MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday, 13 March 2019

VICTOR AD,THE BOBO WEY SING DAT OGBONGE JAM 'WETIN WE GAIN' DON YARN SAY BY DIS TIME LAST YEAR HIM NO GET PASSPORT BUT TODAY HE DEY GO DUBAI LIKE SAY NA BACKYARD


Wen grace of God arrive your life,e no get anytin wey anybodi fit do about am.
Dis na di stori of di bobo wey sing 'Wetin we gain' if we no make money.
Him name na Victor AD.
Last year dis kain time di guy say,him no even get travelling passport not to talk of to dey travel to obodo oyibo but today,him dey go Dubai anyhow like say naim backyard.
Baba we thank God for ya life as I dey beg evri naija pesin make dem kontiniu to pray for grace as one day na one day evriwia go stew.

Sunday, 10 March 2019

FOR PARAGUAY,'LIBERTAD DE PARAGUAY' DON SACK DIA COLOMBIA COACH (LEONEL ALVAREZ) WEY SLEEP WIT HIM PLAYER (EDGAR BENITEZ) WIFE


As women plenti rish,na your player wife kon enta your eye!
Well,if you neva hear,Colombia born coach Leonel Alvarez wey dey coach Libertad de Paraguay of Paraguay don resiv sack leta just like dat afta dem find out say he dey sleep wit him player wife.
Edgar Benitez naim be di player wey di coach dey sama him wife but di wife don dey cry out say na lie say nothing like dat dey appun.
Na wa o,di thickness of dis tori dey give me fever.
Sirios ogberaga tori.

Saturday, 9 March 2019

AKPAKO MASTER AND DADA BOY 'TERRY G' DON YARN SAY,UP TILL TODAY HIM PAPA AND MAMA STILL DEY VEX SAY HE CARRY DADA FOR HEAD


Terry G di bobo wey Naija know as Akpako masta,don yarn tori pipo say,him papa and mama still dey vex foram till today say he carry dada put for head like pineapple flawa.
Dem don buy scissors kip since but di way wey di mata dey go so,e be like say dem neva fit pin Terry G down to take di dada down once and for all.
Terry G parents bin want make di bobo be pastor but a Terry G head no carry am.

Friday, 8 March 2019

DAVIDO DON BOAST SAY HIM DEY SPEND N36 MILLION EVERY WEEK


Omo babolowo imsef Davido don yarn say him dey spend nothing less than $100,000 dollars evri month.
For naija naira dat na about N36 million.
Davido wetin dey wida?
Dangote wey worth billions of naira can't come out come tell us say him dey spend 36 million evri week.
Di only ting wey go make biliv naim if he yarn day na salary for him workas.

Tuesday, 5 March 2019

GOOD NEWS AS NIGERIA DON OVERTAKE EGYPT AS AFRICA NUMBER 1 RICE PRODUCER


Akordin to di Direktor-General,Africa Rice Center,Benin Republic,Dr Harold Roy-Macauley,Nigeria don ovatake Egypt as Africa nomba 1 rice producer wit 4 million tones a year.
Egypt bin dey produce 4.3 million a year but e reduce wit ova 40% afta Egypt gofment limit dia rice cultivation so dat dem go fit save water resources.
No be lie dis one be at all as na so so local and home rice without stones naim full our market but di only ting be say e neva rili cheap to buy.
To show say dis our overtakement no be scam,make dem try comot small money on top di price of rice.
E go make sense.

Monday, 4 March 2019

PASTOR ADEBOYE DON YARN HIM RCCG CHURCH MEMBERS SAY,E GET ONE MORNING WEY HIM AND GOD DRINK TEA TOGEDA


The Redeemed Christian Church of God GO Pastor Enoch Adeboye,don yarn say,e get one morning wey him say make him drink tea,bifor he say make he start to shack di tea,God just appear from heaven and join am.
He say na two of dem kon drink di tea togeda laslas.
Hmmm,make I no yarn anytin.
Make I just kwayet.
Make me sef go find tea drink too,anytin can appun.

Sunday, 3 March 2019

TOP COMEDIAN 'ALI BABA' DON YARN SAY,FROM NOW ON,NA THUNDER GO FIRE ANYBODi WEY THIEF NIGERIA MONEY AGAIN


Ali Baba don dey swear for naija politicians say thunder naim go fire any of dem wey thief our money from now on.
Afta di comedian post thunder wey skata tree on top him Instagram page,he kon yarn say na dat kain thunder naim go fire any politician wey go chop govment money again.
But Ali Baba,dis politicians dey contract you to do MC work for dem.
What if na stolen money dem take dey hire you since?

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...