MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday, 9 September 2018

RASAQ OLAYIWOLA a.k.a OJOPAGOGO DON CRY OUT SAY,HIM DON TIRE TO DEY ACT SO SO BABALAWO ROLE FOR INSIDE FILM





Anytin wey dey put food for your table,no use am joke at all,at all.
Babalawo work for inside Yoruba film don dey put food for di table of Rasaq Olayiwola for plenti years now.
But Rasaq a.k.a Ojopagogo don yarn say him don tire to dey act di Babalawo part for movie evri time.
He say make film producers try dey givam oda roles as dem no born am wit Babalawo work.
Wen tori pipo askam which role him go like apart from di Babalawo role.
Rasaq kon yarn say,if dem givam badboy part all dis krimina role, dat kain role wey him go dey give pipo wahala for inside film,him go like am.
Oga Ojopagogo,i no see any difference bitwin Babalawo and badboy roles.

Friday, 7 September 2018

HARRYSONG DON PUT FEAR FOR HIM FANS MIND AFTA HE YARN SAY,MAKE ANYBODY NO CRY IF HE DIE


On top Instagram wey lots of pipo dey show dis lifestyle, Harrysong don yarn somtin wey put fear for pipo mind for him Instagram page.
Di reggae blues singa yarn say,if him die make anybodi no cry foram.
Di last pesin wey talk and sing about dis kain tin for him miuzik na Dagrin and true true,di boy later die for accident.
Although Harrysong manager don confam say di bobo dey pass thru some difficult moments.
Many of Harry friends, fans and famili membas don dey call am to pray witam base on dis one.

Thursday, 6 September 2018

SOWORE DON YARN SAY,IF HE BECOME PRESIDENT FOR 2019,MARIJUANA FARMERS GO ENJOY BICOS NIGERIA GO DEY MAKE MILLIONS FROM SELLING IGBO (MARIJUANA) TO FOREIGN COUNTRIES


I biliv say Smokers of igbo and igbo farmers don get who dem go vote for next year for di election of who go be president for 2019 for Naija.
Sahara reporters Oga,Omoyele Sowore don yarn say if he win di 2019 election,di selling of igbo or marijuana go be one of di bizness wey Nigeria go dey make millions from.
If you dey follow up you go sopose know say,dem dey use igbo as drugs and merisin to cure some kain sickness.
Now Sowore don come out to yarn say,no need for NDLEA to dey arrest di igbo farmers bicos no be bad bizness.

Wednesday, 5 September 2018

MAMA OF 3 CHILDREN 'RONKE OLANREWAJU' DON YARN SAY,IF Di OJA-OBA CUSTOMARY COURT FOR MAPO,OYO STATE NO SCATTA SHE AND HER HUSBAND MARRIAGE,SHE GO POISON Di HUSBAND


No be small drama for Oja-Oba customary court for Mapo,Ibadan Oyo state as di mother of three pikin Ronke Olanrewaju don threaten to poison di husband for house if di court no stop dis marriage.
Akordin to Ronke her husband Sunday Olanrewaju don turn her to punching bag for house as he dey beat craze comot for her bodi evri time.
She say if di husband just siam wit man customers for her bizness,na beating she dey resiv bicos he say she dey do something wit dem.
She say no be di husband only sin be dat o,as he also dey beat her mama like small pikin.
Now she want make court skata di marriage if not, she go poison di man for house.
Di husband don dey beg court say make dem no do like dat bicos he love him wlove and she be like mama toram.
President of di court Chief Henry Agbaje don fix September 18 for judgement and he say room still dey for settlement.

Monday, 3 September 2018

AFTA HE RULE NAIJA FOR 6 YEARS,FORMA PRESIDO 'GOODLUCK JONATHAN' DON TALK SAY,HIM READY TO GO BACK TO HIM TEACHER WORK IF HE GET Di JOB



Forma naija Presido Goodluck Ebele Jonathan,don yarn tori pipo say,if any school espeshali The Ignatius Ajuru Univasiti of Education, Port Harcourt givam work he go like am.
Uncle Jona say,him readi to go back to classroom.
He yarn dis one during Ignatius Ajuru Nomba 35 and 36 convocation serimoni.
He also thank dem for di 'icon of democracy' award wey dem givam for di ground.

Sunday, 2 September 2018

PAWPAW FRIEND 'CHINEDU IKEDIEZE' a.k.a 'AKI' DON YARN SAY,HIM NA BIG BASKETBALL FAN BUT HIM SHORTNESS NO ALLOW AM PLAY Di GAME



Evribodi get dat one ting wey dem dey regret say dem no fit do or fit dey do.
To some pipo e fit be say dem rili like to bikom doctor but jamb no gree,why some go say,e pain dem say dem no come from Dangote famili.
Nollywood star,Chinedu Ikedieze a.k.a 'Aki' don talk dat one ting wey dey pain am enta bone.
He say him na big basketball fan but bicos him no tall him no fit follow up wit him basketball dream.
He say bicos of him height dia is nothing he fit do about am.
Sorry bros,God get reason for evritin.

Saturday, 1 September 2018

COMEDIAN 'SEYI LAW' DON YARN SAY,AFTA HE BUY HIM HOUSE NA ONLY N63,000 KON REMAIN FOR HIM BANK ACCOUNT


Seyi Law,one of di comedians wey dey crack pipo ribs wit jokes,don tell tori pipo say,na N63k remain for him account balance afta he buy him house.
He yarn dis one afta one tori pesin say make police investigate how he take make money buy house of millions.
He say,him shows dey givam money so diafor,no need to dey tink about dis and dat.
Seyi also say,since he bigin him komedi karia, no politician don eva dasham money.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...