MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday, 9 June 2018

SUPASTAR 'TEKNO' DON TALK SAY, HIM NO GO SCHOOL BUT HIM DEY MAKE MILLIONS AND E DEY VERY SAD SAY MANY PIPO WEY GO SCHOOL NO GET MONEY


Tekno, one of di bobo wey he miuzik dey skata differen area too just like Wizkid and Davido don yarn say,him no go school but him don make millions.
He yarn dis one for di new video wey him relz.
He also yarn say, many graduates full evriwia and dem dey broke.
He say dat kain ting no good and him dey pray say di change wey we dey talk about evriday for dis kontri go also rish di dormot of dis graduates.
Watch di video for bottom hia..


Friday, 8 June 2018

FIFA DON REMOVE Di NAME OF KENYA REFEREE 'ADEN MARWA' FROM Di WORLD CUP WEY DEY START NEXT WEEK BICOS DEM CATCHAM WEN HE TAKE N210,000 BRIBE


Aden Marwa wey be one of di referee linesman wey sopose work for di FIFA World Cup wey dey start for Russia next week,don use him own hand put him sef for wahala afta dem video am dey collect N210,000($600) bribe bifor one match wey him for referee.
Him don use him church mind resign from di World Cup work as FIFA sef don telam to find him level.

Thursday, 7 June 2018

PRESIDENT BUHARI ON BEHALF OF Di FEDERAL GOVMENT DON DECLARE JUNE 12 AS DEMOCRACY DAY TO HONOUR MKO ABIOLA WEY MANY PIPO SEE AS PESiN WEY DIE FOR DEMOCRACY


Di late M. K. O Abiola wey di world see as winna of di June 12 president elections for 1993,don finalli get di honor wey he dizav afta President Buhari declare June as democracy day.
Forma khaki leader Ibrahim Babangida naim be kanso di election for 1993 and Abacha kon arrest Abiola join bicos he start to call imsef president.
Abiola later die for prison but now Buhari say afta some kain meeting wit top pipo for di kontri, him decide to honor Abiola wit Di June 12 public holiday.
He also honor ram wit di highest award for di kontri GCFR.
Also,dem give him running mate and assistant dat year, Babagana Kingibe Di GCON Award.
Dem also give Gani Fawehinmi di GCON Award to take rekognaiz him fight for democracy and beta gofment.

Tuesday, 5 June 2018

KANU NWANKWO DON YARN TORi PIPO SAY,LOCAL POLICE FOR RUSSIA DON RETURN HIM 4 MILLION WEY DEM BE THIEF WEN HIM LAND FOR DIA AIRPORT TO ATTEND DI WORLD CUP


Jangolikos bin tiff Super Eagles forma captain Kanu Nwankwo money for Russia airport afta he land to attend di World Cup yestaday.
We wake today to find out say dem don return di money $11,000 dollars wey be N4 million naira.
Akordin to Kanu he say di local police for di airport don see di money and dem don return am.

Monday, 4 June 2018

CRISTIANO RONALDO DON HIRE ANIMAL AND BULL FIGHTER NUNO MARECOS AS HIM BODY GUARD FOR RUSSIA 2018 FIFA WORLD CUP WEY GO START IN TEN DAYS TIME



Portugal Captain Cristiano Ronaldo nor won hia any stori say dem take am unaware for di 2018 FIFA World Cup wey go soon start for Russia.
Di Real Madrid supastar don hire animal and bull fighta Nuno Marecos to be him body guard thru out di piriod wey dem go play di World Cup.
Some weeks ago,ISIS di Islamic terrorist gang threaten say dem go kill Ronaldo and Messi during di World Cup.
Dis one go dey among one of di reason wey make Ronaldo hire dis guy.

Sunday, 3 June 2018

SINGA 'DAMMY KRANE' DON YARN TORi PIPO SAY, DAT TIME WEY HIM DEY WORK WIT 2FACE RECORD COMPANY AND OTHERS, NA ONLY AM BIN DEY PAY FOR HIM VIDEOS AND ALSO SPONSOR IMSEF


Singa Dammy Krane Don yarn tori pipo some sikrits as he take concern am espeshali dat time went him still dey unda record company. 
From di way wey di yarns go, e be like say na wen him dey wit Hypertek records, Di company of 2face all dis tings appun. 
He say all those times,na only him dey spend money shoot him videos. 
He also yarn say, him buy him first Benz car at 16 years, buy some big propati went him be 17 years old. 
Dammy most popular song dat year name 'My dear'. 

Friday, 1 June 2018

SAUCE KID' THE NIGERIAN RAPPER WEY DEM JUST RELEASE FROM AMERICA PRISON DON YARN SAY,HIM WRITE OVER 300 SONGS FOR INSIDE PRISON


Sauce Kid the Naija rapa wey just come out for America prison afta dem catch am bicos of credit card wuruwuru bizness,don tell tori pipo say,him don write ova 300 songs wen him dey prison.
Just three days ago,Davido sign Sauce Kid enta Davido Worldwide Music,DMW.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...