Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Monday, 30 April 2018
BOKO HARAM DON DEY COLLECT TAX MONEY FROM Di TOWN AND VILLAGES WEY DEY UNDA DiA CONTROL FOR BORNO AND YOBE STATES
Tori wey dey rish our tori room be say,one break away branch of Boko Haram don dey kolet tax and revenue from towns and villages wey dem don kapchor so dat dem go dey give dem sikioriti make dem fit dey sleep wit dia two eyes close.
Dia oga wey dey kolet dis money na Abu musab Al-barnawi wey be di pikin of Boko Haram founder Mohammed Yusuf.
Akordin to one herdsman or malu boy wey tori pipo follow yarn he say,dis pipo dey kolet N2,500 for malu and N1,500 for small small animals.
Afta dem kolet dis tax from dem,dem go kon gidem seeds and fatalaiza to use for dia farm and bush.
Na wa for dis kontri.
Sunday, 29 April 2018
Saturday, 28 April 2018
NOLLYWOOD STAR AND ACTRESS 'BLESSING OFOEGBU' DON YARN SAY,SHE GO LIKE MARRY MAN WEY RICH PASS BILLIONAIRE 'MICHAEL OTEDOLA'
Evribodi wit wetin dia prayer point be.
Your prayer point fit different from my prayer point.
One pesin wey don tell tori pipo about her prayer point na Nollywood star Blessing Ofoegbu.
She say she go like marry husband wey rich pass billionaire Michael Otedola.
But wetin we no know now be say weda she add fasting join di prayers bicos you fit count billionaires wey dey naija.
Dem no pass 30.
Evritin na faith for dis life aftaraw faith fit move mountain.
We wish her goodluck for dis trillionaire search.
Thursday, 26 April 2018
ONE OF Di ZULE-ZOO MEMBA, Di GUYS DEM WEY DAT SONG 'KEREWA' MANY YEARS AGO,DON RUN MAD ACCORDING TO HIM PARTNER,IBRO ZULE-ZOO
Ibrahim Hassan a.k.a Zule-Zoo one of di two guys wey sing Kerewa many years ago don tori pipo say him second parna Mike don run mad.
He say na wetin make pipo no dey hear from dem for some time be dat.
Akordin to Ibro he say,dem wake up one day just see di guy bigin behave like madness and dem be feel say na joke.
He also yarn say di ting dey pain am bicos Mike be like him blood broda bicos na since primary de turn frends.
Oya watch di video yasef hia...
Wednesday, 25 April 2018
NEW TORi: ETHIOPIA DON BECOME Di COUNTRY WEY DiA ECONOMY DEY GROW FAST PASS FOR AFRICA ACCORDING TO INTERNATIONAL MONETARY FUND,IMF
Ethiopia,one of di kontris wey hunger dey pass for di world don dey win many pipo heart as dem don bikom di kontri dey grow fast pass for Africa akordin to Intanashona Monetri Fund,IMF.
Na only God know di position wey naija dey right now.
Four years ago,na we bin dey carry first for kontris wey dia ekonomi dey grow fast pass.
Now hunger won finish us.
Tuesday, 24 April 2018
FEDERA GOVMENT DON FINALLY TALK SAY,DIFFERENCE NO DEY AGAIN BITWIN BSC FROM UNiVASiTi AND HND CERTIFICATES FROM POLYTHECHNIC,NA Di SAME LEVEL DEM DEY NOW
If you graduate from Politeknik wit HND satifikate no worry yasef again say you no dey di same level wit pipo wey get dia BSC satifikate from univasiti bicos federa gofment don yarn say,all di satifikate na di same now.
Monday, 23 April 2018
CHARLY BOY DON TELL GOVMENT TO BAN BIG BROTHER NAIJA BICOS Di SHOW NO GET ANY BETA TING WEY DEY TEACH
Area fada Charly boy don yarn tori pipo say make gofment ban Big Broda Naija bicos e no dey add value to di youth lifes.
He call di show crap bicos di prezent wahala wey di kontri dey face di show no join to solve am.
Subscribe to:
Posts (Atom)







