Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Saturday, 10 September 2016
LIL KESH SAY,ANYTIME WEN HE ASK FOR ALCOHOL FOR INSIDE PLANE,DEM GO DEY ASKAM HIN AGE AND NOW HE DEY ASK HIM FANS WEDA HIM STILL LOOK LIKE PIKIN?
First of all I blame di plane ownas for giving pasanger alcohol for inside plane.
Wot if di pasenga go folow di pilot dey drag for sky say hin won sidon for di pilot sit?
Anyway,Olamide product Lil Kesh don yarn say,anytime wen he tell flight attendants make dem serve am alcohol,na so dem go dey askam how many years him be?
He say dem go say make he show dem een passport make dem check him age.
Now di bobo don dey ask on top twita say,abi him still look like small pikin?
Dis lil Kesh sef!
U call yorsef little and you stil dey ask weda you be pikin.
First of all check di meaning of your name bifor we go ansa dat queshon.
Friday, 9 September 2016
COMEDIAN AY SAY,PIPO SAY HIM JOKES NOR FUNNY,MEANWHY ALL HIM SHOWS DEY FULL TROWAY AND YET HIM FIRST FILM DON PUT HIM NAME FOR GUINESS BOOK OF RECORDS
Ayo Makun a.k.a Ay,don blast pipo wey nor dey givam di respet wey him dizav for di comedy industri.
Di Delta state univasiti graduate say,dem say hin jokes dey dry and yet anytime wen he arrange any show,di hall dey full skata.
As if dat one nor dey enof,Ay say him first film wen he arrange,30 days in Atlanta,don enta Guiness book of records as di highest selling movie.
I nor know about una,but anytime I watch Ay show and him jokes,na so so laff I dey laff.
Just like e hard to see fine arm robber,maybe comedians nor sopose to dey too handsome.
Ay why u sef go dey handsome?
Next time rob charcoal for face bifor you climb stage weda dis pipo go see true yarn if na only for day sef.
How pesin won funny pass again?
Thursday, 8 September 2016
MUSIC STAR,TIMI DAKOLO SAY,THINKING OF HIM SHIDREN SCHOOL FEES, DON DEY MAKE AM GET WHITE HAIR FOR HEAD
To take kia of yorsef alone nor easy not to talk of shidren but for di life wey we dey live,you nor fit run fromam.
Wen shidren won go back to school afta dia holiday,na dat time many papa head to swell up.
Miuzik star,Timi Dakolo,leg don dey shake like who get malaria as he yarn say,school fees time don rish again for him shidren.
For di kakulayshon wey di bobo do for inside dat paper wey u dey see so,e be like say one of di pikin school fees na 300k.
Timi say na half cold coke him take dey digest di tinking wey di school fees kpalava don put am.
Nor worry Timi,God wey giv di shidren don alreadi provide for u to arrange dia mata.
Wednesday, 7 September 2016
TOMPOLO PAPA DON DIE AT Di AGE OF 84
Di most wanted man right now for naija,Tompolo papa don die.
Thomas Ekpemupolo die for di age of 84 dis morning for Lily Clinic for Deco road,Warri.
Weda na old age death he die or na di beat wey dem say sojas givam wen dem dey look for hin pikin,na wetin we stil dey find out be dat.
Federa gofment dey find Tompolo ova 13 billion naira but di guy don run hide since last year.
Thomas Ekpemupolo naim be di Tunteriwei of Gbaramatu.
May his soul rest in peace.
YOUR NOSE BE LIKE 'W'...REEKADO BANKS REPLY Di BOY WEY CURSE HIN ALBUM
Nor be small tin.
Some pipo go just go twita and Instagram dey go insult stars.
One bobo bodi don calm now since Reekado Banks reply am afta he curse di bobo.
He tell Reekado say hin album wey he just reliz dey top five most yeye album dis year.
He say Reekado album dey 'WACK'.
Di Don Jazzy boy nor waste time to reply am as he tell di boy say,"him nose be like di ''W'' wey start 'WACK'.
Who win na?
Next time he go tink bifor he curse.
BREAKING NEWS: ARM ROBBERS BREAK ENTA SUPERSTAR COMEDIAN BASKETMOUTH HOUSE AND DEM THIEF IMPORTANT THINGS FROM AM INCLUDING CCTV CAMERA
As you dey go sleep for nite,some pipo dey wey dey plan to go rob.
Dis life!
Na dis kain pipo brake enta big comedian Basketmouth house for Lekki early dis morning and dem robam of veri impotant tins including him CCTV camera.
All dis one appun dis morning from about 2am to 4am earli dis morning in front of him wife and two shidren.
Na felow comedian and Basketmouth frend,Bovi,naim break di news for Instagram.
Basketmouth Don alreadi go police station go report about dis kpalava.
Tuesday, 6 September 2016
NOLLYWOOD ACTRESS FADEKEMI MOMOH DON TALK SAY,NOR BE SIN WEN PESIN WEAR NOSE EARRINGS GO CHURCH
Nollywood actress Fadekemi Mommoh don yarn say,if pesin wear nose earrings go church,nor be sin at all.
She dey reply her fans wey comment on top her pishor wey she post.
Some of her fans bin tell her say,e for beta make she stop to wear earrings for nose.
If not for anytin,dem say make she nor dey wear ram enta church but she kon reply dem say,to wear nose earrings nor be hin be di koko but our mind,our goodness and our love to our neighbors naim mata.
Fadekemi see nose earrings as somtin wey dey add more fineness to her biuti and she say e don tay wey she dey wear ram,nor be today sontin.
Subscribe to:
Posts (Atom)
