MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday, 7 November 2017

PHILADELPHIA COURT FOR AMERICA DON SENTENCE NICKI MINAJ FORMA BOYFRIEND MEEK MILL TO PRISON FOR 2 TO 4 YEARS AFTA HE REFUSE TO GIVE WAHALA CHANCE



Oga lawyer and judge Genece Brinkley for Philadelphia court for Yankee, don give Nicki Minaj forma boy frend Meek Mill 2 to 4 years to stay prison afta di bobo fail to respect imsef since 2009 wey dem dey watcham weda he go change.
Afta dem free am for di gun and drug gbege wey him enta,Brinkley say him don dey watcham but he refiuz to get sense so diafor, make he o relax for prison so dat him brain go re-arrange imsef.

Monday, 6 November 2017

DAMMY KRANE DON YAB TEKNO MAKE HE STOP TO DEY 'BORROW POSE' WIT PIPO MOTOR AND TAKE PICTURE WITAM KON DEY CLAIM SAY NAIM BUY Di MOTOR DEM


Dammy Krane,di bobo wey just free from di ploblem wit America konpini afta dem say him do wayo for di payment of private jet wey him hire,don give Tekno ogbonge yabis again.
He say,Tekno dey do borrow pose wit pipo cars and him go dey claim say naim buy dem.
Dis two pipo just dey yab demsef anyhow for some weeks now.
Na only God know wetin dem dey drag.

Sunday, 5 November 2017

ZAMBIA GOVMENT DON GIVE 48 HOURS QUIT NOTICE TO OMEGA FIRE MINISTRIES TO COMOT FOR DiA COUNTRY BICOS DEM NO WANT MAKE Di FIGHT BITWIN MEMBAS TO TURN SOMETHING ELSE


Zambia gofment don tell Augustine Oso Ebosele di pastor of di Nigeria church, Omega Fire Ministries for dia say, dem giam 24 hours to carry di church comot for dia kontri.
Di reason be say,dem no want make di oga oga fight among di church membas turn to somtin else. 
Di rent of di church Don expire but Kampamba Mulenga wey yarn on behalf of di Zambia gofment  say, dem no go allow dem pay again. 
Akordin to dem, dem say dem no want wahala.
Di owna of Omega Fire Ministries wey dia headquata dey Auchi for Nigeria na,Apostle Johnson Suleiman. 

Saturday, 4 November 2017

ONE BIG FAN OF REEKADO BANKS DON BUY TEAR RUBBER N16 MILLION NAIRA C300 BENZ DASHAM


Anything wey u dey do for dis life just try do am well bicos you no know who dey trip for ya job. One biggelest fan of Don Jazzy boy Reekado Banks don shook hand for pocket remove N16 million take buy car dash di bobo.
Di car name Benz C300 and na tear rubber.
No be small tin.
I hope say di guy dey rememba to do good for him own famili pipo sha.

Friday, 3 November 2017

Di FRENDSHIP BITWIN DON JAZZY, IYANYA AND MAVIN RECORDS DON DEY GET K-LEG AS NONE OF DEM JOIN IYANYA SELIBRATE HIM BIRTHDAY


Frends today, enimis tomorow.
Dat na how I see dis mata.
One year afta Iyanya waka live 'Made Men Miuzik' go join Don Jazzy for Mavin Records, e be like say dia frendship don turn k-leg.
Iyanya selibrate him 31 years birthday for October 30 for Crust and Cream, Victoria Island, Lagos but Don Jazzy and oda mavin membas no show face.
If evritin dey fine you no need anybody to tell you say, di birthday groove for dey loud espeshali if Don Jazzy dey involve.
Akordin to pipo wey dey close to dem, dem yarn say, somtin dey wrong wey dem neva tell us.

Thursday, 2 November 2017

BIGGEST WOMAN SUPASTAR FOR WORLD MUSIC 'BEYONCE', DON JOINBODi WIT WIZKID FOR HER NEW SONG 'YONCE RIDDIM' WEY GO SOON COME OUT



Wizkid don confam him levels tire as intanshona miuzishan.
Few days afta Boxing Champion Anthony Joshua use Wizkid song take enta ring fight Takam, we don diskova say, Beyonce don ink Wizkid name for her new album  wey go come out veri soon.
Di name of di song wey Beyonce joinbodi do wit Wizkid na,Yonce Riddim.
Oda pipo wey Beyonce put for di album na Nicki Minaj, Rihanna and her hosband Jay Z.
Starboy Wizkid you don try.

Wednesday, 1 November 2017

GUY MAN AND FILM ACTOR JIM IYKE, DON TALK SAY PROPHET TB JOSHUA PLAY AM WAYO AND DO FAKE DELIVERANCE WEN HE CARRY HIM SICK MAMA GO HIM CHURCH


Jim Iyke di nollywood actor, don call TB Joshua fake pastor afta he carry him sick mama go him church for Ikotun.
Akordin to Jim Ikye he say when he mama dey sick,dem carry her go TB Joshua church, Synagogue.
He say upon say him mama come synagogue for dilivrance, di mama still die.
Jim Iyke say wetin pain am pass na wen one of Tb Joshua wise men touch am, he bodi system just change.
For five minutes he nor get imsef.
Dis one weak me o.
Make we sidon dey look weda Tb Joshua go ansaram.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...