Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Thursday, 7 December 2017
NOLLYWOOD STAR 'MERCY AIGBE' FORMA HUSBAND 'LANRE GENTRY' DON TALK SAY MARRYING OF BAD WIFE DEY KILL PESiN QUICK PASS POVERTY
Lanre Gentry,di forma hosband to nollywood big name Mercy Aigbe don talk say,poverty na bad ting but bad wife worse pass poverty.
Akordin to Lanre,bad wife dey kill fast pass poverty.
Dis one dey clear finish.
E dey veri clear say na Mercy Aigbe dis man dey talk to afta two of dem break up as hosband and wife some months ago.
Wednesday, 6 December 2017
NO BE SMALL INSULT AND YABiS GOVNOR ROCHAS OKOROCHA DON RECEiVE FROM LEFT,RIGHT AND SENTA AFTA HE MAKE HIM BLOOD SISTER KOMISHONA OF HAPPINESS FOR IMO STATE
Notin we no go hear for naija espeshali funny funny stori from Imo state gofnor Rochas Okorocha.
For some time now,di man don dey behave zabuzabu as he build statu of south Africa, Ghana and Liberia presidents for Imo state.
Akordin to di tori wey enta town dem say,each of di statu cost N500 million to do and mean why, alarm dey tia pipo for di state.
No work,no industri, no food.
Now since yestaday,Rochas don resiv over one billion insults and yabis from pipo.
Even Uncle Jona padi dat year Ren Omokri yarn say,Rochas na nonsense and yeye pesin afta he make him sista Mrs Ogechi Ololo 'Komishona of Happiness' for Imo state.
Dis na di first time wey dis kain tin don appun for dis world.
Dis one weak me pass dodo.
If dis one no weak you naim be say notin fit weak you for dis world again.
Tuesday, 5 December 2017
COMEDIAN 'I GO DIE' DON YAB ATIKU WEY DEY TRY TO BE PRESIDENT FOR 2019 SAY HE DEY AMONG PIPO WEY GIVE NIGERIA BAD NAME SO DiAFOR,MAKE PIPO NO VOTE FORAM
Big name komedian 'I go dye' don finish Atiku Abubakar for ground say him dey among di pipo wey spoil Nigeria for ground.
I go dye yarn all dis ones on top twita say make Atiku go sidon one corner wit him plans to be president of Naija for 2019.
He also yarn say make he allow youths rule Nigeria bicos nothing remain wey he won tell us afta he be Gofnor of Adamawa and also spend 8 years as vice presido of Naija.
Monday, 4 December 2017
UTI,Di BIG BROTHER AFRICA WINNER DON TALK SAY,HIM NO GET TIME TO WASTE FOR NOLLYWOOD AGAIN BICOS Di MONEY WEY DEM DEY PAY WEN HE ACT FILM TOO DEY SMALL
Nwachukwu Uti don tell tori pipo say him no get time for nollywood film too much again bicos di money wey dem dey pay no risham to take dey do anything.
Akordin to Uti he say him no fit form die wen he be say na money he find go Lagos.
He say bifor him go show face for any film now di film must make brain.
Di bobo also yarn say na to dey MC groove and do show for teli dey givam beta money no be nollywood.
Sunday, 3 December 2017
ATIKU DON TALK SAY,AMERICA BAN BUHARI FOR 15 YEARS MAKE HE NO ENTA DiA COUNTRY BICOS HE DEY SUPPORT SHARIA BUT FEMI ADESHINA,BUHARI TORi MAN SAY,NA LIE
To bikom president you must turn your friend to your enimi.
As Atiku Abubakar don dey eye President Buhari position for 2019,he don dey sing for us.
He don clear tori man Dele Momodu say,America ban Buhari make he no enta dia kontri bicos say he dey support sharia law.
Dat yarns no go down well wit Buhari and him pipo as him tori man Femi Adeshina don yarn say,na big lie Atiku dey lie.
Politishans we hail una.
Saturday, 2 December 2017
79 YEAR OLD BILL OXLEY DON CONFESS FROM HIM SICK BED SAY,NAiM KILL BOB MARLEY AND NA AMERICA SENDAM GO CHOOK MARLEY WIT NAIL WEY DEM PUT CANCER POISON
Bill Oxley wey get just few weeks to live,don konfess for him sick bed for Mercy Hospital, Maine say naim give Bob Marley Converse Canvass wey dem hide nail wey dem poison.
And as Marley shook leg for di canvass,di nail just shook him leg and from dia,di cancer poison pass dia enta him bodi.
Akordin to Bill Oxley na Central Intelligence Agency CIA na dem sendam.
He say America use am kill 17 pipo and out of all of dem Bob Marley own naim pain am pass.
He say America feel say Bob Marley dey spoil market for dem wit him miuzik naim make dem take him life.
Bob Marletvlater die from cancer May 11,1981.
Friday, 1 December 2017
TODAY NA WORLD AIDS DAY,WE DEY BEG EVRiBODi MAKE WE TRY DEY KIAFU BICOS AIDS NO BE MALARIA,AIDS NA Di MOST WICKED SICKNESS FOR Di WORLD
As today na WORLD AIDS DAY, we for Ogakpatakpata dey beg all our readers and evribodi for di world make dem dey kiafu bicos dis sickness neva stil get cure.
To avoid AIDS,you need to face only ya wife,only ya hosband,only one boyfriend,only one gehfriend.
Kpatakpata if konji hold you,bad as e bad,use condom or no do at all.
Na stoborn fly dey follow dead bodi enta grave.
God bless you.
Una good morning.
Subscribe to:
Posts (Atom)



