Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Monday, 31 October 2016
3 MONTHS AFTA HE LIVE MADE MEN MUSIC GROUP(MMMG), IYANYA DON JOIN DON JAZZY MUSIC COMPANY,MAVIN RECORDS
Just wen we tink say we neva hear of Don Jazzy for sometime now,di bobo don announce one ogbonge news as he take concern hin konpini,Mavins record.
He announce on top twita say Iyanya di forma co-owner of MMMG wit Franklin Ubi,don join Mavins record.
Wit dis one,Iyanya don join up wit Tiwa Savage,Korede Bello,Reekado Banks,D'Prince,Dr Sid,Dija as fellow workas for di konpini.
Sunday, 30 October 2016
OBA OF BENIN DON BAN EVRiBODi FROM DOING BURIAL FOR BENIN KINGDOM UNTIL JANUARY 2017 SAKE OF SAY DEM NEVA FINISH Di SACRIFICE WEY MAKE AM Di NEW OBA
Na wa o.
Dis kain Africa backwardness nor be here o.
Oba of Benin don place 'no burial serimoni' ban for Benin kingdom until January 2017 pending wen dem finish di sacrifice wey make am di new oba.
Who go pay di mortuary money of pipo wey go die inside dis piriod?
E nor get how you we do am reach,at list one pesin must die for dat kingdom bifor decemba.
All dis kain tins naim dey give Benin bad name.
Wen I say I won go back to America now una go bigin say I don start again.
For yonda I nor dey hia some kain funny tori.
No more excuse,I dey vex go dust my passport.
Saturday, 29 October 2016
AFTA OLAMIDE MISBEHAVE FOR LAST HEADIES AWARDS,AYO ANIMASHAUN DON DEY WARN B4 2016 AWARDS SAY,MAKE EVRIBODi KEEP DiA TROUBLE FOR HOUSE IF NOT,DEM GO SEE PEPPER
| Olamide and Animashaun |
Reekado Banks win di best new artiste and brand new car but wen Olamide go stage,he start to curse mama of di oganaizas of di awards.
He say na him boy,Lil Kesh sopose win di award and wen Don Jazzy come stage,he say if na di car dey hungry Olamide make he come carry di car.
Ahead of di 2016 award,di oganaiza,Ayo Animashaun,don dey warn evribodi say,if you love yorsef make you kip yor trouble for yor house bifor you near di veniu.
If you rememba afta dat kasala,Davido yarn on top twita say if hin boy Mayorkun nor win dis year award,him go skata evriwia.
I hope say him don hia about dis warning.
Friday, 28 October 2016
CHOi! SEE AS DEM WELCOME DAVIDO LIKE KING FOR CAMEROON (Video)
Na wa o.
Naija miuzik don go far o.
No Cameroon miuzishan wey hin miuzik dey reign right now for naija but our miuzishans dey reign skata for evriwia.
Davido go Cameroon and dem arrange table foram so dat he go folow tori pipo do small joinbodi talk bifor one show.
Guy,di welcome package alone be like say Davido na president.
Oya watch di vidio for botom hia...
ONE OYIBO BABE DON YARN SAY,SHE NOR KNOW SAY GHANA NA NAME OF COUNTRY AFTER SUPASTAR AMERICA RAPPER,WIZ KHALIFA TALK SAY HIM DEY GO GHANA VERY SOON
If u come from Ghana rite now,I know say dis tori go vex u welwell bicos one obodo oyibo babe nor know wetin Ghana mean.
She nor know say na kontri name.
Afta supastar miuzishan and rappa Wiz Khalifa yarn on top twita say,he cannot wait to go Ghana,naim one of hin fan,reply am say,although she nor know wetin Ghana mean but if na babe Ghana mean,naim be say di babe dey lucky to be frend to big name,Wiz Khalifa.
Dat one na olodo woman.
Thursday, 27 October 2016
AKORDIN TO TORi WEY DEY REACH US FROM SPAIN,SUPER EAGLES ODION IGHALO,FIT SPEND 2 YEARS FOR PRISON UNDA DiA LAW IF DEM FIND OUT SAY HE BRIBE TO GET DRIVERS LICENSE
Super Eagles and Watford striker,Odion Jude Ighalo,wey just bury him papa some weeks ago,don enta drivers license kasala for Spain as di provincial district attorney for Granada don dey beg court make dem jail Odion Ighalo plus hin forma team mate,Diego Buonanotte and 93 oda pipo bicos of say dem bribe to get drivers license wey dem do.
Akordin to di investigate,dem say dem bribe and hire pipo to write di driving test exam for dem.
You know say for obodo oyibo dem nor dey look face,small tin like dis dem don put u for prison.
I hope say Ighalo nor chook hand for dis magomago to avoid storis dat touch.
Akordin to di investigate,dem say dem bribe and hire pipo to write di driving test exam for dem.
You know say for obodo oyibo dem nor dey look face,small tin like dis dem don put u for prison.
I hope say Ighalo nor chook hand for dis magomago to avoid storis dat touch.
Wednesday, 26 October 2016
DAVIDO NA COMPLETE YEYE PESIN..NA SO NAIJA DANCE QUEEN KAFFY TALK AS SHE DON PARA FOR DAVIDO BICOS Di BOBO NOR ALLOW DANCERS DANCE FORAM FOR STAGE AFTA HE DON ARRANGE WIT DEM
Naija dance queen Kaffy,don blast Davido and call am morafoka as di bobo nor show dancers respect for di 3thrones concert wey appun for Lagos on Sunday.
Akordin to Kaffy,Davido cancel kontract wit dansas wey don practice for ova two weeks bicos of di show.
Her annoyance be say,Davido for don talk say he nor want dem bifor dat day instead make he stop dem for di veniu of di show.
She finish Davido for ground and also warn oda miuzishans wey nor dey respect dansas sweat.
She yarn plenti tins wey nor go swit Davido for ear.
Oya Watch di rest for dis vidio...
Subscribe to:
Posts (Atom)
