MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday, 22 April 2016

WETIN BE DIS! DIS RIHANNA BABE AND DIS HER MOSKITO NET GOWN GO SHOCK YOU


To bikom supastar don turn curse o.
Rihanna wey her latest jam 'work' don turn di world upside down,don wear anoda one again.
She wear dis moskito net dress wen she dey shoot di vidio for her new song 'needed me' and her bobbi dey show.
Food don don for pipo wey dey mad for her mata as dia head go enta more knocking mode.
Pipo like Chris Brown and Drake nor be me.
But....di babe fine sha.

CONGi NA BASTARD AS COURT DON SENTENCE 70 YEARS OLD MAN TO PRISON FOR 7 YEARS BICOS HE RAPE TWO SCHOOL SHIDREN


Wetin konji dey cause for dis world mehn,na only God go save us.
Imagine,one 70years old man for Osun state wey congi nor allow rest as he rape two skul pikin of 13 and 14 years.
Dis man even get title for him vilage as di Loja,Araromi Otokobo but who say kongi nor fit hol' chief too?
Anyway,di man Chief Moses Adeniyi,carry di student wey dey trek go house afta dem close from school wit hin car,straight to di hotel were he lodge.
Afta he torchlight di gehs dem website for di hotel,he kon use one piece of klot take klin dem up and warn dem say dem go die if dem tell anybodi.
Wetin make di tin easy be say,Chief Adeniyi know d gehs dem bifor as na dia forma neighbours.
How di sikrit kon take come out be say,sombodi do amebor to one of di gehs mama say dem see one man wey carry her pikin for inside car.
Forward match,na di mama go skul go find out who carry dem wit car.
Fear nor let di gehs konfess since di chief tell dem say dem go die if dem yarn.
But afta dia tishas gidem mind say notin go appun to dem,Dem kon finalli konfess.
Afta all dis drama,lawya and judge,Kudirat Akano for Osun state high court,sentence Chief Moses Adebiyi to seven years for prison.
Dis na veri good judgement as na bad example di man set.

Thursday, 21 April 2016

AS E SHOW FOR DIS PISHOR,YUNG6iX AND WIZKID DON TURN BIG SHIDREN


Play play play o,see dis shidren don big finish o.
Yung6ix post on top een Instagram pishor wey him and Wizkid take da' year wen dem sing dat jamming jamming wey dem call 'folow me'.
He also post anoda one wey dem snap of resent togeda wit di old one so dat u fit see wia dem dey come from.
Time dey fly sha.

DANGER! TONTO DIKEH SAY SHE DEY IN LOVE WIT HER HOSBAND DANGEROUSLi AND SHE LOVAM TO PIECES



Love na biutiful tin as dem talk am espeshali wen woman diskova di man bodi wey God take rib from  take krate her.
Sugar rush babe Tonto Dikeh,don diskova say,she love her rib and her hosband,Churchill to pieces.
She say she dey in love wit her hosband dangerosli and she yarn all dis one on top her instagram page.
E be like say hustling don carry di guy man comot for town as Tonto Dikeh say she dey miss her kingkong die.
Tonto and Churchill welkom one bounsing baby boy for febuari togeda.
Wetin won swit pass marage wey beta love dey?
Many kat and rat marage boku for town.
Make devil nor go let pesin marry wrong pesin for hause.
Dat kain tin worse pass poison.

MY WRISTWATCH DEY SHOW ME TIME FOR FOUR DIFFERENT KONTRiS - SOUND SULTAN



By di time wey u don dey hep pipo check time for oda kontris,naim be say you don dey kip up wit di kardashians be dat.
U tai wristwatch for naija and u dey find out wetin time dey talk for New York,u can call dat oturugbekeism.
Anyway sha,Oga matimatiks,Sound Sultan say make I tell una say he don buy one wristwatch wey fit telam wetin time dey talk for four diferen kontris di same time.
He show us di gborlorpia wristwatch on top Instagram.
Maybe he dey monitor een bizness dem for yonda.

Wednesday, 20 April 2016

HMM,PDP DON DEY RE-PACKAGE DIA HOUSE AGAINST 2019 AS DEM DON CLOSE DOWN DIA TWITA


Dat party wey rule naija for gud 16years witout any success stori bifor di same karata parti APC take ova,don dey do evritin posibo to get dia groove back by 2019.
Dem don start wit dia twita account as dem don klozam down bicos pipo dey use di account for dia pasona bad bizness.


Akordin to di woman wey dey in charge of to let pipo know about PDP market or wetin oyibo dey call publisiti,Chinwe Nnorom,she say any tori wey come out for dia now,nor reprezent PDP as dem go open new account wey go carry di party betament for head.
Na tuesday nite dem write dia last tori on top dis account.
Siam for botom hia....


BABES, LINDA IKEJI SAY HER IKEBE BAD PASS UNA OWN


Tori babe,Linda Ikeji cut rope some days ago just to pepper di boys dem eye.
She wear one 'wicked white lace shoulda bebe dress' to take oppress pipo like Wizkid wey she bin get wahala wit.
She use joke take also tell babes thru her pishor say her yansh bad pass dia own.
Babe,una don siam o,Linda yansh make sense pass yor own?



LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...