MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday, 3 June 2017

YAWA DON GAS AS DEM DON ARREST AFRO FUJI SINGA,DAMMY KRANE FOR MIAMI,AMERICA BICOS OF WAYO AND 419 WEY HIM DO FOR DiA


Di Tori wey fly kait enta our newsroom be say,Fuji singa Dammy Krane don enta heavi kasala for America as dem don arrestam for di Miami city of Florida sake of say he play pesin gibiti and wayo and use to pesin credit card pay to fly private jet.
Akordin to di tori,na 7 point somtin million he don use for Di pesin credit card alreadi.
I still dey shake my head dey pity dis bobo for di kain yawa wey him put imsef.
Except say na magic he go do to free imsef from dis chukuchuku.

Friday, 2 June 2017

FEDERA GOFMENT DON BAN SELLING OF CIGARETTE TO PIPO WEY DEY BELOW 18 YEARS


Federa gofment don look up,look down and say,No more selling of Cigar to anybodi wey neva reach 18 years again,if both di seller and buyer nor won enta wahala.
Di minista for kankpe bodi mata,Professor Isaac Adewole naim yarn dis one for Abuja to mark di 'World No Tobacco Day'.
He say di tin still dey pain am afta World Health Organization,WHO yarn say ova 4.5 million Naija mature pipo naim dey smoke.
Di minista also yarn say he want make make dem quick quick put dis law wey go make dem punish anybodi wey brake dis law.

Thursday, 1 June 2017

ONE MAN FOR CALABAR KOKO DAN,DON BUILD 3 BEDROOM FLAT FOR HIM POOR NEIGHBOURS (HUSBAND AND WIFE) WEY DON STAY MUD HOUSE FOR 30 YEARS WITHOUT PIKIN


If to say God dey ask pipo to pick one pesin joinbodi wey you want make he make heaven wit you,one time I go choose dis Koko Dan for Calabar wey replace di red mud house wit biutifu 3 bedroom flat of him poor hosband and wife neighbours.
Dis two pipo,Mr Ebugwe Obu and Mrs Agnes Obu  akordin to tori wey we gada,don dey stay di mud house for 30 years and dem neva born pikin.
If 1000 pipo like Koko Dan dey dis kontri,America for dey learn greatness for wia Naija dey.

Wednesday, 31 May 2017

NEW SUPER EAGLES PLAYER, OLARENWAJU KAYODE,DON WIN BUNDESLIGA PLAYER OF Di YEAR FOR AUSTRIA


Forma Flying Eagles playa and now New Super Eagles playa,Olarenwaju Kayode,get plenti reason to selibrate as dem don choose am as di playa of di year for Di Austria Bundesliga League base on di way wey di bobo take paform for him club.
He score 17 league goals for hin club Austria Wien,5 Europa league goals,2 for di Austrian Cup and evritin total come be 24 goals.
Congratulations Kayode as we dey wait weda one big Europe club go come pincham take from Austria Wien.

Tuesday, 30 May 2017

WITH 30K,YOU GO FIT BUY YOUR OWN HOUSE AND BECOME LANDLORD FOR NIGERIA NOW ACCORDING TO YEMI OSINBAJO,OUR ACTING PRESIDO


Politicians don come again and dis time around,na Yemi Osinbajo be dia piano.
Akordin to Osinbajo wey be our president until Buhari return from di sickness wey he go trit,if you get 30k,you fit be your own landlord bicos dem don dey save plenti money since to take make am appun.
He say dis one na big sikrit and dem don alreadi start dis 30k house mata for 11 states for Naija.
Osinbajo u for try mention di state so dat tori pipo go do dia investigation.
Di 5k for pipo wey nor get work wey una promise,I nor know anybodi wey don collect.
I hope say dis one no be craze man talk?

BARCA FANS,SEE UNA NEW COACH


Fc Barcelona of Spain don get new coach for dia next season.
Hin name na,Ernesto Valverde,forma Olympiocos and Valencia coach wey just step down as coach of  Athletico Bilbao last week.
Ernesto naim go handle all Barcelona football war wit oda teams from next season.
Di kain qualiti and serenren playas wey Barca get,if Coachee nor dey bench sef,dem go stil win cup.
Anyway,kongratulation to Ernesto Valverde.

PIPO WEY NO DEY DO KEREWA ALWAYS,SMALL TING LIKE DIS DEM DON PARA ACCORDING TO FORMA BIG BROTHER AFRICA MEMBA,BEVERLY OSU



Forma Big Broda Africa memba,Beverly Osu,don yarn on top her Snapchat page say,pipo wey no dey involve diasef for kerewa always dey always vex ova stupid tins.
Na wa o.
Dis babe don turn kerewa mathematician and adviser.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...