MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday, 30 November 2017

FOR LONDON,DAVIDO AND WIZKID DON MAKE US PROUD AGAIN AS DAVIDO WIN BEST AFRICA MUSICIAN AND WIZKID WIN Di BEST INTERNATIONAL MUSICIAN FOR 'MOBO AWARDS'


Davido and Wizkid don kontiniu to make naija proud even though say dem be cat and rat.
For di MOBO Awards wey appun for London yestaday,Davido win di best African artiste why Wizkid difit pipo like Drake,Jay Z and Cardi B to win di best International artiste.
We no say dis two guys don turn enimis but we need selibrate dem as dem don kontiniu to put dis kontri name for map.

Wednesday, 29 November 2017

COMEDIAN AY,DON TELL GIRLS WEY DiA BRAIN EMPTi SAY DEM NEED BETA BRAIN TO SEE CORRECT HUSBAND,NO BE TO DEY PACK MAKE-UP FULL FACE


Comedian Ay don yab all those girls wey dey carry make-up full face from morning till night just to look fine.
He say,if dem no know book naim be say to see beta man marry na ploblem.
No amount of make-up and aso-ebi wey you buy fit give you hosband to marry.
Akordin to Ay,if your brain empti koret men go dey use and dump you.

Tuesday, 28 November 2017

PRESIDENT BUHARI DON GIVE ORDER TO ALL GOVNORS,MAKE DEM MAKE SURE SAY DEM PAY WORKERS WEY DEM STILL OWE SALARIES BIFOR CHRISTMAS


E be like say dis krismas go swit o as Uncle Buhari don tell all Gofnors say make dem no owe any worker salary bifor krismas.
If e get salary wey dem neva pay,Buhari don tell dem say make dem pay bifor di krismas selibrayshon.
Nice one,only say di money nor go still rish dem use as price of food stuff and evritin don double since Buhari enta pawa.

Monday, 27 November 2017

CHECK OUT NIGERIA NEW JERSEY WEY DEM GO WEAR FOR Di FIFA WORLD CUP,RUSSIA 2018


Just like as e dey appun bifor evri World Cup wey we dey go,Nike don reliz new jersey wey di Super Eagles of Nigeria go wear for Russia 2018.
Few pipo wey I talk to for street gree say,dis one fine skata and e plasta finish.
Me sef agree.
How u siam?

I BE BOXER BIFOR BUT I STOP AFTA ONE DELTA BOY USE BLOW SCATTER MY FACE LIKE SAY KATAPILLAR JAM ME - MR IBU


Funny actor John Okafor a.k.a Mr Ibu,don yarn tori pipo say,if no be di film industri wey snatcham,he for kontiniu him work as a boxer.
Akordin to Ibu,him stop boxing di day wey one Delta boy use blow draw map for him face.
He say dem go one boxing kompetishon for Delta but dem niali killam for ring.
Di nollywood actor say,wen he rish house and see him sef for mirror,naim he tell imsef say,boxing bye bye.
Mr Ibu say di guy na idiot and he niali blind one of him eye wit blow and e take am sometime bifor he start to see wit di eye again.

Sunday, 26 November 2017

GOODLUCK JONATHAN DON TELL ATIKU ABUBAKAR SAY,IF HE WAN BE NAIJA PRESIDENT FROM PDP,FIRST OF ALL,HE MUST GO BEG OBASANJO


Goodluck Jonathan don advise Atiku Abubakar make he go apologize to Ogakpatakpata of Naija politiks Olusegun Obasanjo,if he won be president of Naija for 2019.
Atiku naim be Obasanjo assistant,Vice President and nomba two man wen he be president from 1999 to 2007 but two of dem later turn cat and rat bifor dem comot for Aso Rock.
Now forma president Goodluck don advise Atiku say,if he want make PDP choozam as dia nomba one man for 2019 election,he must go beg Obasanjo to forgivam onto say,Baba still dey vex foram.
Akordin to Goodluck Obasanjo stil get say for who go be president.
Na wa for our leaders o.
No be we go vote to choose who we want again to be president?
Na only Obasanjo?
Ok o,we dey watch.

IKEBE DANCE COMPETITION,ENUGU 2017 FOR PHYNO SHOW (VIDEO)


Duncan Mighty put Enugu girls ikebe for high jump during di Phyno Fest groove.
Wen di bobo come out to sing Na so he do Ikebe konpetishon for di girls to choose di Enugu best Ikebe,2017.
All kind of yansh naim do di groove.
Slim,fat,stone yansh,soft and even water water yansh come stage for di konpetishon.
Watch who win Enugu Ikebe,2017 for hia...


LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...