MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday, 31 October 2017

FEDERA HIGH COURT FOR CALABAR DON GIVE ORDER TO NIGERIA NAVY MAKE DEM PAY ONE MR ETIM ASUQUO N75 MILLION SAKE OF SAY DEM BEAT CRAZE COMOT FOR HIM BODY


Di Nigerian navy must pay N75 million naira to one Mr Etim Asuquo Akpan afta court find dem guilty of beating,shooting and illegal torture.
Justice Inyang Ekwo of Di Federa High Court Calabar na yarn dis one during di court judgement.
He also direct Nigeria Navy to apologize to Mr Akpan for inside newspaper.

Monday, 30 October 2017

TEE BILLZ DON TALK SAY NA DEVIL BIN DEY USE HIM BRAIN FRY AKARA BICOS HIM NO UNDASTAND WHY HE NEARLY LIVE HIM BIUTIFU WIFE,TIWA SAVAGE



Tiwa Savage hosband Tee Billz,don yarn tori pipo say na big mistake he niali make foram to eva tink of living him wife.
He say him no biliv say him bin won live biutifu woman like Tiwa Savage.
If you bin follow up,you go know say kasala bin buss bitwin dem two as Tee Billz niali komit suicide.
Di reason akordin to Tee Billz be say,Tiwa dey allow oda bobos torchlight her website.
But now dem don settle dia wahala and di only tin wey Tee Billz dey see now na Tiwa biuti.

Sunday, 29 October 2017

FEDERA POLYTECHNIC OKO FOR ANAMBRA STATE DON BAN Di SCHOOL BOYS MAKE DEM NO CARRY AFRO AND BIA-BIA FOR FACE ENTA EXAM HALL AND MAKE Di GIRLS NO WEAR TROUSERS


Federa Politeknik Oko for Anambra state, don  arrange law on top di students head konsigning dia exam.
Di law now be say dem don ban di boys make dem no train Afro hair or carry bia-bia for face enta  face enta exam hall.
For di girls,dem ban dem make dem no wear trouser enta exam hall.
Akordin to di school oga dem, dem no go allow any student wey break di law write exam.
Many students of di politeknik wey follow tori pipo yarn talk say, e be like say di school oga dem don smoke ganja full dia brain base on say dem dey trit dem like sekondri school shidren.

Saturday, 28 October 2017

SINGA AND PORT HARCOURT FIRST SON DUNCAN MIGHTY DON CONFAM SAY, HIM GO SOON LAUNCH HIN OWN CABLE TV STATION


Port Harcourt first son Duncan Mighty  don tell tori pipo on stage during di legend extra stout show for PH say, he go soon launch him own cable TV station.
Akordin to di bobo he say, many talen dey waste for di garden city and him go use di station show di world say talent full Port Harcourt.
Duncan Mighty say he don spend millions for di project alreadi and he blood dey hot to open di TV station veri soon.

Friday, 27 October 2017

NAIJA MAN WEY GIVE SOUTH AFRICA MAN WIFE BELLE,DON BUY MERCEDES BENZ G-CLASS WAGON DASHAM MAKE HE FOR NO VEX


Wondas sha neva end.
Wetin we no go here for dis world.
One naija man for South Africa don buy Mercedes Benz dash one man make di man no vex sake of say he give di man wife belle.
Akordin to di naija man he say,he know say him do wrong o but him hapi say di man kolet di motor.
Dis one na pure sell out.
Di man don sell him wife,chai!

Thursday, 26 October 2017

GHANA PRESIDENT NANA AKUFO-ADDO,DON CONFAM SAY DEM DON GIVE LICENSE TO TEAM CAPTAIN ASAMOAH GYAN TO RUN HIM OWN AIRLINE COMPANY 'BABY JET AIRLINES'



Dis mata large finish o.
Di captain of Black stars of Ghana,Asamoah Gyan, don get license from di Ghana govment to operate hin own airline,Baby Jet Airlines.
Ghana president Akodo, naim yarn and confam dis one on top one joinbodi siddon.
Asamoah wey him nickname na Baby Jet,Don play for France, England, China, and he dey Turkey dey play right now since July.
He make beta money afta he enta Arab land go make Arab money wen he go tap leda for yonda.
Asamoah Gyan don alreadi name di konpini wit him guy name 'Baby Jet Airlines'.
Respect,who big don big.

Wednesday, 25 October 2017

IN CASE U NOR KNOW, FELA MAMA FUNMILAYO KUTI, NAiM BE Di FIRST WOMAN TO DRIVE CAR FOR NAIJA AND TODAY SOPOSE BE HER 117 YEARS BIRTHDAY



Funmlayo Ransome Kuti, Di woman wey born Fela, sopose selibrate her 117 years birthday today.
Bifor she die, she be tisha, politika campaigna,fighta against bad gofment and many odas.
And just in case you bin nor know, na she also be di first woman wey drive motor for Nigeria.
Dis famili dey rich in history no be small.
We for Ogakpatakpata say Twuale mama, kontiniu to rest in peace.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...