Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Tuesday, 31 January 2017
PROFESOR AKINDELE DON CALL 2FACE 'BLOODY ILITERATE' AND BAD EXAMPLE BICOS HE GIVE PLENTi GIRLS BELLE AND NOW HE DEY PLAN TO PROTEST AGAINST BUHARI GOVMENT
2face don dey resiv insult from some few pipo sake of say he call pipo make dem join am to protest against dis Buhari gofment as he say pipo dey suffer.
One professor of bookuru mata Professor Akindele Adetoye,don blast 2face for Facebook say,he nor fit manage imsef as he giv many girls belle without using condom.
And now di same pesin wey nor fit manage imsef won protest against gofment say dem nor fit manage di kontri well.
Charity as dem talk am dey start from home and akordin to di professor,make 2face go start to manage imsef from home bifor he carry enta street.
2face neva talk anytin onto wetin dis professor yarn.
Yanga dey sleep,trouble dey wake am.
Monday, 30 January 2017
Di WIFE OF ONE OF Di FIRST YORUBA RAPPER,LORD OF AJASA,DON BLAST OLAMIDE SAY HE DEY DO LIKE SAY HE NOR KNOW DEM AGAIN
I nor know weda Yoruba local rapper Lord of Ajasa don epp Olamide bifor o,
but di way wey Ajasa wife take blast Olamide on top twita,shock me.
She say Olamide dey do like say he nor know dem again but God dey.
Sunday, 29 January 2017
CALIFORNIA PIPO DON DEY TIRE TO DEY INSIDE AMERICA AS DEM DON START PLANS TO COMOT AND STAND AS KONTRi OF DIA OWN
Veri soon if tins go akordin to plans,if u ask California man say wich kontri he come from,he go say na California nor be America again.
Carlifonia wey be di nomba 3 biggest state for America and also di state wey pipo plenti pass wit about 40 million pipo,don submit Di 'We won Comot' papers to di Seketri of states office akordin to tori wey we gada.
Bicos many of dem nor like di new President Donald Trump,so diafor,many of dem biliv say dem fit sorsid wit dia plans.
We dey watch.
If e appun,Ogakpatakpata go stil let una know,no shaking.
Saturday, 28 January 2017
YOU GO LOVE DIS SHORT VIDEO AND PICTURES OF HOW NAIJA CELEBS LOOK LIKE BIFOR DEM BLOW..REEKADO BANKS PISHOR GO SHOCK YOU
Money good.
From Wizkid to Cynthia Morgan to Runtown to Timaya to 2face to Tonto Dikeh to,...Di list plenti.
Klik and See Di vidio of how some of dem bin wowo.
Some na strong atutupoyoyoyo bifor dem blow...
SEE LOVE NWANTiTi: 2FACE IDIBIA AND ANNIE IDIBIA KISSING,TWERKING,JOKING (VIDEO)
Well,e beta say di Africa Queen singa 2face don change as he always dey show off him wife Annie to di world.
Unlike bifor wey di bobo dey score for evriwia.
Check out dis video for bottom hia.u go see wetin I mean...
NEW AMERICA PRESIDENT DONALD TRUMP,DON BAN 7 MUSLIM KONTRiS FROM ENTERING AMERICA AND Di KONTRiS NA LIBYA,SUDAN,SOMALIA,YEMEN,SYRIA,IRAQ AND IRAN
During campaign we bin feel say Donald Trump dey carry yarn wen he talk say him go deal wit muslims but since he bikom presido last week,di man don dey do. as he talk.
One of di first tin wey Trump do yestaday na to ban seven Muslim kontris make dem no enta America.
Di seven kontris na,Libya,Iraq,Iran,Sudan,Somalia,Yemen and Syria.
He also yarn say dem go put more kontris for dis list and bodi don dey phone me say Naija name fit go appia for di new list. God forbid!
Why bodi nor go phone me wen Boko Haram from di north nor allow pipo Rest wit bombi bombi.
Meanwhy,i nor know wia dem for dey sell bomb.
Abeg Donald Trump,me,my frends,my famili nor dey among o.
You know say my pipo dey yonda and I nor won hia say I nor fit go for visit again.
Trump,Just in case,jejeje select di pipo wey dey giv Nigeria bad name and ban dem.
Friday, 27 January 2017
PASTOR ADEBOYE DON YARN SAY,NA JOLLOF RICE WIT BETA BIG CHICKEN ON TOPAM,NAIM CARRY AM GO START SCHOOL FOR UNiVASiTi OF NIGERIA,(UNN) NSUKA FOR ENUGU FOR 1963
Di Genera Overseer of di Redeemed Christian Church of God RCCG,Pastor Enoch Adeboye,don tell tori pipo say,wetin make am find admission enta Univasiti of Naija,Nsuka,for Enugu state na,jollof rice.
He say wen him and oda students travel go UNN for 1962 for and wen he see student wey dey eat and enjoy Jollof rice wit half of full chicken,dis come make am dey swallow salaiva.
Adeboye say as he dey comot for di school dat day,naim him pray to God say make God givam admission enta di school di following year and rili,God ansa him prayer.
For 1963,Adeboye gain admission into UNN but he nor graduate for di school bifor he comot.
Pastor Adeboye yarn all dis one wen he carry waka go di school go kolet Honorary Doctorate Degree award for di school on Tuesday.
Subscribe to:
Posts (Atom)

