MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday, 7 July 2017

SAD NEWS AS SUPER EAGLES NUMBER ONE GOALKEEPER,CARL IKEME,DON GET ONE BIG SICKNESS "LEUKEMIA" WEY FIT STOPAM FROM PLAYING FOOTBALL AGAIN




Dis one na veri sad news as Super Eagles nomba one goalkeeper Carl Ikeme akordin to him club don get one wicked sickness "Leukemia" for him bodi afta dem do test foram.
Leukemia na one useless sickness wey dey affect di white blood cells for bodi and Na dis cells sopose to dey help dey fight against disease.
Him club Wolves na dem bring dis news out yestaday and di ting pain dem welwell as dem say dem go stand gidigba for Carl back for dis tough piriod for him life.
Except God do him miracle as usual if not,Dis sickness fit make am no play ball again.
As you dey read dis tori,Abeg pray to God to heal am.
Notin dey inposibo for God to do.

Thursday, 6 July 2017

"YOU GET FROG VOICE",DAT NA WETIN WIZKID DON TELL DAVIDO AS DIA FIGHT OF WHO TOO MUCH PASS NO LOOK LIKE WETIN GO STOP SOON


Davido and Wizkid don use intanet take do playground as na so so insult dem dey insult demsef now.
If u rememba, Wizzy tell Davido say him na local champion bicos he try bizness for Yankee and e no favoram.
Davido now kon use tru Olamide jam wey dem joinbodi do take ansa Wizkid say "Wit Yankee passport dem say we local,you beta catch up I go see u later".
Wizkid do hear wetin Davido yarn for di song and he don attack am back.
Akordin to Wizzy he say,"Make pipo rememba say Yankee passport no be baba blue bicos he no dey cure frog voice".
E clear say Wizkid don blast Davido back say he get frog voice.
Trust Davido,di bobo go don dey tink Wetin he go yab hin forma frend wit.
Wen dis dia fight go stop sef?

Wednesday, 5 July 2017

LILLE FOOTBALL CLUB,DON SACK FORMA SUPER EAGLES CAPTAIN AND GOALKEEPER VINCENT ENYEAMA AND 10 OTHER PLAYERS AND NA THRU TEXT MESSAGE DEM TAKE LET DEM KNOW


Lille football club for France,don sack Vincent Enyeama and 10 oda players afta dem send dem text message just to let dem now.
Dis one mean say,dem no want dem again for di club for dis new season wey dey come so.
Di new coach,Marcelo Bielsa naim sack dem.
Enyeama just sign new kontrat wey sopose kipam for di club till 2019.
Just last month hia,Enyeama welkom Koffi from Burkina Faso,di new goalkeeper wey Lille just sign.

Tuesday, 4 July 2017

SINGA,'RUNTOWN' DON YARN SAY NA BIG LIE IF ANYBODi TELL YOU SAY NAIM SELL DAT SONG WEY DEM DEY CALL 'AYE' TO DAVIDO


Mad over you singa,Runtown,don deny say naim sell dat Aye song to Davido.
Rumors don dey fly for evriwia say he sell di song make Davido for joinbodi witam sing Galardo some years ago but di bobo say Notin like dat appun.
He say he nor dey sell miuzik,hin own na just to write him song.
He say if na true say he sell dat song give Davido,wot of di oda ogbonge songs wey Davido don sing?

Monday, 3 July 2017

DOYIN OKUPE,FORMA SINIOR ADVISER TO GOODLUCK JONATHAN,DON COMOT FOR PDP AS HE SAY PDP NO GET DAT KAIN SWAGA WEY FIT MAKE DEM STAND GIDIGBA AGAIN


Forma sinior advisa to Goodluck Jonathan,Doyin Okupe,don resign from PDP wit imidiate effect.
He say PDP no dey united again as dem don cast.
Akordin to Okupe,he yarn tori pipo say him no fit kontiniu wit PDP again bicos dia mata don tire ram and di reason why he nor write letter be say,since PDP nor dey united again,him no know who him go address di letter to.

Sunday, 2 July 2017

COMEDIAN,'LEPACIOUS BOSE' DON TELL TORi PIPO SAY,WEN SHE FAT SHE DEY MAKE BETA MONEY FOR COMEDY BUT NOW WEY SHE DON SLIM DOWN,Di BIZNESS GET AS E BE


One of Naija top female komedian,Lepacious Bose,don yarn tori pipo say,wen she be orobo she bin dey make money wen she dey stage dey make pipo laff but now wey she don slim down,bizness don be as e get.
She say dat time wen she fat,e easy foram to dey crack joke about her fat bodi but now,di mata don tie wrapa.
Lepacious na simple sontin.
Make sure ya jokes funny weda na about fat pipo or slim pipo and pipo go still take u sirios.

Saturday, 1 July 2017

SINGA WAJE,WEY BLOW AFTA SHE SING 'DO ME i DO YOU' WITH PSQUARE,DON TALK SAY,BIFOR SHE TURN MUSICIAN,SHE BE CHIN CHIN SELLER


Dreams dey come true Na so dem talk am.
Bifor Waje turn one of Di big miuzishan for Naija,she be chin chin seller.
She say she and her frend Ijeoma bin dey make chin chin dey sell for court yard for Onitsha dat year.
She yarn tori pipo say,dem dey sell small can like N600 dat time bifor God kon later change her stori.
Akordin to Waje,she say di first money wey dem pay her for miuzik na 500 hundred and di first big money wey she resiv na 300,000 tazan and di money niali make her run mad bicos she no biliv her eyes.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...