MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday, 13 May 2014

ExCLUSIVE:BLACKFACE DON DENY SAY HIM NO SIGN ANY N52Million CONTRACT.




Na since septemba 2013 naim dis rumor dey fly like kite for Naija say Blackface sain N52Million kontrat wit Franchise Events Limited.Amebo pipo even carri di tori For many many newspaypa and many site say dem dasham car and house.But for one Radio show wey we listin to for Lagos for wikend,Blackface don come out say di rumor na di handiwork of him enemies so dat pipo no go rememba to do gud foram.
Na only pesin wey dey mad and wey him head no korret go dash DANGOTE moni.if pipo hear say Blackface get 52 million naira, anybodi wey won hepam go gree hepam again?so na dis one naim make di guy dey shout say "Enemies make una leave mi alone ooo!"
Akkordin to Blackface for di intaviu wit SUGARSUGAR of inspiration fm on satoday may 11th 2014,Him say hin neva sain any kontrat as him dey free rite now.
Di bobo even tok say him and 2Baba na stil veri gud frends.inshot dia frendship don tait pass bifor even tho dem bin get smol gbege wit diasef.
Blackface even use oportuniti to beg him fans dem say make dem no vex foram say hin no reliz any miusik since to coolu dia bodi.Now him don come bak with new music wey him col "ABi PALE".

Monday, 12 May 2014

BREAKING NEWS : CHAi!!!! BOKO HARAM DON USE BY FORCE TURN THE CHIBOK SKUL GEHS TO MOSLEM, THEM COME RELIZ VIDIO AND FOTO OF THE GEHS




Boko Haram don reliz 27 minutes vidio of ova 130 CHIBOK skul gehs wey dem carry wit force from dia skul  make di world for sunshi di way dem don take ton dem to moslems. BOKO HARAM come force all di gehs wear hijabs. Dem don even dey tish de gehs dem how to tok and sing SURATUL FATIHA for islam. Most of dis gehs dem na kristians and dis one go add plenti dip shock to di one wey dis gehs dem papa and mama don alreadi get for dia bodi.
U FIT WASH DI VIDEO HERE


BOKO HARAM lida ABUBAKAR SHEKAU come tok say him go reliz di gehs dem if federa gofment reliz dia own fightas wey dem arrest put for prison. No bodi know wia dis gehs dem dey. Some pipo say na SAMBISA forest dem hide dem put why some say e be like say dem don scata dem inside differen bush.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...