MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday, 16 March 2018

BIG BOY TINGS AS OLAMIDE BADOO DON OPEN HIM OWN TV STATION AND HE CALL AM 'VOICE OF THE STREET' TV


On di day wey Olamide selibrate him birthday, he mark am wit di opening of him own TV station 'Voice of The Street' under Play Tv
Dis one pass man wey sabi o.
Play tv dey di same compound wit TVC for Ketu,Lagos and he promise to give di first 100 pipo wey go mitam for di compound free decoder of Play TV.
Who say success no swit?

Thursday, 15 March 2018

TIWA SAVAGE AND HER HUSBAND TEE BILLZ DON LET COURT KNOW SAY DEM NO WAN MARRY AGAIN AND COURT GO SOON SKATA DiA MARRIAGE


Court go soon skata di marage bitwin Tiwa Savage and her husband Tee Billz.
Dem be kworel sirios kworel ova two years ago afta Tee Billz disgrace Tiwa say she don sleep wit Don Jazzy,2face and Dr Sid.
Dis mata kon vex di babe and she kon yan many sikrit full ground and how she take dey feed Tee Billz.
Now e be like say afta dem come back togeda di ting no work out and na divorce remain make dem for go dia seprate way.

Wednesday, 14 March 2018

KWARA STATE GOVNOR ABDULFATAH AHMED DON BAN Di SELLING AND DRINKING OF ALCOHOL FOR SOME AREAS FOR Di STATE


If you be shack bobo and you dey stay Kwara state,guy e don red o.
Kwara gofnor Abdultafah Ahmed don ban di selling and drinking of alcohol or even ogogoro espeshali for di Ilorin area.
Di state house of assembly get law wey dey back dis ban up and if you break di law you go pay N100,000 if dem katch you.

Tuesday, 13 March 2018

Di OWNER OF PAOK SALONIKA FOOTBALL CLUB FOR GREECE,VEX ENTA FIELD WIT GUN AND NEARLY SHOOT Di REFEREE AFTA Di REFEREE DISALLOW DIA GOAL



Ivan Savvidis di owna of Greece club,PAOK Salonkia,rush enta field and niali shoot di referee of dia match wit AEK Athens afta Di referee first accept dia goal for ending of di match and later disallow di goal.
Na one minute bin remaivn for di match to end wen PAOK score but di referee say no be beta goal afta he don first blow say na beta goal.
FIFA don alreadi shook mouth for di mata say dem go ban Greece from football kompetishon if dem no take time.
We no say Saviddis no try for dis one but some of dis referees dey mad too.

Sunday, 11 March 2018

LONDON AND Di WHOLE BRITAIN WAN BUILD N315 MILLION NAIRA PRISON FOR LAGOS SO DAT DEM GO FIT DEY TRANSFER SOME PRISONERS COME HERE


Britain don konklud plans to build 112 bedroom prison For kirikiri,Lagos so dat dem go dey transfer prisoners from yonda to Naija.
Di reason be say,dia prison don to full and e dey giv dem headache so dem need were dem go build to reduce dia cells.
Dem bin don enta dis agreement wit Naija for 2014 and now dem don ready to arrange di mata once and for all.
Akordin to tori wey we gada na £700,000 wey be N315 millions for Naija naira naim dem go spend to build di prison.
No be kwekwe prison dem won build but Koret prison wey go meet United Nations standard.

Friday, 9 March 2018

ONE FAKE PASTOR DON GIVE TWO SISTERS BELLE FOR UGBOLU KOMINITI,NEAR ASABA FOR DELTA STATE AFTA HE DO FAKE DELIVERANCE FOR DEM


One ashawo pastor don give two sistas belle for Ugbolu kominiti for near Asaba for Delta state all in di name of dilivrance.
Dis same pastor, don first do somtin like dis for Enugu wia he sleep wit mama and pikin.
Di church membas bitam welwell and dem kon drive am comot for Enugu.
Afta he run from Enugu, he come land for Asaba wia he for komit anoda one.

Thursday, 8 March 2018

JAPAN COCA-COLA DON FINISH PLANS TO START TO SELL COCA-COLA WEY ALCOHOL GO DEY INSIDE


If you dey visit Japan very soon,make you putam for di back of your mind say,Coca-Cola wey carry alcohol go dey market anytime from now.
You fit say why dem won add ogogoro join Coca-Cola wey no dey high bifor,but trust me dem oh make crazy money for dis idea.
And we biliv say,Coca-Cola worldwide go buy dis idea and put do anoda coke wey go carry ogogoro.
For 125 years wey Coke don dey,dis na di first dem wey dem won pack alcohol inside dia product.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...