MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday, 7 March 2018

AFTA DEM KILL 73 PIPO FOR BENUE STATE SOME MONTHS AGO,FULANI HERDSMEN DON KILL ANODA 24 FOR Di SAME BENUE AGAIN


I neva still undastand di reason why human bin go kill anoda human bin like am.
Did Fulani herdsmen own don too much o.
Do nomba of pipo wey dis malu boys don't kill for naija in two years go don't pass 5,000 and yet givment kwayet.
Afta dem kill 73 pipo for Benue state some moths ago,dis same malu boys don kill anoda 24 again for di same Benue for no reason.
Mean why,Federa Gofment just fold hand dey look.
Why Nnamdi Kanu no go talk say dem want dia own kontri wen some pipo go just wake up dey kill pipo like fly.
Nigeria na our own and gofment must protect human lifes.

Tuesday, 6 March 2018

SENATORS DINO MELAYE DON YAN SAY,HIM DEY SHAME FOR Di WAY WEY WE DEY CELEBRATE OUR INDEPENDENCE DAY AFTA HE WATCH Di WAY GHANA OWN DEY VERY SWEET TODAY


Senator Dino Melaye don yab Naija independence selibrashon afta he watch di way wey Ghana pipo dey selibrate dia own.
He say di kolor,style and serenren wey Ghana Own carry,make our own look like pikin play.
Ghana dey selibrate dia Independence Day today and pipo like Dino Melaye,President Buhari and many other politishans dey di ground for Accra.

Monday, 5 March 2018

ONE MODEL 'QUINBEEE DEBBIE' DON YAB TEKNO AFTA TEKNO REJECT HER NOT TO DEY INSIDE HIM VIDEO BICOS SHE BLACK WELWELL




Quinbeee Debbie, one black model,don pour out yabis give Tekno afta she say Tekno no allow her play di part wey di video director want make she play for him miuzik video.
She say Tekno reject her bicos she black welwell.
Akordin to her she say,Tekno want make she dey back for di video later dem go use anoda babe wey her face go show for di front take do di video.
Quinbeee say di insult too much as she waka comot for di video.
She kon advice pipo for twita make dem dey proud of dia dark skin,make dem no allow anybodi take dia kolor do robish.

Sunday, 4 March 2018

YESTADAY,ATIKU ENTA SILVERBIRD CINEMA GO WATCH Di NUMBER ONE FILM FOR Di WORLD RIGHT NOW 'BLACK PANTHER' AND HE PAY FOR EVERYBODi WEY COME WATCH Di FILM



Atiku Abubakar di politishan wey dey try porshu Buhari from Aso Rock for 2019enta Silverbird sinima yestaday for Abuja go watch di omba one film right now 'Black Panther'.
Di tori wey we gada be say,Atiku pay for evribodi wey come watch di film wen he rish dia.
Some pipo say na skamin.
Dem say why he dey do all dis one na bicos of 2019 election why some say na lie,Atiku na good pesin for a very long time.
My one be say,hope say him buy popcorn join for dem to just komplit di good since no be bicos of election make am pay for dem.

Saturday, 3 March 2018

MANY MUSIC RECORD COMPANIES FOR NAIJA,NA YAHOO YAHOO BOYS GET DEM ACCORDING TO Di KOKO MASTER IMSEF, D'BANJ



Di chairman of koko garri worldwide, D'banj,don yan tori pipo say,most of dis record konpinis wey u dey hear of for naija,na Yahoo Yahoo boys get dem.
He yan dis one for Di social media week wey dem arrange for Lagos.
D'banj also talk say,na only for naija you go see pesin wey no undastand miuzik but he get miuzik konpini.

Friday, 2 March 2018

FOR ABIA STATE,ONE BANK CUSTOMER WEY DEY VEX DON PUT FIRE FOR Di BANK AND ALSO BURN MOTORCYCLE WEY DEM PACK OUTSIDE Di BANK


We still dey try find out wetin dis bank do dia kostoma wey make am put fire for dia building and also go outside go burn bike.
For di video wey I put hia,you go see say di man carry fuel,pour am for di ATM machine and light fire put.
Afta dat he go outside go burn bike wey dem pack for around di gate.
He niali burn one car wey dem pack outside near di bank but pipo stopam bifor he cut out.
Just watch am for yasef...



Thursday, 1 March 2018

KOREDE BELLO NO CELEBRATE HIM BIRTHDAY DiS YEAR BICOS DEM BORN AM FOR FEBRUARY 29 AND NA FEBRUARY 28 Di CALENDAR FOR END


If dem born you for February 29,naim be say na every four four years you go dey selibrate ya birthday.
Dat na wetin no make Mavin Records bobo and Don Jazzy boy, Korede Bello selibrate him 22 years old birthday dis year be dat bicos dem bornam for February 29.
Month,end yestaday and na 28 February di month end for dis year.
Who arrange di calendar sef?
Na human beans abi na God?
See proof for hia...

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...