Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Monday, 26 November 2018
CHIDINMA AARON OF ENUGU DON BECOME THE 2018 MOST BEAUTIFUL GIRL FOR NIGERIA AFTA SHE WIN THE AWARD FOR EKO HOTEL LAGOS YESTADAY
Chidinma Aaron don get new car,3 million plus house wey dem don pay for afta she win di 2018 most biutifu girl award for naija.
Dem do di award for Eko hotel for Lagos yestaday.
Na Enugu she teprezent take win di award.
Some of di judges for di award Nollywood stars Mofe Damijo and Rita Dominic,Beat FM Olisa Adibua and di MCs of di day na,Ebuka and Kayla Oniwo.
Sunday, 25 November 2018
FOR ASABA DELTA STATE,POLICE DON ARREST THE 14 YEARS OLD GIRL WEY STAB HER PAPA DIE FOR INSIDE SLEEP
For Cable Area for Asaba Delta state,police don arrest di 14 years old girl wey kill her papa for inside sleep.
Akordin to di tori wey we gada,her papa disiplin her for one offenand di tin kon vex her.
Wen evribodi don sleep,naim she get up stab her papa wit knife to pay back.
You dey life na you kill your papa,dat record no swit for ear at all.
Saturday, 24 November 2018
DEM DON ARREST TWO STUDENT OF GOVERNMENT SECONDARY SCHOOL FOR LAFIA,NASARAWA STATE WIT GUNS
Yusuf Ibrahim and Tasiu Yusuf don enta police net afta dem catch dem wit gun.
Na di school discipline komiti katch dem and dem hand dem ova to di Nigeria Security and Civil Defense Corps.
Dem be students of Gofment Sekondri School for Lafia for Nasarawa state.
Meanwhy,di owners of di locker Abubakar Haruna and Abduo- Ruof Nora don run lost since dem dey find dem bicos na dem be di owns of di locker and drawer wia dem see di guns.
Thursday, 22 November 2018
BURNA BOY AND SUPER EAGLES PLAYER LEON BALOGUN,DON DEY BEG NAIJA PIPO MAKE DEM NO BUY Di BLEACHING CREAM WEY AMERICA SELiBRiTi 'BLAC CHYNA' DEY CARRY COME LAGOS COME SELL
Super Eagles difenda Leon Balogun and singa Burna Boy don advise America model 'Blac Chyna' make she no carry her useless bleaching cream come Nigeria come sell.
Di bleaching na to take bleach your yansh and oda part of your bodi and we even hear say na 91k dem dey sell di Cream.
Burna and Leon say Black is Beautiful so diafor,you no need any kemika to take destroy your skin.
Many naija pipo don dey tell her and different top world tori pipo like BBC don carry di news.
Wednesday, 21 November 2018
OBAMA DEY AMONG PIPO WEY PUSH ME COMOT FOR ASO ROCK..NA WETIN FORMA PRESIDO 'GOODLUCK JONATHAN' TALK BE DAT FOR INSIDE Di NEW BOOK 'MY TRANSITION HOUR' WEY HIM WRITE
Di 2015 election wey Buhari win don come and go but di man wey Buhari win for di election Goodluck Ebele Jonathan still dey vex for pipo wey make sure say him loose di election.
For inside di new book wey he write and launch for Abuja yestaday,Uncle Jona say,wetin Forma America presido Barrack Obama do am still dey pain.
He say Obama yarn am to him face for inside video make naija pipo choose new chapta for dia life thru di election.
Goodluck say,na only blind man no go undastand wetin he mean wit dat word.
He say e mean say make dem vote for new pesin.
As if dat one no reach,he also send him seketri John Kerry come naija bifor di election make Goodluck no try robish as he dey plan to postpone di election.
And true true na so fear match Jona kuku leave di election timetable di way wey he take relizam bifor.
Tuesday, 20 November 2018
ONE OF THE SWEETEST VOICE FOR RADIO FOR LAGOS 'TOSYN BUCKNOR' DON DIE AT THE AGE OF 37
Tosyn Bucknor,one of di veri sweet voice for radio for Lagos don kick di bucket last nite.
Her French husband of three years Aurélien Boyer, come back for work kon see say him wife don die.
Di ting send shock waves enta naija and her fans,friends, fellow workas,selibritis don dey send message of dia sadness and regret since di tori break.
Until her death,she make her name for Top radio Lagos as dia morning show prezenta.
She start her radio karia for Eko FM and do her IT wit Cool FM.
She bin dey work wit Inspiration FM Lagos presentli bifor di wicked hands of death draw her take.
Rest in Peace Area Mama.
Monday, 19 November 2018
OBASANJO DON CARRY ONE JOURNALIST 'AKANDA ORO' GO COURT FOR ONE BILLION NAIRA BICOS HE RUBBISH HIM NAME AFTA HE TALK SAY,NA OBASANJO KILL BOLA IGE
Forma khaki and sivilian presido Olusegun Obasanjo don carry 'Akanda Oro' a.k.a Awikonko go court afta di man talk on top one radio program say na Obj kill Bola Ige,Harry Marshall and many oda pipo.
If you dey follow up,Bola Ige na forma Attorney General for naija.
Awikonko even talk say,make Obj swear wit Ogun juju say him no know anytin about those pipo wey die.
Obasanjo now don yarn say,di guy dey yarn puan and robish and for dat sake,him dey carry am go court to pay one billion naira for di damage wey he give he name.
Subscribe to:
Posts (Atom)






