MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday, 16 December 2018

RADIO AND SOCIETY BABE 'TOKE MAKINWA' DON TALK SAY,MAKE WE NO DECEIVE OURSELF,LOVE NA OJORO AND BIG SCAM SO DIAFOR,ALL OF US NA SCAMMERS



Radio voice and sosaiti babe Toke Makinwa don yarn tori pipo say,love na big scam.
Base on say na scam,all of us na scammers.
Abeg,make sombodi epp me tell her,me I no dey among di scam gang.
My love na real.

Saturday, 15 December 2018

NAIJA SINGA 'SOUND SULTAN', DON YARN TORi PIPO SAY,NOTHING FOR DIS LIFE GO EVER MAKE AM GROW BIA-BIA FOR FACE




If you dey wonda why di 'solve mathematics' singa Sound Sultan no dey train bia-bia for face,no need to wonda again as di bobo don yarn us say,na God blessam wit baby face.
He say although sha,hair neva grow for him face since dem born am but like say hair dey grow for him face he for no allowram.

Friday, 14 December 2018

THE MINISTER OF LIGHT MATA FOR NAIJA 'BABATUNDE FASHOLA' DON TALK SAY,NO BLAME FEDERA GOFMENT IF YOU NO GET LIGHT INSTEAD,BLAME Di PIPO WEY JONATHAN SELL NEPA TO


Minista of light mata Babatunde Fashola don yarn tori pipo say,di pipo wey forma presido Goodluck Jonathan sell NEPA to naim we sopose to blame for light wahala.
He say since no be federa gofment dey kontro NEPA again,we sopose shift our blame to pipo wey buy NEPA.
He also yarn say, no be say di mata no konsan dem at all,at all again o,but pipo wey sopose carry di main blame na kompinis wey our light mata dey dia hand.

Thursday, 13 December 2018

POLICE FOR GAMBIA DON DEY LOOK FOR DAVIDO AFTA HE SKATA Di LIPS AND USE GLASS CUP BREAK GAMBIA FOTOGRAFA HEAD


Dis Davido go enta prison one day if he kontiniu wit dis him karata of fighting and oppressing pipo.
Davido bin go play show for Gambia last wikend and now Gambia police don declare di guy wanted afta he use strong glass cup skata di lips of dia popular fotografa,Kenny Egbuke.
Di glass also break di fotografa skull.
All Dis one happen afta one babe beg to take foto wit Davido.
Afta sometime Davido para for di geh and pusham comot.
Dis one non make di fotografa dey advice Davido say he neva rish dat level.
Na once David vex use di glass cup wey he dey him hand damage di guy lips.
Many miuzishans around di world dey serve jail terms.
Vybz Kartel from Jamaica dey serve life imprisonment, Six9ine America supastar dey prison dey regret him bad behavior and many others.
Davido beta be kiafu.

Wednesday, 12 December 2018

ONE OGOJA MAN FROM 'CROSS RIVER' WEY DEY STAY 'ELEME,RIVER STATE' DON KILL HIM FOUR CHILDREN,BURN HIM HOUSE DOWN AND ALSO KILL HIMSELF




Bad news no dey sweet for belle but e no get how di world fit take escape am.
One bad news hit Eleme Rivers state afta one man kill him four shidren and later hang imsef die yestaday.
No be only dat one as he also burn him house join.
Dis sad news appun around 1a.m for Alesa kominiti for Eleme.
Di man also nearly kill him wife but di wife eskape as he start to shout make pipo epp her.
Di man na Ogoja man from Cross River state but he dey stay Eleme.
Weda na hunger or frustration naim make am kill imsef and him shidren,na wetin we dey try to find out.

Monday, 10 December 2018

TORi GUY 'AYO JAGUDA' DON TALK SAY,IF ANYTHING HAPPEN TORAM,MAKE DEM HOLD DAVIDO AFTA DAVIDO SAY HE GO SHOW AM SAY JAGUDA GET OGA


Tori bobo 'Ayo Jaguda' don cry give di world say,if anything appu toram,make dem hold Davido afta he threaten am say,if he enta Nigeria he go show say Jaguda get oga.
Ayo offence be say,he blast Daido new music 'Wonder Woman' as nonsense and dis one kon vex Davido.
Ayo say he don alreadi tell him lawyer say Davido say he go givam wahala if he enta Nigeria.

Saturday, 8 December 2018

REEKADO BANKS DON ANNOUCE SAY,HIM DON LEAVE DON JAZZY RECORD KOMPiNi 'MAVIN RECORDS' TO FACE NEW CHALLENGES



New plans,new life,new challenge,na wetin Reekado Banks don tell him fans to expect afta he announce say him don live 'Mavin Records' di miuzik konpini wey dia oga na Don Jazzy.
He write one swit leta to take thank Don Jazzy and other record label mate.
As at wen we enta our tori room,Don Jazzy imsef neva say anytin konsaning dis mata.
Good luck to you Reekado Banks on too ya future waka.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...