Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Sunday, 1 January 2017
JUST LIKE BISHOP OYEDEPO WEY SAY NA GOD SAY MAKE HE INKRiZ SCHOOL FEES,OLAMIDE PRODUCER,YOUNG JOHN DON ALSO YARN SAY NA GOD NICKNAME AM 'WICKED PRODUCER'
Udomboso John Saviour a.k.a Young John di 'Wicked Producer', don yarn tori pipo say him nickname wicked producer come from God.
He say e nor get wen him sidon tink about di name or sidon write di name down.
He say di name just come on hin own and na so God take dey do him work.
Young John if u dey follow up,na him be one of Olamide main producer and naim produce all those wicked wicked Olamide songs like Bobo,Story for the gods and Kiss Daniel 'Mama'.
Di Akwa ibom state born producer say him also hope to work wit 2face and Wizkid one day.
Saturday, 31 December 2016
YEMI ALADE STORY DEY CHANGE EVRiDAY AS Di ORGANIZERS OF Di WORLD BIGGEST MUSICAL AWARDS, 'GRAMMY', DON INVITE HER TO Di 2017 GRAMMY AWARDS FOR AMERICA
Di Grammy Awards go appun on di 12 of February for Los Angeles,America and one pesin wey we nor soprise say dem giv invitation to attend di awards na Yemi Alade bicos of wetin di oyoyo babe don achieve since 2015 kon rish today.
For dem to recognaiz her all di way from Yankee,naim be say she get wetin she dey do right and dis one go surely make di rest miuzishans put in plenti hard work.
Beta pikin,na yor time but nor allow success turn yor head upside down.
More fire.
Friday, 30 December 2016
WEN POVERTY CATCH GOVMENT AND PIPO Di SAME TIME,DEM DEY CALL AM RECESSION BUT 'SEKEM' SINGA, 'MC GALAXY' DON YARN SAY HIM GET PLENT MONEY PASS RECESSION
Sekem singa,Mc Galaxy don yarn say,if recession like make e hold evribodi for did KONTRi,nor be bicos of am.
He say him money long pass third mainland bridge so diafor povati nor reach wia him dey.
He show tori pipo vidio of plentiful money and he say,nor be bicos ofam recession build manshon for Nigeria.
Watch Mc Galaxy yarnings for bottom hia...
Thursday, 29 December 2016
DOG CHOP DOG AS POLICE DON ARRREST 21 POLICE ESCORT WEY DEM ATTACH TO GOVNOR WIKE OF RIVERS BICOS DEM SHOOT DEY WASTE BULLETS DURING ELECTION
If u tink say dog nor dey chop dog,tink again as police don arrest 21 police escort wey dem attach to govnor wike of River state afta dem dey shoot and waste bullet anyhow during di elections wey dem do for di state some weeks ago.
Dem din carry di 21 police go Abuja to go ansa dia case file.
Na wa o.
For dis recession una dey waste bullets anyhow.
Wot if di bullets go touch innocent pesin?
Nor be wahala be dat?
We need to dey reason wit our head sometimes.
Wednesday, 28 December 2016
KING OF AFRO JUJU MUSIC,SHINA PETERS JUNIOR BRODA,YOMI PETERS,SAY Di REASON WHY HE PACK HIM LOAD GO AMERICA GO STAY NA BICOS SHINA PETERS CALL AM ARM-ROBBER
Di king of Afro juju miuzik,Shina Peters broda,Yomi Peters,don tell tori pipo say,di reason why he relocate to America,na bicos Shina Peters call am Arm-robbers bicos of dia papa propatis.
Akordin to Yomi wey also be miuzishan,he say,America embassy nearly NOR givam visa to travel bicos of di mata.
But out of pity dem later givam köret Visa wey fit make am stay America for long.
Yomi also yarn say di tin sirios so tay na only once him and Shina Peters don talk for four years.
Dis one sirios o!
We hope say dem go try settle diasef.
Tuesday, 27 December 2016
ARM-ROBBERS DON ROB PLENTi PIPO AND SUPASTAR KISS DANIEL FOR 'CALABAR CHRISTMAS VILLAGE' AND E HAPPEN WEN HE DEY SING FOR STAGE
As u dey plan to enjoy di holiday na so some pipo dey plan to to tiff.
Nor be today arm robbers don dey but trust naija pipo dem go putam for recession head.
How norma human beings go carry gun,carry weapons say na arm robber work naim dem won to dey do?
Imagine as pipo dey selibrate holiday and Jesus birthday for Calabar Christmas Village,arm robbers enta dia go attack pipo and kolet dia propatis and money.
One of Naija biggest artiste for dis 2016,Kiss Daniel,dey stage dey sing dat time as Dem robam also.
Dem pull hin clothes from hin bodi.
Na wa o.
So Dem go kon wear di clothes dey waka afta?
Arm robbers and dia karata sef.
Monday, 26 December 2016
MANY FANS NOR GO LIKE DIS ONE AS OGA DEM FOR 'MAN U' DEY PLAN TO INKRiZ MOURINHO CONTRACT TO 10 YEARS UPON SAY DEM DEY PLAY LIKE PRIMARY SCHOOL SHIDREN RIGHT NOW
If u dey find club wey dey play primary school football right now,na Manchester United.
Dia coach,Jose Mourinho dey lost why he players nor dey deliver even on top say,he spend plentibmoney take buy players.
For di past five match dem don improve small but many Man U fans nor dey hapi wit Mourinho and him boys.
Wetin go vex some of di fans pass now be say,di OGA dem for di club dey plan to inkriz Mourinho contract to 10 years sake of say dem don tire to dey sack coach afta one or two years.
Well,na Mourinho wey dey yarn about so.
Dat guy can do magic wen u nor xpet.
Make we Sidon dey look wetin di OGA dem go do.
Subscribe to:
Posts (Atom)



