Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Sunday, 16 September 2018
TANZANIA ACTRESS 'WEMA SEPATU' DON YARN TORi PIPO SAY,Di KIND MAN WEY SHE WANT NA MAN WEY GO DEY BEAT HER LIKE MIKE TYSON FOR HOUSE
Wema Sepatu,big name actress for Tanzania don yarn tori pipo say,na man wey go dey beat her like Mike Tyson she dey find.
Dis one weak me o.
Naim be say dis kain woman go do evritin wey go make her husband always dey vex.
She ready to burn soup steadi so dat di husband go vex beat her.
Dem be say to dey beat woman no good na.
Na wa o.
Saturday, 15 September 2018
FELA DAUGHTER 'MOTUNRAYO' DON TALK SAY,SHE HATE DAVIDO AND SHE ALSO HATE Di TYPE OF MEANINGLESS MUSIC WEY HE DEY SING LIKE SHIT
O boy,dis one loud o.
Fela daughta Motunrayo Anikulapo Kuti don yarn tori pipo say,she hate Davido like shit.
She say no be only dat one o,she say she hate di miuzik too bicos dem no dey make sense.
Akordin to Motunrayo she say,Davido dey always sing about money, love and girls and dat no be di type miuzik wey she like.
She say Davido don try to disrespect her one time for her papa shrine afta he sidon for her chair but she no waste time to telam say dem no be mate make Davido stand up.
She say Davido true true, stand up but di truth be say she no like di boy karata.
Friday, 14 September 2018
BREAKING NEWS!!!TORi WEY DEY REACH OUR NEWS YARD BE SAY,KEMI ADEOSUN Di FINANCE MINISTA,DON RESIGN
Di minista of finance Kemi Adeosun don resign from her position.
She hersef neva confam am but dis tori dey fly from left,right and center say,she don comot bodi from di Buhari gofment.
Argument bin dey ova her NYSC satifikate as some tori pipo bin talk say,na fake satifikate she get.
We go bring una more tori as e take concern dis mata as e dey drop.
Thursday, 13 September 2018
COMEDIENNE 'LEPACIOUS BOSE' DON PRAISE GHANA PIPO SAY DEM NO DEY BLEACH LIKE NAIJA PIPO WEY CARRY BLEACHING FOR HEAD LIKE DANDRUFF
Woman comedian 'Lepacious Bose' don yab Nigeria pipo wey carry bleaching for head like gala.
She say anytime wey she travel go Ghana,she dey dey kampe and feel at home bicos she and dem dey black togeda.
But she say if she dey naija,diferen diferen colors of human being naim she dey see.
Some yellow,some green,some color na blue but e no be like dat for Ghana as dem no get time to bleach dia skin.
Wednesday, 12 September 2018
WIZKID BABY MAMA 'BINTA' FOR AMERICA DON TALK SAY,HE NO DEY TAKE CARE OF DIA PIKIN AND WIZKID FAMILY BEG HER MAKE SHE NO CARRY AM GO COURT IF NOT,WIZKID FOR CRY BLOOD
Binta Diallo,di mama to Wizkid second son 'Ayo' don yarn say,di Ojuelegba star na yeye papa to dia son.
She say di only ting wey make am neva carry Wizkid go court make dem kuku settle di mata na bicos,Wizkid famili beg her make she no do am if not,Wizkid for don cry blood tire.
If she sue Wizkid ova di child support mata,na big ploblem for America as dem go almost finish Wizzy money just to dey take care of di son.
America laws different from Nnewi laws or Sokoto laws.
Dia laws fit put big hole for your pocket ova some kain problem.
Tuesday, 11 September 2018
OBA OF BENIN DON GIVE ORDER MAKE DEM DESTROY IGBEKHUEN VILLAGE SHRINE AND MARKET BICOS DEM NO GET APPROVAL FROM PALACE BIFOR DEM BUILD DEM
Pawa good o.
Ogue-Odion di shrine of Igbekhuen village shrine for Orhionwon local govment area for Edo state don hear ram as di Oba of Benin don say make dem destroy di shrine and dia market bicos palace no approve vam bifor dem build am.
He yarn dis one for di palace wen him dey settle all di wahala and cases wry dem carry come palace.
For di Igbekhuen judgement, di Oba say make dem destroy di shrine afta elders of di shrine report say, some pipo build second shrine for di village for no reason.
Monday, 10 September 2018
LIBYA COACH DON TELL NIGERIA 'SORRY' AFTA HE TALK SAY,NA JUJU WE DEY USE WIN MATCH
Libya coach Adel Amrouche,don dey beg naija make dem no vex say him yarn di whole world say na juju we dey use win our football matches.
He yarn dis one for South Africa afta Libya play zero zero wit di Bafana Bafana for di nations cup qualifier.
Di coach dey ansa tori pipo queshons base on di match wey dem go come play wit Nigeria next month.
Adel Amrouche don write on top him twita page say make we no vex say na joke him dey joke wen he say,Nigeria biliv in juju but Libya biliv in God.
Subscribe to:
Posts (Atom)








