Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Friday, 15 June 2018
KOLA ABIOLA WEY BE Di FIRST SON OF M. K. O ABIOLA DON TALK SAY, BUHARI DON DO WETIN JONATHAN NO FIT DO AFTA HE BEGAM THREE TIMES TO GIVE HIM PAPA Di GCFR AWARD
To Kola Abiola, Goodluck Jonathan fall him hand welwell afta he begam tire to honor him papa wit di GCFR awarld.
He say him beg Uncle Jona three times to honor him papa but di man no gree.
But last week President Buhari naim kon use him church mind give Abiola di highest award for naija.
Him papa M. K. O Abiola naim win di June 12,1993 election wey Babangida cancel but Abacha arrestam and he later die for prison for July 7,1998.
Thursday, 14 June 2018
AS THE 2018 FIFA WORLD CUP DEY START TODAY FOR RUSSIA, DEM DON PENCIL 'WIZKID' NAME DOWN AS OF ONE Di STARS WEY GO SING FOR Di OPENING SERiMONi DiS EVENING
Ayo Balogun a.k.a Wizkid don add anoda feather join him name as dem don choose am to sing for today opening serimoni of di 2018 FIFA World Cup wey go start dis evening for Russia.
He go sing togeda wit Nicky Jam featuring Will Smith and Era Istrefi.
Di Grace too plenti.
Na only God fit do am.
Wednesday, 13 June 2018
SUPER EAGLES PLAYER WILFRED NDIDI TALK SAY,BIFOR HE MAKE AM,HE HAWK GROUNDNUT, PURE WATER,TOMATOES AND HE ALSO WASH MOTOR WINDSCREEN FOR LAGOS TRAFFIC
E no get anybodi wey no know say,nor be evribodi dem born wit silver spoon.
Super Eagles midfida and Leicester city player Wilfred Ndidi don yarn tori pipo say,him hawk groundnut tire,him hawk tomatoes and pepper for him mama just to fit sorvive.
No be only dat one o.
He say him also wipe windscreen for Lagos traffic just to get some biskit money.
Ndidi also yarn tori pipo say di biggest money wey him make for a day dat time na 3k but today by God Grace tins don change.
Watch di video for bottom hia...
Tuesday, 12 June 2018
RAPPER 'PHYNO', DON YARN TORi PIPO SAY, HIM LOVE BEAUTIFUL GIRLS WEY GET SENSE TOO AND HE HATE GIRLS WEY DiA MOUTH SHARP LIKE RAZOR BLADE
Strong naija rapper Phyno,don yarn tori pipo say,him no fit follow woman wey her mouth sharp pass razor blade.
He say him no dey like to be friends wit those kain pipo.
Phyno kon also yarn say, him no dey use biutiful gehs play but sha, di biutiful gehs wey himlike must dey intelligent wit plenti sense.
Monday, 11 June 2018
THIS DAMMY KRANE T-SHIRT GOT ME THINKING
After the credit card incidence involving the 'My Dear' crooner Dammy Krane, he is captured here rocking a fitted T-shirt with a thought provoking inscription 'Fraud Alert' that might be aimed at dissuading people from indulging themselves in the act as posted on his instagram page.
NOLLYWOOD DIVA 'DAKORE EGBUSON AKANDE' DON YARN TORi PIPO SAY, Di REASON WHY SHE CARRY DADA FOR HEAD FOR 13 YEARS NA BICOS OF Di LOVE WEY SHE GET FOR BOB MARLEY DADA
If you rili follow up nollywood film bifor bifor, you sopose notice one babe wey carry dada for head when nobody even dey do dat kain hairstyle.
Her name na Dakore Egbuson Akande.
She say na Bob Marley own dada give her di inspiration to train and carry dada for head for good 13 years.
Anytime she see Bob Marley hair bodi dey swit her.
She she pipo even dey feel say she be ogbanje and she get kolo for head bicos of di dada.
Sunday, 10 June 2018
AFTA SHATTA WALE OF GHANA BIN BOAST LAST YEAR SAY,HIM GO DO WIZKID STRONG TING IF HE COME GHANA AGAIN,TWO OF DEM DON FINALLY SETTLE DiA QUARREL FOR STAGE
Shatta Wale of Ghana and Nigeria Wizkid don settle dia quarel for stage during di Naija meet Ghana concert for Accra yestaday.
Wen Wizkid dey sing he say,as Africans we must win togeda no need to dey fight oursef bicos he no make sense.
I no go dey soprise wen dis two bobo do colabo veri soon.
Subscribe to:
Posts (Atom)






