MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday, 14 June 2017

ROTIMI AMEACHI Di MINISTA OF TRANSPORT DON YARN TORi PIPO SAY,GOODLUCK JONATHAN NO DO ANYTHING FOR IBO PIPO UPON SAY DEM VOTE FORAM FOR 2015 ELECTION


Transport minista and forma Rivers state gofnor,Rotimi Ameachi,don kontiniu di yabis against forma presido,Goodluck Jonathan as he yarn say,di man no do anytin for Ibo pipo.
He say for 2011,Ibo pipo use all dia life vote for uncle Jona but yet,di man nor gree do wetin he promise dem like di 2nd Niger bridge.

Tuesday, 13 June 2017

CHURCH MUSIC SINGA,ATORISE DON YARN SAY,HE BEG HIM WIFE AND SHE DON FORGIVE AM FOR Di PIKIN WEY ANODA WOMAN BORN FORAM OUTSIDE DIA MARRIAGE


Popular gospel miuzishan,Lanre Teriba a.k.a Atorise don yarn tori pipo say,him wife don look up,look down and forgivam for di away match wey him go play wit anoda woman.
For dat away match,di woman get belle and she born pikin for Atorise and akordin to di popular miuzishan,him wife don forgivam for dis chukuchuku wey him do outside dia marage.
Atorise say,as far as pipo wey dey close toram don undastand and as far as him wife don forgivam,him nor care about pipo wey dey call am ashawo man.
He say most pipo wey dey do worse tins for backyard sef,join dey call am bad names and di tin dey wondaram why pipo nor fit just forget wetin don appun for bifor bifor.

Monday, 12 June 2017

FOR SAUDI ARABIA,15 YEARS FOR PRISON DEY WAIT FOR YOU IF DEM CATCH YOU WEAR BARCELONA JERSEY FOR DAT COUNTRY


Two kontris Saudi Arabia and Qatar nor dey agree at all as di two kontris get sirios quarel.
Now di Saudi gofment don put law say,u go pay fine of £135,000 wey be ova N67 million naira  if dem catch u wear Barcelona jersey bicos na Qatar Airways dey sponsor di jersey.
Nor be only dat one o,if you wear any Barcelona jersey wey carry di Qatar Airways logo,dem fit put you for prison for 15 years.
Fly wey no hear word naim dey follow dead bodi enta grave o.
For those of una wey won travel go Saudi Arabia and you get plan to wear Barcelona jersey,try buy cotton bud and use am klin ya ear.

Sunday, 11 June 2017

PLENTY RESPECT TO DAVIDO AS HE DON BEGIN TO BUILD HOUSE FOR Di SMALL BOY WEY SING HIM NEW SONG SOME WEEKS AGO

Davido don win evri part of my soul, 30 billion times for di good tin wey him do for di smallie wey use play play sing him song.
Some weeks ago,davido put Di boy for school and promise to take kia of am foreva.
Now Davido don soprise even my sleeping spirit as he don skata Di boy mama mud house and bigin to build block house for dem.
Di Kain record wey Davido dey sef wit miuzik and outside miuzik,no get part two.
We as a pipo espeshali Di wicked rich pipo,must learn from dis Davido kindness.

Saturday, 10 June 2017

FOR CAMEROON,LANDLORD DON USE FORCE CARRY TENANT POT OF CHICKEN SOUP BICOS HE NEVA PAY HIM RENT FOR 6 MONTHS


Tenant,landlord wahala no dey eva get ending.
Di latest news wey enta our tori room be say,one landlord for Cameroon don seize him tenant pot of chicken soup sake of say,he dey owe six months rent.
Dis one appun for Doula,Cameroon.
Di landlord wey don tire to ask for him money,carry him tenant pot of chicken soup.
Oda tenants joinbodi to beg di landlord make he givam di pot of soup back but di landlord nor gree.
Akordin to di landlord,he say wetin make am dey para be say,him tenant get money to cook correct pot of chicken soup but he nor get money to pay house rent.
He say anytime wen he ask of him rent,Na so di man go dey make mouth say,di law go hollam if he try to drive am from di house if he no givam two months quit notice,
Na wa o.
Landlord and tenant drama nor be small tin o.

Thursday, 8 June 2017

AKWA IBOM STATE GOVMENT DON GIVE 31 DAYS WARNING TO TRADERS TO REDUCE Di PRICE OF GARRI,TOMATOES,VEGETABLES AND OTHER FOODSTUFFS OR ELSE DEM GO ENTA GOVMENT WAHALA


Dollars inkriz price of foodstuff go up,dollar rate come down,foodstuff dey inkriz more more.
Akordin to tori wey we gada,Akwa Ibom Own worse as unions dey kill dem for yonda.
For example,garri union for Akwa Ibom state put law say,if you nor pay N500,000 you no fit carry garri enta di state to sell and dis one kon make price of garri and oda tins go up.
Now di state gofment don open chapta reach dem and give di union 31 days warning to use dia church mind or gofment go show Dem pepper.
Di special assistant on traders mata to Govnor Udom Emmanuel,Idorenyin Raphael,naim yarn dis one on top di radio program 'Superior Performance '.
Idorenyin yarn say,for Akwaibom right now,bag of garri dey sell bitwin N22,000 and N30,000 but for outside Akwa Ibom bag of garri dey sell for 17k and N18k.
He say if u no dey dia union and u carry bags of garri come market,dem go seize am.
He say bicos of dis madness,crayfish sef don cost.
Aba pipo dey come Akwa Ibom to buy crayfish and dem dey sellam cheap pass pipo wey dey sell for Akwa Ibom bicos of union kpalava.

Wednesday, 7 June 2017

SOME JOINBODI GROUP WEY INCLUDE AREWA YOUTH FORUM FOR NORTH,DON GIVE IGBO PIPO 3 MONTHS TO PACK COMOT FOR DIA AREA AND MAKE DIA OWN PIPO COMOT FROM EAST TOO


Wich kain wahala dis Arewa joinbodi group AYCF won start for dis kontri so?
On Tuesday,some joinbodi group wey also include di Arewa youth forum,give igbo pipo three months to pack comot for north if not,kasala burst.
Dem also tell dia Own pipo make dem pack comot for east and come back to dia land.
Di national president of dis AYCF group Yerima Shettima naim yarn dis one for kaduna yestaday.
Na small small e take dey start.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...