Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Saturday, 30 June 2018
Di PRESIDENT OF FRANCE EMMANUEL MACRON,GO VISIT FELA SHRINE FOR IKEJA NEXT WEEK TUESDAY
Fela,di king of Afro beat wey die August 1997 go hapi for anywia he dey as di President of France Emmanuel Macron go visit Fela Shrine next week Tuesday.
Di man go first land for Abuja to meet wit President Buhari and dat same evening, he go enta Di New Africa Shrine Lagos and Trace TV go dey on ground to welkom am.
Afta dat one,him and govnor Akinwunmi Ambode go see and he go also open di new Alliance Francaise Facility for Eko.
Tori wey we also hear be say,Femi Kuti wey kontiniu di miuzik mata for wia him papa stop,go sidon gidigba dey wait to welkom di France President for Shrine.
Friday, 29 June 2018
SUPER EAGLES STRIKER IGHALO DON TELL PIPO WEY WON KILAM BICOS HE NO FIT SCORE AGAINST ARGENTINA SAY,MAKE DEM REMEMBER SAY,HIM NA SOMEBODi PiKiN TOO
Sometimes if pesin yansh too big,e fit affect movement but I know won biliv say na bicos Super Eagles player Odion Ighalo yansh too big naim make am no fit score goal for us against Argentina.
Anyway,na wetin some pipo dey talk be dat sha.
Ighalo afta di match don apologise to Nigerians say make dem no vex say him fall our hand for di world cup match.
He say na football and na so e dey be sometimes.
He kon also use opotuniti beg pipo wey dey threaten him and he famili say,make dem calm down and remember say him na sombodi pikin too.
Thursday, 28 June 2018
MICHAEL JACKSON PAPA 'JOE JACKSON', DON DIE AT THE AGE OF 89
Joe Jackson, di papa of di king of pop miuzik Michael Jackson,don die at di age of 89.
He don dey sick for sometime now bifor he die and naim be him shidren manager wen he dey alive.
He die two days afta di nomba 9 anivasri of di death of Michael Jackson imsef wey die for June 25,2009 at di age of 50.
Tuesday, 26 June 2018
WIT OVER 87 MILLION POOR PEOPLE, NIGERIA DON OVERTAKE INDIA AS COUNTRY WEY POOR PEOPLE FULL PASS FOR Di WORLD
If 87 million pipo naim poor for naija, naim be say na evribodi niali poor finish.
Akordin to di new report of di Brookings institution,data of di World poverty clock,e show say 87 million Nigerians dey poor.
Wit dis one, we don ovatake India as kontri wey get di highest number of poor pipo for di world.
Monday, 25 June 2018
R. I. P: SAD DAY FOR NIGERIA ENTERTAINMENT AS D'BANJ PIKIN 'DANIEL D' THIRD' DIE YESTADAY FOR SWIMMING POOL
Dis na one tori wey weak evribodi for di entatainment industri as one of di biggest name for di game D'bgun, lost him one year old pikin 'Daniel D'third' yestaday.
Akordin to di tori, dem say di pikin die for swimming pool.
Daniel just selibrate him one year birthday last month.
Dis news be like joke,too bad!
Make God give di famili Di kankpe heart and strong heart to bear dis painful loss.
Sunday, 24 June 2018
YORUBA SINGA, 'SMALL DOCTOR' DON YARN SAY, ALL Di RUMORS SAY HIM COLLECT N2 MILLION WEN HIM VISIT BUHARI FOR ASO ROCK, NA FAT LIE!
Small Doctor,,di bobo wey sing 'otigba penalty wó throwing' don yarn say, all di talk of say dem dash dem N2 million each afta dem visit President Buhari for Aso Rock, na fat lie.
Small Doctor togeda wit Sound Sultan, Actor Kunle Afolayan and big broda naija housemate Tobi, bin visit Buhari some weeks ago and forma direktor on New Media for PDP talk say no 2million each dem collect for di waka.
Small Doctor don come out to yarn say him no see dat kain money for eye and among di rest pipo, nobody telam say dem give dem money.
Small Doctor no shout again we don hear you.
Even though dem give you nobodi dey follow una drag.
Saturday, 23 June 2018
CHELSEA LEGEND 'DIDIER DROGBA' DON PRAISE SUPER EAGLES AHMED MUSA GOALS AGAINST ICELAND FOR Di WORLD CUP AND HE SAY Di WAY MUSA TAKE CONTROL Di FIRST GOAL NA FIRE!
Chelsea legend Didier Drogba wey di world know for him wondaful ball control wen he won score goals, don praise Super Eagles Ahmed Musa ball control for di first goal wey he score against Iceland yestaday.
Musa naim score di two goals wey Nigeria take win dem yestaday for di world cup match wey dem play.
Drogba praise Musa during di joinbodi sidon wey he follow BBC sport pipo dey do as e take concern di 2018 FIFA world cup for Russia.
Subscribe to:
Posts (Atom)







