MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday, 30 September 2017

AFTA EEDRIS YABAM SAY HE DEY SING NONSENSE NAWADAYS,TIMAYA DON YABAM BACK SAY HIM NA FOOL! IDIOT AND DIRTY IGBO SMOKER!


First to do no dey pain,sekond to do fit giv high patenshon.
For two weeks now,rapa Eedris Abdulkareem don yab many miuzishans wey him feel say dey do anyhow for di industri.
Pipo like 2face,Mr Eazi,Davido,D'banj and even Timaya nor escape di yabis from Eedris.
Now Timaya don show us one video wia him for yab Eedris back and dis kain yabis fit make pesin blood boil.
Akordin to Timaya,Eedris na idiot,fool and dirty igbo smoker.
He say Eedris and dem 2face start di same time and till today,2face stil dey Hama but hin Own na to dey yarn puan on top intanet.
He say make Eedris go work and stop to yarn puan.
Timaya even yarn say,wen him dey do boyboy for Eedris,Eedris no even dey givam common transport money.
My guys Abeg una watch di video for bottom hia and see di way Timaya dey vex....


Friday, 29 September 2017

TONTO DIKEH DON YARN TORi PIPO SAY,Di PAPA OF HER FORMER HUSBAND CHURCHILL OLAKUNLE,NA OBASANJO GARDEN HE DEY WORK BIFOR HE BECOME PREACHER MAN


Dem say wey pesin dey vex,he fit yarn anytin wey enta hin mouth.
Weda di tin na bad tin or gud tin,dat pesin fit talk am wen he dey vex.
Nollywood baddest babe Tonto Dikeh wey her marage to Churchill Olakunle jam rock about two months ago,don use vex take let us know say,Churchill papa na Obasanjo garden man bifor he turn preacher.
Dat is to say,na Obasanjo garden naim he dey work.
Tonto Dikeh yarn dis one during her vex vex reply to wetin tori babe,Azuka,talk about her and her marage to Churchill and oda tins.
She talk about how her forma hosband Churchill take bribe Azuka to dey write nonsense about her.
Di babe say Tonto Dikeh Own na just to talk bad tins about Churchill make pipo for feel say di bobo na bad pesin.
Dis one kon make Tonto vex say,if true true say she won spoil Churchill name,why she neva tell di whole world since say,Churchill papa na forma gadina to Obasanjo?
Na wa o.

Thursday, 28 September 2017

PDP DON TELL GOVNOR FAYOSE SAY HE CANNOT BE PRESIDENT FOR 2019 BICOS ALL OF DEM DON AGREE FOR MEETING SAY,NA PESIN FROM NORTH DEM GO PRESENT TO BE PRESIDENT


PDP don advise one of dia memba wey be Ekiti state gofnor Ayo Fayose say,make he no dey waste him time,waste him money and waste him salaiva dey talk say he wan be Naija president.
Na PDP poblic seketri,Dayo Adeyeye naim yarn dis one on Wednesday.
He say even Fayose dey di meeting wey dem for agree say,na Hausa,Fulani or pesin from di north naim dem agree to choose president for 2019.
Tori wey fly enta our newsroom be say,Oga Fayose go finalli let Di whole world know him plan to bikom Naija president on Thursday.
Akordin to PDP,di only position wey open to politishans from south na,PDP Chairman so diafor,if Fayose won be chairman of PDP,wahala no dey but if na to be president naim dey hungry am,he dey disiv imsef.

Wednesday, 27 September 2017

PORT HARCOURT FIRST SON DUNCAN MIGHTY,DON YARN TORi PIPO SAY,E NO GO BETA FOR ANY MAN WEY LOVE HIM WIFE OR GIRLFRIEND PASS HIM MAMA


Singa and Port Harcourt first son Duncan Mighty don remind us of di need to love our mama like mad afta he post pishor of two women wey sidon for back of bus wit dia cassava from farm.
Akordin to Duncan Mighty he say, E no go beta for any man wey love him girlfriend or wife pass him mama.
On top di pishor,he write say, "afta all dis suffer wey mama dem suffer make pikin for chop and make dem for pay dia school fees" some men go carry one yanga tolotolo woman put for house and kon forget dia mama.
Duncan tank him mama for di 9 months wey she carry am.
Akordin to di bobo,he say some men don still hama buy car but dia mama stil dey trek go market.
Too bad akordin to Duncan Mighty.

Tuesday, 26 September 2017

BRODAS WAR AS P SQUARE DEM THROW BLOW DURING MEETING WIT DIA LAWYER (VIDEO)


Di fight bitwin P Square don tie wrapa.
Paul togeda wit Jude dia sinior Broda and manager,dey fight Peter for di video wey no swit for eye at all.
I wish dem fit settle diasef,di ting for swit bicos dis twins don give us beta gbedu miuzik wey make us love dem.
E dey painful to see dem dey fight like dis.
If Mary Slessor wey stop di killing of twins for Naija still dey alive bifor,dis video no go giv her joy at all.
Watch di video for bottom hia...


NEPA UNA DON HEAR? LAGOS STATE GOFMENT DON BUY 120 GENERATORS GIVE POLICE MAKE DEM DEY USE FOR ALL Di POLICE STATIONS FOR Di STATE


Wen gofment wey sopose giv di pipo light vex enta market go buy generators make dia workas for see use for office,make you know say water don pass Garri.
Lagos state govment don buy 120 tear rubber 5KVA generators for di state police station make light wahala no be part of dia ploblems.
Mr Oye-Hassan Oyekale di Chairman of di Lagos state sikioriti Trust Fund (LSSTF) wey reprezent Govnor Akinwunmi Ambode for di hand ova serimoni for Ikeja,yarn say he dey impotant say dem give dem generators so dat dia work go dey izzi if NEPA take light.
Dat one sef join.

Monday, 25 September 2017

SINGA AND RAPPER 'SKALES' DON YARN TORi PIPO ONE SiKRiT AS HE TALK SAY,WEN POVERTY PINAM DOWN,NA OLAMIDE DASHAM MONEY WEY HIM TAKE SHOOT 'SHAKE BODY' VIDEO




If u do good Na so so good go dey follow you Na so dem talk am.
Afta about 3 years,rapper Skales don yarn us one big sikrit wey konsign di good wey Olamide do foram..
Skales bin dey wit Banky W and Empire Mates Entertainment (EME) bifor he kon go hin own way.
During dis piriod,di bobo reliz one ogbonge miuzik 'Shake Bodi' wey skata evriwia for Naija but no money to shoot di vidio bicos poverty use blanket kovaram.
Akordin to Skales on top twita,he say he no fit hide am again as he yarn out di sikrit say,na Olamide naim dasham money wey him take shoot di vidio of Shake bodi.
He say afta dat vidio,him stori change to halleluya and jolliment and he kon thank Olamide for di good ting wey him do for him life.
Olamide don yarn for di mata as he say God dey alive for all of us.
He also yarn Skales say,but two of dem agree to kipam as sikrit na!
Skales kon telam say,no be lie bicoshe try to kip di sikrit but di sikrit no gree.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...