MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday, 7 December 2018

'JUNE 12' DON FINALLY BECOME THE NEW DEMOCRACY DAY FOR NIGERIA AND 'PUBLIC HOLIDAY' FOR OUR CALENDAR AFTA THE 'HOUSE OF REPS' CANCEL 'MAY 29' AS DEMOCRACY DAY



Wetin I neva know for now na weda di late M.K.O Abiola wey evribodi gree say naim win di June 12,1993 president election go dey hapi for him grave now afta di House of Reps finalli approve June 12 as di new Democracy Day for Naija.
Dis one mean say,from next year,May 29 go stop to be our Democracy Day and public holiday, as dem don approve June 12 as di day wey go dey enjoy all dis medemede.
For 1993,di regime of Khaki presido, Ibrahim Babangida, bin cancel the June 12 election for no reason.

Thursday, 6 December 2018

TITHE AND OFFERING ENEMY 'DADDY FREEZE', DON YARN TORi PIPO SAY,DAVIDO SABi SING PASS WIZKID AND TEKNO



If you dey follow up, you sopose don know about 'tithe and offering nomba one enimi' 'Daddy Freeze'.
Today tori no be about offering and tithe but about Davido,Wizkid,Tekno and dia singing pawa.
Freeze don come out to yarn say,Davido sing pass both Wizkid and Tekno.
Reason be say,Davido dey fit stress him voice to a point wey Wizzy no fit reach.
He say Wizkid na good singa but he dey play safe and dey fear to do new tins wit him voice but Davido dey do evritin to stretch him voice.
He also name Timi Dakolo,Praiz,Terry G as pipo wey also sabi sing pass Wizkid.
Make we kack dey watch weda dis table wey dis man dey shake go break.

Tuesday, 4 December 2018

TINUBU DON REJECT TO BE CAMPAIGN OGA FOR BUHARI FOR Di 2019 ELECTION BICOS HE WON FOCUS ON SOUTHWEST AREAS


Tori wey dey reach our table right now be say,di national leader of APC, Ahmed Tinubu don reject to be campaign oga for Buhari as e take concern di 2019 election.
E be like say Tinubu no too api for di way wey dem don tritam for di party.
Akordin to di report,e be like say he won put all him attention for di Yoruba states since no be all di States dey loyal toram.

POLICE DON ARREST YORUBA SINGA 'SMALL DOCTOR AND THREE OF HIS FRIENDS' AFTA DEM CATCH DEM WIT GUN AND ALSO THREATEN TO SHOOT THE POLICEMEN



Singa Small Doctor don put imsef for wahala afta police arrest him and him friends wit gun and afta dem also threaten to shoot the policemen for road.
Dis drama appun around Oshodi area wen police pipo stop di green SUV wey dem drive.
No be di first time wey Small Doctor don enta police kpalava be dis.
Of resent during him show for Agege stadium, he shoot gun go up base on appiness and di bullet skata and injor four pipo.

Monday, 3 December 2018

NIGERIA SINGA AND RAPPER 'LYNXXX' DON YARN TORi PIPO SAY, NO BE SIN FOR PESIN TO DEY SHACK ALCOHOL



If you dey wonda who dis kain yarns dey come from him mouth,him name na,Chukie Edozien a.k.a 'Lynxxx' di rappa.
Lynxxx na one singa wey be say anywia you siam, he dey always smoke cigar.
Di bobo wey claim say him na born again Christian don yarn say,to dey drink alcohol no be sin at all.
Di Asaba Delta state born rapper and singa say,di first miracle wey Jesus pafom for Bible na wen him turn water to wine make pipo shack for inside one joinbodi groove.
So diafor,him no see wia to shack alcohol don turn sin.

Sunday, 2 December 2018

FORMER PRESIDO 'EBELE JONATHAN' DON TALK SAY MAKE PIPO FORGET DAT YEYE STORY SAY PDP MESS UP FOR 16 YEARS AS HE SAY,HUNGER FOR DON KILL ALL OF US IF NA TRUE


If you dey among pipo wey biliv say PDP mess dis kontri up for 16 years wey dem dey pawa, 'Goodluck Ebele Jonathan' don dey para for una o.
Akordin to di forma presido he say,if dis yarns na true,hunga for don kill all of us for dis kontri.
He even talk say make we kompia di price of bag of rice dat time wey PDP dey pawa wit di price for dis APC piriod.
Uncle Jona say PDP try for dia own time so diafor make oda pipo try do dia own too instead of to dey blame PDP upandan.

Saturday, 1 December 2018

TERRY G THE AKPAKO MASTER,DON YARN TORi PIPO SAY,HIM PIKIN MAMA LOVAM WELWELL BUT SHE NO LIKE HIM SONGS



Di king of Akpako miuzik Terry G,don blast pipo wey dey drink panadol on top why he Neva marry him baby mama.
He say him love di babe and wen fi time rish dem go marry and him no know why pipo no go fit mind dia bizness.
He say even tho him neva marry her,bicos him love her naim make am givam all him bizness dey manage.
Terry G say,two of fem day dey studi wetin marriage mean,no be to jump inside.
Terry say di babe know am inside out,she know Gabriel but she no rili know Terry G.
infact she love Gabriel but she no be fan of Terry G miuzik.
Na she be di nomba one pesin wey dey telam wetin no swit for him songs.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...