MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday, 3 December 2018

NIGERIA SINGA AND RAPPER 'LYNXXX' DON YARN TORi PIPO SAY, NO BE SIN FOR PESIN TO DEY SHACK ALCOHOL



If you dey wonda who dis kain yarns dey come from him mouth,him name na,Chukie Edozien a.k.a 'Lynxxx' di rappa.
Lynxxx na one singa wey be say anywia you siam, he dey always smoke cigar.
Di bobo wey claim say him na born again Christian don yarn say,to dey drink alcohol no be sin at all.
Di Asaba Delta state born rapper and singa say,di first miracle wey Jesus pafom for Bible na wen him turn water to wine make pipo shack for inside one joinbodi groove.
So diafor,him no see wia to shack alcohol don turn sin.

Sunday, 2 December 2018

FORMER PRESIDO 'EBELE JONATHAN' DON TALK SAY MAKE PIPO FORGET DAT YEYE STORY SAY PDP MESS UP FOR 16 YEARS AS HE SAY,HUNGER FOR DON KILL ALL OF US IF NA TRUE


If you dey among pipo wey biliv say PDP mess dis kontri up for 16 years wey dem dey pawa, 'Goodluck Ebele Jonathan' don dey para for una o.
Akordin to di forma presido he say,if dis yarns na true,hunga for don kill all of us for dis kontri.
He even talk say make we kompia di price of bag of rice dat time wey PDP dey pawa wit di price for dis APC piriod.
Uncle Jona say PDP try for dia own time so diafor make oda pipo try do dia own too instead of to dey blame PDP upandan.

Saturday, 1 December 2018

TERRY G THE AKPAKO MASTER,DON YARN TORi PIPO SAY,HIM PIKIN MAMA LOVAM WELWELL BUT SHE NO LIKE HIM SONGS



Di king of Akpako miuzik Terry G,don blast pipo wey dey drink panadol on top why he Neva marry him baby mama.
He say him love di babe and wen fi time rish dem go marry and him no know why pipo no go fit mind dia bizness.
He say even tho him neva marry her,bicos him love her naim make am givam all him bizness dey manage.
Terry G say,two of fem day dey studi wetin marriage mean,no be to jump inside.
Terry say di babe know am inside out,she know Gabriel but she no rili know Terry G.
infact she love Gabriel but she no be fan of Terry G miuzik.
Na she be di nomba one pesin wey dey telam wetin no swit for him songs.

Friday, 30 November 2018

FOOTBALL FANS FOR CAMEROON DON ATTACK Di FAMiLi HOUSE OF DiA STARGIRL 'ENGANAMOUIT' JUST BICOS SHE MISS PENARiTi AGAINST NIGERIA FALCONS FOR Di WOMEN TORNAMENT FOR GHANA




Cameroon fans don take Africa football  backward afta dem go attack di famili house of dia female soccer star 'Gaelle Enganamouit' afta she miss penariti for dia semi final match for di women cup of nations against di Super Falcons of naija.
Akordin to di tori wey dey reach us,dem even dey throw stone to skata di house and dem live message give di famili say fem go come back come gidem wahala.
Too bad!

Thursday, 29 November 2018

POVERTY DIE!...NA Di TITLE OF OLAMIDE NEW SONG WEY HE JUST RELEASE YESTADAY...POVERTY NA BAD THING TRUE TRUE


Olamide don release him new jam and he call am,'poverty die'.
Afta Olamide reliz some stubborn songs like 'WO and Science Student' for di past two years.
Make we dey watch weda Poverty Die go shine like di oda ones espeshali as poverty won bury pipo for dis kontri.

Wednesday, 28 November 2018

17 YEARS OLD AND YOUNG GHANA ACTRESS 'MAAME YAA' DON TALK SAY,NOTHING FOR DIS WORLD GO MAKE HER FOLLOW BOY WEY NO GO FIT BUY HER CAR



Maame Yaa,di young Ghana actress don yarn tori pipo say,notin go eva make her friend boy wey no fit buy her car.
Di 17 years old babe say,she get problem wey she go like take care of like to get car and poor man no go fit buy am.
She say,evri woman deserve man wey go provide food foram, takia of am.
All dis tins na problem for poorman bicos to eat sef na problem foram.
so how he won take takia of her?

Tuesday, 27 November 2018

PRESIDENT BUHARI DON INCREASE POLICE SALARY AND ALSO INCREASE DIA ALLOWANCE AND PENSION MONEY


President Muhammadu Buhari don promise to inkriz police pipo salary.
No be only dat one as dem go also inkriz dia pension and allawans money.
Uncle Buhari yarn dis one during di joinbodi meeting wey him get wit di Police Service Commission afta dem visitam for Abuja.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...