MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday, 17 August 2018

MANY NIGERIANS DON BLAST DUNCAN MIGHTY SAY HE FALL DiA HAND AFTA Di VIDEO OF WEN HIM BOW DOWN TO GREET DAVIDO COME OUT



No be small blast Nigerians don dey blast Duncan Mighty afta di bobo bow down for Davido for di new video wey don full evriwia.
He see Davido as a biga miuzishan,di only reason wey make am prostrate foram be dat but many pipo dey vex for di Port Harcourt first son say na falling hand bicos he sinior Davido wit almost ten years.
No be only dat one o,he also first Davido dey serve Naija pipo koret jam.
Inshot,wen pipo dey enjoy Duncan Mighty jams,Davido still dey primary school and dis one sef dey among wetin make pipo dey para like paracetamol.
Well,Nigerians make una take am easy on Duncan,he go learn him lesson.

WHY NIGERIANS LAMBASTED DUNCAN MIGHTY AFTER PROSTRATING FOR DAVIDO



Rave of the moment Duncan Mighty,has received knocks from many Nigerians after a video of him prostrating for Davido surfaced online. Some say the video only displayed humility on the part of the Port Harcourt first son while others say prostrating for a kid you're way older than and even started making hits before he ever dreamt of joining the fray,is uncalled for. His career got resuscitated after the collaboration with Wizkid on unarguably one of the biggest song in Africa right now 'Fake Love'. It would have been understood and wouldn't have generated much furore if Wizkid was the one he prostrated for. Hope Nigerians won't wake up to see a video of him kissing Tiwa Savage's shoe after the diva featured him on her recently released single Lova Lova. Duncan Mighty,Davido,Wizkid are legends in their own right but we should learn how to contain excitement sometimes so we don't become subject of ridicule.

Thursday, 16 August 2018

FOR SOYOYE,ABEOKUTA NORTH OGUN STATE,POLICE DON ARREST LANDLORD WEY JOIN ARM ROBBERS GO ROB ANODA LANDLORD FOR HIM AREA


40 years old Adegbite Taoheed wey be landlord, don lead oda fellow arm robbers go rob anoda landlord for him area for Soyoye,Abeokuta North council for Ogun state.
Di good ting about di mata be say,police don arrest him and him gang.
Dis Taoheed as we take resiv di tori,na memba of di Association of Landlords for Oke Odo,Ogun state.
Na wa o,dis guy own pass who winsh dey worry.

Wednesday, 15 August 2018

IF YOU GET PLAN TO TRAVEL GO SUDAN AND YOU BE BREAD LOVER,SORRY BICOS BREAD DON SCARCE FOR DAT KONTRi


E don red for Sudan o!
Flour and wheat and evritin wey concern bread don dey cost.
Akordin to di tori,pipo dey queue like mad for bakeries sake of di skasiti.
Di reason wey we hear na bicos of dollar and other foreign money crisis.

Tuesday, 14 August 2018

FRIENDSHIP CONTINUE AS PRESIDENT BUHARI STILL CHOOSE OSINBAJO TO BE HIM ASSiSTANT PRESIDO AND NUMBER TWO MAN FOR THE 2019 ELECTIONS


Di Sinior Spesha Assistant to President Buhari on top midia and publisiti mata,Garba Shehu don yarn tori pipo say,Yemi Osinbajo naim go still be Buhari nomba two man for di 2019 President election.
He yarn dis one wen he dey ansa queshons from tori pipo for Abuja.
He say di way wey APC take clear di bye elections wey dem just do for Bauchi,Katsina and Kogi state show say,evritin still dey work well for APC and no need to change di winning team.

Sunday, 12 August 2018

SUPASTAR GOSPEL MUSIC SINGER 'SINACH' DON YARN SAY,SHE NO GO VEX EVEN IF DJs DEM DEY PLAY HER MUSIC FOR INSIDE NIGHT CLUBS


Sinach,one of di biggest gospel music singa, don yarn tori pipo say,she no mind if night club DJs dey blast her songs for clubs.
She yarn tori pipo dis one as she say, her friend send her one video of pipo wey dey sing follow her jam for club.
She say if you sing beta song pipo go look for di song bicos evribodi weda na club you dey or not,need inspiration,love and enkoragement.

Friday, 10 August 2018

LAGOS STATE GOFMENT DON SCATA 9 STOREY BUILDING FOR OSAPA,LEKKI BICOS Di CONTRACTOR NO FOLLOW Di PLAN OF Di AREA


Lagos state gofment don start to skata di 9 storey building for Osapa London for Lekki area on Thursday.
Dem go take dia time skataram till e go reach ground kpatakpata.
Di reason be say dem no follow di master plan of di area.
Dada Fayemi naim be di name of di street.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...