put imsef.
Except say na magic he go do to free imsef from dis chukuchuku.
Friday, 2 June 2017
FEDERA GOFMENT DON BAN SELLING OF CIGARETTE TO PIPO WEY DEY BELOW 18 YEARS
Federa gofment don look up,look down and say,No more selling of Cigar to anybodi wey neva reach 18 years again,if both di seller and buyer nor won enta wahala.
Di minista for kankpe bodi mata,Professor Isaac Adewole naim yarn dis one for Abuja to mark di 'World No Tobacco Day'.
He say di tin still dey pain am afta World Health Organization,WHO yarn say ova 4.5 million Naija mature pipo naim dey smoke.
Di minista also yarn say he want make make dem quick quick put dis law wey go make dem punish anybodi wey brake dis law.
Thursday, 1 June 2017
ONE MAN FOR CALABAR KOKO DAN,DON BUILD 3 BEDROOM FLAT FOR HIM POOR NEIGHBOURS (HUSBAND AND WIFE) WEY DON STAY MUD HOUSE FOR 30 YEARS WITHOUT PIKIN
If to say God dey ask pipo to pick one pesin joinbodi wey you want make he make heaven wit you,one time I go choose dis Koko Dan for Calabar wey replace di red mud house wit biutifu 3 bedroom flat of him poor hosband and wife neighbours.
Dis two pipo,Mr Ebugwe Obu and Mrs Agnes Obu akordin to tori wey we gada,don dey stay di mud house for 30 years and dem neva born pikin.
If 1000 pipo like Koko Dan dey dis kontri,America for dey learn greatness for wia Naija dey.
Subscribe to:
Posts (Atom)
