MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday, 25 March 2019

NAIJA SINGA 'WAJE' DON CRY OUT SAY,MUSIC DON MAKE HER BROKE AND SHE NO GET MONEY TO PUT FOR HER MUSIC BIZNESS AGAIN



Waje, di auntie wey sing 'Do me,Do me' for Psquare song dat year,don cry out say,miuzik don finish all her money.
She say she don broke on top miuzik mata and she no get money to dey push her miuzik bizness again.
For inside the video wey dem don dey play for evriwia she say,her daughter school fees alone dey givam headache so diafor,make miuzik dey one corner.
Watch di video for bottom hia...


Sunday, 24 March 2019

PATIENCE OZOKWOR a.k.a 'MAMA G' DON YARN TORi PIPO SAY,E STILL DEY PAIN AM SAY HER FAMILY NO ALLOW HER MARRY Di MAN OF HER CHOICE WEN SHE YOUNG


If you dey follow up,you sopose know di no nonsense Mama G of nollywood base on di way she dey show pipo pepper for all her films.
Mama G wey her real name na Patience Ozokwor don yarn tori pipo say,she still dey bitter say dem no allow her marry di bobo wey she plan to marry wen she still dey young.
She say in those days na arranged marriage dey reign welwell as most times na ya famili dey choose who you go marry for you.

Friday, 22 March 2019

DAVIDO DON YARN SAY,ONE DAY HIM GO TRY HIM ACTING SKILLS FOR INSIDE NOLLYWOOD AND NA JAGUDA ROLE HIM GO LIKE TO DEY ACT


Supastar Davido don yarn tori pipo him dey nollywood wit corner eye.
He say him get mind to enta film acting one day but sha him no say na bigina for dat kind mata.
He say if he finally get di chance,him go like to dey act jaguda part.

Tuesday, 19 March 2019

MAKOSSA MUSICIAN 'KOFFI OLOMIDE' FROM CONGO DON RECEIVE 2 YEARS PRISON SENTENCE AFTA HE RAPE 15 YEARS OLD GIRL


One of di most popular voice for Makossa miuzik 'Kofi Olomide' don  enta wahala afta court find am guilty onto say he rape 15 years old girl.
Dem givam two years suspended jail sentence for France and dis one mean say,dem no go waste time to arrestam if he enta any kind of wahala again.
Koffi Olomide wey be graduate of matimatics, get many of kerewa case wey dey hang for him head.
Even di girls wey dey dance and sing foram don bin confess say di man dey force dem sleep wit dem.

Monday, 18 March 2019

GOVMENT DON GIVE PROMOTION TO THE CUSTOM MAN WEY REJECT OVER N150 MILLION BRIBE FROM Di MAN WEY WAN SMUGGLE 41 CONTAINERS OF TRAMADOL ENTA NAIJA


As pipo wey bad plenti rish for naija,me and some few good ones still dey.
Di custom man from di Apapa area command Lagos,wey reject $420,000 bribe,don get promotion from gofment.
$420,000 for Nigeria naira na ova 150 millions.
Di bribe come from pipo wey bin won shift 41 containers of tramadol enta naija but dis man stand gidigba say no way! I can't allow una pass.
Many pipo don dey vex for di man say him for collect di money bicos di money too handsome.
Some say di money wey dem go add join him salary fit no pass 50k.
If na me be di man I for rejectam too.
I know say una no go won biliv.

Saturday, 16 March 2019

VICE PRESIDO AND PRESIDENT BUHARI SECOND IN COMMAND 'YEMI OSINBAJO' DON YARN TORi PIPO SAY,OGA BUHARI DON POOR PASS Di WAY WEY HE POOR BEFORE FOR 2015


Vice presido Yemi Osinbajo don yarn tori pipo say, President Buhari poorness level don pass church rat own.
He yarn dis one during di joinbodi groove wey him arrange wit pipo wey carry 'vote for APC campaign' for head during di elections wey just finish.
Akordin to Osinbajo he say,Buhari don poor pass di way wey him poor for 2015 wen he turn president.
Na wa for politishans sef!
Weda you dey support APC or PDP,all of us know how Oga Buhari look like di first time wen he enta Aso Rock.
Even I Go Dye neck dey learn for wia him neck dey.
Fast forward to today,di man don fresh like fresh bons wey dem just fry finish.
So Mr Osinbajo we nor undastand you at all,
Abi yarns don finish for ya mouth like comedian wey dey start work new?

Friday, 15 March 2019

FOR EKITI STATE,GOVNOR FAYEMI DON SIGN THE LAW WEY GO MAKE DEM PUT ANYBODY WEY THIEF NEPA PROPATiS FOR PRISON FOR TWO YEARS


If you be jankoliko and you speshalise to dey tiff NEPA equipment and propatis,my broda,na inside prison for two years dem go throw you put.
Akordin to Ekiti state gofnor Kayode Fayemi wey just sign dis law for di state,if dem gbab you for di state dey tiff NEPA wire,na inside prison you and moskitos go dey romance una sef.
Na di message wey di gofnor say make I yarn una be dis.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...