MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday, 31 July 2018

ATIKU DON YARN TORi PIPO SAY,BASE ON SAY HIM NA MAN WEY SABi,IF PDP NO CHOOSE AM AS Di CANDIDATE WEY GO BATTLE BUHARI FOR WHO GO BE NAIJA PRESIDENT FOR 2019,E NO GO NICE AT ALL


Atiku Abubakar don yarn tori pipo say naim be di right man for PDP.
He say di mata no go swit for ear if dem no givam di ticket to run against Buhari.
Akordin to di tori man for Atiku,Segun Showunmi,he say him masta naim be di real pesin way go fit win Buhari comot for Aso Rock and solve Nigeria problems base on say him don undastand naija problems welwell.

Sunday, 29 July 2018

Di REASON WHY P SQUARE BREAK UP AKORDIN TO MR P NA BICOS,HIM TWIN BRODA PAUL,DEY ALWAYS INSULT HIM WIFE AND CHILDREN


Peter a.k.a Mr P one of di P Square brodas don yarn one TV station for Kenya say,him twin broda Paul dey always insult him wife and children and dis one  naim be di reason why dem break up.
Peter say,Paul can't dey insult him famili and at di end of day he go expect dem to joinbodi togeda kon dey sing for stage.
He say bifor dem go comeback dem must settle dat lack of respect for him famili.

Saturday, 28 July 2018

SUPER EAGLE GOALKEEPER 'CARL IKEME', DON ANNOUNCE HIM RETIREMENT FROM FOOTBALL BICOS HIM DOCTOR ADVICE AM TO STOP AFTA Di TRiTMENT OF Di LEUKEMIA SICKNESS


Super Eagles goalkeeper Carl Ikeme don give up football as he don announce him retirement from di round leather game.
Last year,doctors diskova say strong leukemia sickness dey him bodi.
Afta di tritment,him doctor advice sam to quit football for him own good.
Yestaday Carl Ikeme finalli announcretired I training ground of him club 'wolvahampton wanderers' a.k.a Wolves say him don finalli retire from football.
Dis one dey painful bicos na di best goalkeeper wey we get him ba and dis same sickness naim make am no go di Russia 2018 FIFAworld cup wey just finish.

Friday, 27 July 2018

TIMAYA DON YARN TORi PiPO SAY,HIM NO BE HUSBAND MATERIAL AND FOR NOW,HIM NEVA READY FOR MARRIAGE WAHALA AT ALL!


Di egberipapa 1 of Bayelsa,Timaya,don yarn tori pipo say,him no be husband material even tho him don get three shidren wit two different women.
He say for now him neva readi for marriage wahala.
Hmmm,na wa o.

Wednesday, 25 July 2018

Di FAMILY OF DAVIDO GIRLFRIEND CHIOMA,DON DEY PARA SERIOUSLY AFTA CHIOMA STOP TO GO SCHOOL BICOS OF DAVIDO


Di famili of Assurance baby Chioma wey be Davido honey,don dey para siriosli afta dem say di girl don stop school bicos of Davido.
Akordin to di tori,dem say she enta Babcock Univasiti for 2012 and she sopose finish school by 2016 but bicos of Davido she neva still finish till now.
If you dey follow up, you go know say Davido buy Chioma one wicked motor wey dem dey call ..Porsche.

Tuesday, 24 July 2018

TWO FIGHTING AS KISS DANIEL DON YARN SAY HE CANNOT DO SONG OR SING WIT REEKADO BANKS LAiLAi


Akordin to tori wey we don gada, Kiss Daniel don say him no won feature for any song wey Reekado Banks dey.
Some weeks ago,Harrysong reliz him new song Selense and he feature Kiss Daniel and Reekado Banks for di song and he be like say Daniel no know say na dem two voice dem join for di song.
Wen time reach for di video,Kiss Daniel say ova him dead bodi foram to dey di video and na Harrysong manager naim tell us dis sikrit.

Monday, 23 July 2018

GERMANY WORLD CUP WINNER 'MESUT OZIL' DON YARN SAY,IF Di TEAM WIN DEM GO CALL AM GERMAN BOY BUT IF DEM LOSE DEM GO REMEMBER SAY HIM PAPA NA FROM TURKEY


Arsenal and Germany player Mezut Ozil don resign from Germany national team and he don give veri strong reasons.
He say him spirit no dey wit di team again bicos dem dey blame am for evritin wey affect di team.
For example,dem knock Germany out for first round From  di Russia 2018 FIFA World Cup and dem kontiniu to blame am and dis one don make am tell di team bye bye.
Akordin to Ozil he say,if di team win dem go call am German boy but if di team fail dem go rememba say him papa wey born am na from Turkey.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...