MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday, 3 December 2016

FORMA KENNIS MUSIC ARTISTE,JAYWON,DEY VEX AS HE SAY,INSTEAD OF KENNIS MUSIC TO DEY SHOOT VIDEO FORAM AS DIA ARTISTE,NAIM KON DEY PAY TO DO VIDEO FOR IMSEF


Forma Kennis miuzik artiste,Jaywon,don tell tori pipo say,as dem epp him karia,na so some kain tins wey Dem do toram make am vex.
Akordin to Jaywon,he say,can you imagine?
some of him vidios wey u dey watch for tv,naim use hin own money shoot dose vidio so diafor,make u nor tink say na Kennis miuzik do evritin foram.
Hey!
O boy!
Dis na beta sikrit o.

Friday, 2 December 2016

BAD MARKET FOR EDO STATE AS GOFMENT DON SACK 12 AUCHI POLYTHECNIC LECTURERS BICOS DEM NOR DEY USE EYE SEE GIRLS WAIST


Federa gofment don vex sack 12 lecturers for Auchi politeknic for Edo state and di reason na bicos dem too do.
Dem nor dey use eye see gehs waist.
Instead of dem to tish student,na to attack girls pant from left,right,senta naim dem sabi and na dis one make gofment giv dem sack letters.
Pesin wey announce dis sack for Kaduna na di exekutiv seketri of Nashona Board for teknika studies,Dr Masa'udu Adamu-Kazuare and he say di minista of education wey be Mallam Adamu Adamu, put stamp on top dis sack.
Dem also reduce di position and rank of 15 other lecturers wey dey guilty for dis mata.

Thursday, 1 December 2016

DiS BOY DEY ON FIRE AS ENGLAND FOOTBALL ASSOCIATION AND DiA FANS DON CHOOSE VICTOR MOSES OF CHELSEA AS Di PREMIER LEAGUE PLAYER OF Di MONTH OF NOVEMBA


Wen yor time don rish,you yorsef nor fit stop yorsef from shining.
Three years afta Chelsea always dey loan am to clubs like Liverpool,Stoke City,Westham, dia new coach Antonio Conte say no way!Moses must stay dis time around.
Victor Moses true true nor fall di coached hand as he don epp Chelsea win plenti match and dey top of di table.
Bifor u go say,sidon look na dog name,di football association of England and di fans don vote Victor Moses as di premier league playa of di month of Novemba.
Out of di ova 40,000 votes,Moses get 18,756 why Swansea Sidgurdsson carry second position wit 7,791,third position na Watford Nordin Arabat why anoda Victor,our own Victor Anichebe take nomba four position as di bobo sef  dey form.
Congratulabia Victor Moses from Ogakpatakpata.

Wednesday, 30 November 2016

PRESIDENT BARACK OBAMA OF AMERICA DON TELL PiPO WEY DEY BEG HIM WIFE MICHELLE,TO CONTEST TO BE DiA PRESIDENT SAY,NO WAY! HIM NOR GO LET HER TINK DAT KAiN THING


AMERICA presido,Barrack Obama,don tell any pesin wey dey push hin wife to bikom president of dia kontri in di future,make dem forget dat kain tinking bicos,him nor go allow her.
Obama tell Rolling Stone Magazine dis one afta Donald Trump win Hilary Clinton for di elections of pesin wey go replace him imsef as America president for January 2017.
Nor dey soprise tomorow to see him wife Michelle dey campaign to be America president one day bicos politishans sabi change mouth.
Michelle Obama wey be lawyer,go pack all her load and follow her hosband comot for White House bifor Donald Trump go take ova.

NOLLYWOOD ACTOR,OSITA IHEME a.k.a PAWPAW,POSE WIT HIM DOG YESTADAY AND TWO OF DEM NA ALMOST Di SAME HEIGHT


Small,short but mighty,Osita Iheme a.k.a pawpaw,pose wit him dog and postam for us to see.
Di one tin wey soprise pipo be say,him and di dog na almost di same height as na small tin pawpaw take tall pass di dog.
IF di dog see beta food dey wack,who knows,bifor krismas e fit don tall pass di owna.
But di truth be say,nor let yor height,color,language decide who u go be for future.
Enta street,hussle and make yor money like pawpaw.
Pipo go worship you,kings go rekognaiz you,presidents go chop for di same table wit you.
Pawpaw Wit Him Police Escort

Tuesday, 29 November 2016

GODDESS OF X AND NAiJA BAD GIRL MAHEEDA SAY,SHE DEY BOW AND WONDA FOR Di KAiN BEAUTY AND FINEness WEY HER DAUGHTER CARRY COME DIS WORLD



Giv Maheeda any bad name wey you like no wahala but you nor fit call her daughta worwor girl.
Akordin to Maheeda on top Instagram,she say her daughta fineness dey soprise her too.
Oboy,if you nor gree say di babe fine die,naim be say,its aida yor eye glass na fake or yor eyeballs need propa servicing.
Dis kain babe naim dem dey fight for.

SEE Di WHITE GUY WEY SPEAK PIDGIN PASS ALL WARRI BOYS


Warri boys nor rish!
Na only GOD know how many years dis white man wey dey speak pidgin inglish like mad don stay Naija.
Somtin dey tell me say,dis guy go don scam dem Yakubu Gowon in dose days wit dis pidgin langua.
For di vidio,wen di guy say "nor mind dem,dem be Yeye pipo, i shout!
As u dey watch di guy yarnings,u go even dey pray make di vidio nor end.
Di guy finish work nor be small.

Watch di vidio for yasef for bottom hia...
no long tori.


LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...