MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday, 31 March 2017

PRESIDENT BUHARI DON DEY PREPIA TO TRAVEL TO LONDON AGAIN TO SEE DOCTORS FOR TREATMENT 3 WEEKS AFTA HE COMEBACK


President Muhammadu Buhari wey come back from London from him sick leave three weeks ago,don dey prepia to go back for follow up tritment.
We nor know who we go biliv again.
Di same Aso Rock tell us some days ago say dem go bring di doctors come Naija to come trit Buhari but today now,na Buhari go enta yonda again.
Well,e nor kuku konsign me.

Thursday, 30 March 2017

MAYORKUN,ONE OF DAVIDO BOYS DON YARN SAY,HE FIT SLAP HIM MAMA BICOS OF N350 MILLION NAIRA IF YOU PROMISE TO GIVAM



Mayorkun di eleko singa and one of Davido DMW Records artiste,don tell tori pipo say,to slap him mama bicos of 1million dollars wey be ova N350,000 million for Nigeria money,na small ting.
During di joinbodi intaviu wit Nancy Osime of sound city,Mayorkun say,he mama go vex slapam if him nor slap him mama bicos of dat kain plenti money.
Wetin money go cause ehn,we neva see the end.
Oya watch di video for bottom hia...


Wednesday, 29 March 2017

BREAKING NEWS: ALMIGHTY BRAZIL DON BECOME Di FIRST COUNTRY TO QUALIFY FOR RUSSIA 2018 FIFA WORLD CUP AFTA DEM WIN PARAGUAY 3-0


Marcelo,Miranda,Neymar,Coutinho,Paulinho,Firmino don joinbodi wit oda membas of di Brazil national team to giv Paraguay 3 kondo to make dem di first kontri wey kwolifai for Russia 2018 FIFA World Cup.
Na Coutinho,Neymar and Marcelo skor di 3 goals for dem early dis morning against Paraguay and dis one make dem di first kontri to kwolifai for di 2018 World Cup.
Make we see wetin dem go play afta Germany show dem pepper for di 2014 World Cup wey di world gada play for Brazil.
Germany win dem 7-1 and na dia worst eva result be dat.

OLD NEWS: IGBO PIPO ABEG MAKE UNA REDUCE Di BRIDE PRICE OF OUR GIRLS..DAT NA Di BEG WEY FORMA GOVNOR OF ANAMBRA STATE MR ROBERT AKONOBI DEY BEG BE DAT


I neva know how some papa and mama wey come from igboland go resiv dis news.
Di forma khaki uniform Gofnor of Anambra state Colonel Robert Akonobi,don kneel down dey beg igbo pipo make dem take am easy wit di big bride price wey dem dey kolet on top girls head.
He say make dem try reduce di bride price so dat boys go fit dey marry dem.
He yarn dis one for Nnewi,Anambra state during di marage serimoni of bizness man Louis Onwugbenu daughta,Onyinye and her hosband Bosah Chukwuogo.
Nor be news say girls from di east bride price dey veri costli.
So make we see weda e go change as true true many men dey run from Igbo girls bicos of large bride price.

Tuesday, 28 March 2017

AFTA WIZKID AND SKALES LIVE BANKY W GANG GO START LIFE FOR SOMEWHERE ELSE,SHAYDEE DON ALSO COMOT GO CANE HIM OWN LINE


E don favour some pipo why e affect some pipo afta dem live dia oga to go arrange dia life for some wia else.
Afta Wizkid live Banky W and EME Records,di bobo don hama sotaaay,Yankee carry him mata for head.
Skales nkor,he nor dey do bad since he live Banky W.
And now Shaydee don waka.
Make we dey see how hin mata go be.

Monday, 27 March 2017

Di BABE FOR IBADAN AYOMIDE LABINJO WEY SAY NA DAVIDO BE Di PAPA OF HER 3 YEAR OLD DAUGHTER DON TALK SAY,SHE ADVICE DAVIDO TO WEAR CONDOM BUT Di BOBO NOR GREE


E be like say we neva hear di last word for Davido and di babe wey say naim giv her belle born her 3 year old daughta.
Akordin to di babe Ayomide Labinjo,she say wen Davido come Ibadan,dem two enta one hotel and Davido sleep witam witout condom.
She say she advice di bobo to use condom but Davido say him nor like condom at all.
Na wa o,dis konji na pure bastard!
What if...

Sunday, 26 March 2017

SINGA 9ice DON YARN SAY,NO BE BY FORCE TO MARRY AND IF YOU NOR MARRY,E NO MEAN SAY GOD GO PUNISH YOU


9ice,one of di supastar wey him miuzik skata evriwia for inside and outside naija,don yarn say,God no go punish who no marry bicos no be by force to marry.
Di baddest bobo wey get four shidren right now from three diferen women,yarn dis one wen tori pipo askam weda he go marry any of dem.
Akordin to 9ice he say di most impotant ting na happiness and dia is no garanti say na evribodi wey marry dey hapi.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...