MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday, 9 August 2018

GOD DON ANSWER Di PRAYERS OF 13 YEARS RAPPER,'MEGABYTE' AS BILIONAIRE OIL BOY 'FEMI OTEDOLA' DON PROMISE TO TAKE CARE OF Di RAPPER SECONDARY AND UNiVASiTi EDUCATION



Wen God don sign am say e go be,nobodi fit change am.
13 year old young rapper 'Megabyte' don get betament from Femi Otedola as di billionaire don promise to take kia of him sekondri and univasiti education.
He yarn dis one wen Megabyte visitam for him house.
If you dey follow up,Megabyte na one smallie wey don dey scata di intanet wit him rapping skills espeshali him free styling rap skills.

Tuesday, 7 August 2018

GOOD NEWS: TANZANIA DON APPOINT FORMA SUPER EAGLES AND AFRICA FOOTBALLER OF THE YEAR 'EMMANUEL AMUNIKE' AS DiA NEW COACH


Nigeria football don resiv boost up afta di Tanzania football association appoint our own Emmanuel Amunike as dia new coach.
Di forma Africa footballer of di year go try re-arrange Tanzania soccer afta dia school boy football dey make dia oga dem dey vex for yonda.
Amunike go try to see weda him fit qualify dem for di 2019 nations cup since dem don alreadi start veri bad as dem dey di number three position for dia group.

Monday, 6 August 2018

SKALES DON TELL TORi PIPO SAY,WEN HIM NO GET HOUSE TO SLEEP AFTA HE LEAVE BANKY W,NA TIMAYA AND OLAMIDE NAiM COMOT AM FOR SUFFER


Skales,forma boy for Banky W record label EME Records,don yarn tori pipo say,him suffer no be small.
Afta he live Banky he say him no go anywia to stay again until Timaya givam house to stay.

Sunday, 5 August 2018

THE QUARREL BiTWiN HARRYSONG AND KISS DANIEL DON DEY TIE WRAPPER AS HARRYSONG DON TELAM MAKE HE KIP KWAYET AND GROW UP


Since di reliz of Harrysong new song 'Selense' wey him feature Reekado Banks and Kiss Daniel nor be small tin don follow.
Di quarel start afta tori boss out say,Kiss Daniel dey vex say him no won get anytin to do wit Reekado for di same song.
Di same Daniel camp don yarn say kwanta no dey bitwin him and Reekado say evritin dey fine.
Now Harrysong don come out to tell Kiss Daniel to shut up and grow up say na lie he dey lie.
Harry say as young as Kiss Daniel be,he don carry pride for bodi for dis age.
E for beta make he kip kwayet and grow up.

Saturday, 4 August 2018

YORUBA FILM PRODUCER DEBBIE SHOKOYA DON TELL TORi PIPO SAY,SHE HATE MAN WEY DEY WEAR Di SAME BOXERS FOR TWO DAYS


Guys,Yoruba movie producer and actress, Debbie Shokoya,don call una out o.
She say di kain man wey she hate na man wey dey repeat boxers.
She say you sopose wear diferen boxers different days for your own good bicos afta dat day di boxers go don dirty and for you to carry am wear di next day just be like say you be madman.

Friday, 3 August 2018

NOLLYWOOD ACTRESS CHIKA IKE,DON YARN SAY,TOGEDA WIT HER FORMA HUSBAND,SHE ALSO GET SOME PART OF Di BLAME FOR Di COLLAPSE OF DiA MARRIAGE FOR 2013


E no easy for pipo to take blame for di kolaps of dia marriage but for di new book wey nollywood actress Chika Ike write,she yarn say,she get some blame too for her marriage to Mr Eberibi wey skata for 2013.
She yarn all dis one for her book "Boss You' wey she write and many pipo don praise her say she try to come out to yarn clean like dis.

Wednesday, 1 August 2018

KWARA STATE HOUSE OF ASSEMBLY SPEAKER, DR. ALI AHMAD WEY JUST RUN GO BACK TO PDP DON YARN SAY,HIM REGRET SAY HIM EVER JOIN APC


Kwara state house of assembly speaker Dr. Ali Ahmad don yarn say him regret say him eva join APC.
Dr Ali plus twenty two other house of assembly membas don  run go back to PDP.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...