MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday, 31 August 2017

INSTEAD OF HANDSHAKE AS REWARD WEY OBASANJO INTRODUCE,BUHARI DON SHOCK MANY PIPO AS HE GIVE N1 MILLION EACH TO NAIJA WOMEN BASKETBALL TEAM WEY WIN AFRICA CUP


President Buhari don dash each player of Nigeria women basketball team wey win di FIBA Africa basketball cup for Senegal,N1 million each.
Di money small if you konpiaram to wetin dem bin dey give most of our team and players anytime dem do us proud for kompetishon.
But during Obasanjo second coming as president from 1999 to 2007,na handshake and kpof kpof naim dem dey resiv afta dem win cup.
Since we know Buhari as pesin wey hate to spend money anyhow,we feel say di handshake govment go kontiniu but we shock say he still give each of dem N1 million naira.

Wednesday, 30 August 2017

ONE BABE 'CHIOMA PIUS' DON TELL TORi PIPO SAY,SOME POLICE MEN FOR RIVERS STATE BEAT NONSENSE COMOT FOR HER BODY JUST BICOS SHE DRAW TATTOO



Chioma Pius don report policemen for Rivers state on top di beat wey dem beat her wen she dey travel from Bayelsa to Port Harcourt.
Dem stop her taxi for Elebrada junction,Emohua,Rivers state.
Akordin to Chioma,Di reason why police pipo beat her wit koboko and cane na bicos she draw tattoo for bodi.
And now she dey wonda weda to get tattoo for bodi don turn crime?

Tuesday, 29 August 2017

POLICE DON ARREST PASTOR WIFE FOR AKWA IBOM STATE BICOS SHE ARRANGE HER OWN KIDNAPPING SO DAT CHURCH MEMBAS GO PAY N3 MILLION FOR HER RELEASE


Police for Akwa Ibom state don arrest one Victoria Elijah Ndu wey be pastor wife for Nsit Atai local gofment area,sake of say she plan her own kidnap.
Police reskiu her for Imo state but dem later find out say,na she plan her own kidnaping wit her junior broda Victor Okon Akang and dem don arrestam too.
Mrs Victoria bin plan her own kidnap so dat church membas go raise di N3 million wey dem put for her head.
We too wicked for dis world.
Imagine a whole pastor wife bicos of money.
Akwai Ibom state police command for Ikot-Abia don dey gada her konfeshon wey dem go take nail am last last.

Monday, 28 August 2017

BIG BOY ACTOR,MOFE DAMIJO (RMD),DON YARN SAY,WETIN HIM HATE PASS FOR HIM LIFE NA TO SHAVE HIM BIA-BIA..HOPE SAY HIM DEY REMEMBA TO DEY SHAVE HIM ARMPIT SHA



Mofe Damijo nollywood fine man,Mr RMD,na beta lazy man bicos he don yarn tori pipo wit hin own mouth say,him lazy for one area and dat area na to dey shave him bia-bia.
He say,anytime wey work nor dey,he go just allow di bia-bia kuku grow.
He yarn say no be say him dey poposeli dey live di bears make dem grow but bicos e dey tire ram to shave.
If  RMD dey lazy to shave odnari bia-bia for face,you sure say if he show us hin armpit,man no go fain

Sunday, 27 August 2017

FORMA MAN UNITED BADDEST DIFENDA,PATRICE EVRA, DON USE TUBABA EVAGREEN SONG 'AFRICAN QUEEN' TAKE SELIBRATE HIM MAMA AND ALL MAMAS ALL OVA Di WORLD


African Queen,di ogbonge song wey still dey put 2face for map till today,don kontiniu to kolet beta mention home and abroad.
Di latest pesin wey use di jam take selibrate na forma Man U and forma Juventus great difenda Patrice Evra.
Evra use di song take selibrate Mama dem all ova di world as he advice pipo make dem no use dia mama take play.
He even dey sing follow di song line by line.
He say him no dey like shidren wey no get respect for dia mama.
He yarn plenti tings and he say he love him mama plenti plenti.

Saturday, 26 August 2017

MAJEK FASHEK DON YARN SAY WETIN MAKE DEM NO DEY USE AM PLAY FOR OBODO OYIBO NA BICOS OF Di TRAINING AND EXPERIENCE WEY HIM GET FROM FELA


Supastar Majek Fashek want make u know say,him no be odnari miuzishan but intanashona star.
Majek wey go selibrate him 30 years on stage on Septemba 10 wit ogbonge show,don yarn say,di Majek brand strong both for local and intanashona bicos of pipo like Fela wey train am.
Majek go also reliz him new album wey him call 'Weep not child' on di same day of di show.

Friday, 25 August 2017

RAYMOND,Di ONLY PIKIN OF ONE OF Di BIGGEST ACTRESS FOR NOLLYWOOD,EUCHARIA ANUNOBI,DON DIE


Bad news no be wetin dey make pesin happy at all.
We join millions of Nigerians to say sorry to Eucharia Anunobi,one big Nollywood actress on di loss of her son.
Her only pikin,Raymond die on Monday at di age of 15 and akordin to tori wey we gada,Raymond dey suffer from sickle cell anemia.
May hin soul Rest In Peace.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...