MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday, 9 January 2019

WONDAMENT FOR LAGOS AIRPORT AS DEM DON ARREST THE EGUSI WEY ONE MAN DON ARRANGE FOR BAG DEY CARRY GO LONDON



For Lagos airport no be small drama appun as airport authorities don stop one man from make he no carry him egusi follow bodi enta London.
Di man para for dem no be small as he no gree for dem.
If you go Lagos airport,you go see say dem still dey settle di mata.

Tuesday, 8 January 2019

DEM DON ARREST THE EGUSI WEY ONE MAN DON ARRANGE FOR BAG DEY CARRY GO LONDON


For Lagos airport no be small drama appun as airport authorities don stop one man from make he no carry him egusi follow bodi enta London.
Di man para for dem no be small as he no gree for dem.
If you go Lagos airport,you go see say dem still dey settle di mata.

Monday, 7 January 2019

AFTA BURNA BOY WIN FOUR AWARDS FOR THE SOUNDCITY AWARDS,HIM MAMA DON TELL THE WORLD SAY MAKE DEM EXPECT MORE MADNESS FROM HIM PIKIN FOR 2019


For di Sound city MVP Awards wey dem do ova di wikend,one artiste clear almost all di awards.
Yes Burna Boy hardwork and talent finally pay off as di bobo win four awards dat nite.
Him mama naim reprezent Burna.
Infact she steal di show dat night as she say Burna Boy travel out of di kontri.
Wen she climb stage go collect di awards,she thank di organizers say dem do well to rekognaiz him pikin talent.
She say 2019 go stew finish and make we expect more madness from Burna Boy.
Wen your mama stand gidigba for your back,why you no go succeed?
Beta style.

Sunday, 6 January 2019

PASTOR ADEBOYE DON WARN HIM RCCG CHURCH MEMBERS SAY,FROM NOW ON,DEM GO ARREST ANY PESIN WEY DRESS ANYHOW COME REDEMPTION CAMP GROUND


Yoopi and slay queens boys and girls,in case una neva  hear,di General Ovasia of Redeemed Christian Church of God,Daddy G.O Pastor Enoch Adeboye don dey draw him church membas ear say,na high grade kasala dey await anybodi wey dress like mad pesin come di redemption camp church for Lagos/Ibadan expressway.
Pastor Adeboye say from now on,anybodi wey dress anyhow come church,police no go waste time to arrest dat pesin.
E don red o!
Make I sidon for fence dey wait wetin Daddy Freeze go yarn on top dis mata.
He fit no be basket mouth but he get somtin to yarn for tings like dis.
Make I kontiniu to wait like dog wey sidon dey wait for bone.

Friday, 4 January 2019

NIGERIA POLICE DON RECEIVE 242,455 APPLICATIONS FOR 10,000 VACANCIES AFTA OGA BUHARI SAY MAKE DEM EMPLOY MORE POLICE



I bin tink say Naija police dey on a steady insult level as pipo always dey blast dem say,Di police force no get head.
My queshon now be say,who be di 242,455 pipo wey apply for di 10,000 vacant police work if na true say our ekelebes no dey try?
If you dey follow up,you suppose don know say,President Buhari bin approve make gofment rekrut 10,000 policemen make dia work fit dey eazi.
Di way wey di mata be so,e mean say,out of evri 24 pipo wey submit aplicashon,dem go take one pesin.

Wednesday, 2 January 2019

NO BE SMALL CURSE AND INSULT Di BOBO WEY YARN ON TOP TWITA DON RECEIVE AFTA HE TALK SAY,WIZKID BETA PASS FELA



Some pipo say na di wrong igbo wey di boy smoke make am talk say Wizkid sabi sing pass Fela,some say,e be like say dem pour raw ogogoro for di guy soup,some even say di bobo dey look for cheap populariti.
Up till dis morning some pipo still dey yabam but di truth be say some few pipo still soportam sha.
No be small confusion dey boy set on top twita afta he rate Wizkid higher dan Fela.
We as guys wey sidon on top fence dey watch evribodi on top di mata,dey wait wetin Wizkid go yarn las las for dis tori wey dey skata evriwia.

Tuesday, 1 January 2019

BURNA BOY VEX COMOT FOR STAGE AFTA DEM STOPAM NOT TO SPRAY FANS MONEY FOR THE 'ONE LAGOS FIESTA' GBEDU


Anoda drama naim appun for di one Lagos fiesta gbedu last nite as Burna Boy vex comot for stage.
Him vex live stage sake of say radio man Olisa and him gang stopam not to dey spray fans money.
Dis one vex Burna Boy as he waka comot for stage.
If you dey follow up you sopose know say,2018 na Burna Boy year as he bless di industri wit koret koret gbedu for fans to take follow up.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...