Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Tuesday, 30 January 2018
SAD NEWS AS OLAMIDE DON ANNOUNCE SAY HIM MAMA DON DIE,Di SAME DAY WEY OLAMIDE CELEBRATE HIM SON 'MAXIMILIANO' BIRTHDAY
Naija nomba one Science Student,Olamide,don lost him mama today as dis one troway shock enta di entatayment industri.
Olamide mama die today wey be di 30 day of January di same day wey Badoo selibrate him pikin Batifeori Maximiliano Adedeji nomba three birthday.
If you dey follow up,Olamide papa die for 2015 bifor dis one kon appun today.
We still dey try gada di news of how he take appun and we go bringam to una as e drop.
Rest In Peace Mama Badoo.
SOUND SULTAN SENIOR BRODA 'BABA DEE' DON YARN SAY,HIM SURPRISE FOR Di LEVEL OF POVERTY WEY HIM SEE FOR ONE WHITE MAN COUNTRY 'ESTONIA'
Baba Dee wey be di sinior Broda to Sound Sultan don talk say,wen him travel go 'Estonia' for Northern Europe,him shock to see say dem poor like us too.
He say for a kontri of white pipo,him surprise say dia poverty level high welwell.
Monday, 29 January 2018
E TAKE AIYEGBENI 10 YEARS TO SCORE 8 GOALS FOR ENGLAND FA CUP BUT IHEANACHO DON BREAK Di NAIJA RECORD AS HE DON SCORE 9 GOALS IN JUST TWO YEARS
Forma Manchester City player Kelechi Iheanacho of Nigeria don break record for England FA Cup as he score him nomba 9 goal for di konpetishon afta him club Leicester City win Peterborough 5-1 on Saturday.
Iheanacho score two goals out of di five to pass Yakubu Aiyegbeni wey bin dey hold di record of all Naija playa wey don score pass for di England FA Cup.
Iheanacho don score 9 goals for 9 matches in two years,Aiyegbeni score 8 for 20 matches and he take am 10 years to score dem,Victor Moses dey 6 goals from 29 matches and Kanu Nwankwo score 6 goals from 24 FA Cup matches.
Sunday, 28 January 2018
I GET 13 PRESIDENT PHONE NUMBERS.. DAT NA WETiN DAVIDO TELL TORi PiPO YESTADAY
Davido go always yarn wetin some pipo go see as shakara and pride but no lookam like dat, na just him style.
Evribodi wit dia own karata and Dis na di difrence bitwin some pipo and oda pipo.
Akordin to Davido wey plasta evri evri for 2017,him say him get 13 Presidents phone numbers and if he call dem,dem dey pick one time.
Bobo you try,e no easy but no be only u get dia nombas,some selibritis fit get like 20 President nombas but dem no wan just yarn.
Anyway as Davido talk am e no bad bicos talk like dis dey inkriz pesin GP for do industri.
Like me now,I get 14 Presidents nombas but I no just won talk yet.
Saturday, 27 January 2018
"MAKE UNA STOP TO DEY DRINK GARRI" IMO STATE GOVNOR,ROCHAS,DON TELL IMO PIPO AFTA LASA FEVER KILL 3 PEOPLE FOR Di STATE
Na rat spit or shit dey cause Lasa Fever espeshali bicos dis rats like to dey play for inside garri and even tiff garri eat.
Many pipo don get dis lasa fever and many don die from am.
Tori wey rish us be say,three pipo don die from dis lasa fever for Imo state and Na dis one kon make di govnor of di state Rochas Okorocha dey beg dem make dem stop to drink garri.
Imo pipo ova to una.
Una Gofnor say lasa fever dey town so diafor,make una avoid garri.
Friday, 26 January 2018
ALL 'MAN U FANS' AND CORRECT FOOTBALL FANS,WERE UNA DEY? IN CASE YOU NOR KNOW,TODAY NA JOSE MOURINHO BIRTHDAY
Big name and top coach for world football Jose Mourinho birthday na today.
Dem born am January 26 for 1963 and he don turn 54 years today.
If you dey follow up,you go know say,Mourinho don win many trophy for him coaching karia.
He win Champions League wit Porto of Portugal and Inter Milan of Italy.
He don also win many cups wit clubs like Real Madrid and Chelsea.
Naim be di coach of Manchester United right now since 2016 and he don alreadi win two cup for dem.
Some dey call am di 'No Nonsense Coachi' but him nickname imsef di 'Special One' dat year wen he still dey Chelsea.
We for Ogakpatakpata dey wish you Happy Baitday Sir.
You go resiv ya baiday gift today from us if night nor quick rish.
Thursday, 25 January 2018
POLICE DON ARREST OGOGORO PROPHET 'PROPHET TITO' FOR TANZANIA AFTA PICTURE OF WEN HE DEY KISS HIM 'WIFE AND HOUSE GIRL' COME OUT
Dis one weak me like dodo o.
Afta pishor of one Tanzania prophet, Prophet Nabii Tito of wia he for dey kiss him wife and house girl for public come out,police don arrestam.
Nor be just odnari kiss o,na beta ashawo kiss naim Di prophet kiss him wife and house geh for public and na di prophet imsef use him own hand dey post di pishors for intranet.
Akordin to dia police,dem say no be only Di kissi kissi pishor be Di ploblem.
Dem say anoda reason why dem arrestam na di alcohol wey him dey shack anytime he dey preach.
Di tin vex Tanzania pipo and dem kon ginja police to arrest di prophet base on say as man of God wey he claim,dat kain karata no good,dat kain karata na bad example.
Subscribe to:
Posts (Atom)



