MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday, 30 September 2018

YORUBA ACTRESS BUKKY OLAOLUWAKIITAN DON TALK SAY,WEN SHE LOVE SHE DEY LOVE LIKE FOOL


I no dey surprise say Yoruba actress Bulky Olaolukiitan yarn say,if she love she dey love like fool.
Love itsef na fool to some pipo.
She say wen she dey in love she dey always like to please her bobo and displease hersef and at di end of di day,na she go kon suffer evritin wen dem break up.

Saturday, 29 September 2018

NAFDAC DON ADVICE NIGERIANS MAKE DEM TRY TO DEY AVOID ROTTEN TOMATOES IF DEM NO WON CATCH CANCER WEY BE VERi BIG SICKNESS



Di National Agency for Food Administration and Control,NAFDAC,don advise all Nigerians make dem dey kiafu of rotten tomatoes.
One of dis deputi direktor Christiana Essenwa naim yarn dis one for Onitsha.
She say,rotten tomatoes get micro organism wey fit give cancer so fiafor,make we try dey avoid am.
I knocked say my frends wey go dey read dis one now go vex talk say,notin dey appun,disease no dey kill Blackman.

Thursday, 27 September 2018

NO BE NEWS AGAIN SAY OBASANJO DEY TALK SAY "BUHARI MUST GO" BUT Di NEWS NOW BE SAY,OBASANJO PIKIN 'OLUJONWO' SAY "BUHARI MUST STAY TILL 2023"


Forma presido Olusegun Obasanjo pikin Abraham Olujonwo Obasanjo don throw him support behind Buhari to win di 2019 election even tho him know say him papa don widraw him support from Buhari. If you dey follow up,you go don know by now say Obasanjo don blast Buhari tire say,evritin don kpafuka since Buhari come back to pawa for 2015. Papa and pikin dey different camps. E be like say dis drama go sweet

Wednesday, 26 September 2018

STRIKE NOTICE: THE NIGERIA LABOUR CONGRESS NLC,DON FIX TOMORROW AS Di DAY WEY STRIKE GO START FOR Di FULL NAIJA SINCE GOVMENT REFUSE TO INKRiZ WORKERS SALARY


Di Nigeria Labour Congress NLC don finish arrangement to go on strike tomorrow if gofment still refiuz to do something about workas salary wey oyibo call minimum wage.
Tomorrow naim go make am exatli two weeks wey NLC don give gofment strike warning if dem no shook mouth put for di mata.



Tuesday, 25 September 2018

ONE JAMAICA MAN ON TOP INSTAGRAM DON YARN TORi PIPO SAY,E BETA MAKE DEM PUTAM FOR INSIDE PRISON FOR LIFE INSTEAD OF AM TO EAT AMALA


I no biliv say na good ting to disrespect anoda man culture as one Jamaica man on top Instagram just insult Yoruba pipo most popular food,Amala.
Di Jamaican bobo for di video wey don dey enta evriwia yarn say,instead of am to eat amala,e beta make he spend di rest of him life for prison.
He say for eye,Amala look like shiit.
Di guy also yarn say,from di way wey amala look, na di type of food wey babe go cook for her guy and her guy no go like go di girl house next time.


Monday, 24 September 2018

SAD,SAD,SAD NEWS! THREE MONTHS AFTA REGGAE LEGEND 'RASKIMONO' DIE,HIM WIFE 'EFEMENA' DON DIE TOO



If you dey follow up,you go know say Reggae legend and Under Pressure singa Raskimono die three months ago at di age of 60 and dem bury am last month.
Anoda sad news don hit dia famili as him wife 'Efemena Okedi' die on di 23rd of September, 2018.
Dis news go put di famili for unda pressure as we here say,she die of high blood pressure.
Dis tori no swit for ear at all.
May her soul Rest in Peace... Amen.

Sunday, 23 September 2018

ATIKU GO BE PRESIDENT FOR 2019 WEDA OBASANJO SUPPORT AM OR NOT ACCORDING TO 'TAHIR SHEHU' Di ADAMAWA STATE PDP CHAIRMAN


Some days ago,forma sivilian and khaki president Olusegun Obasanjo yarn tori pipo say,if him support Abubakar Atiku to bikom president, even God no go forgivam.
Now Adamawa PDP chpridon.,Tahir Shehu, don shook mouth put as he yarn say,Obasanjo don forget say,Atiku naim hepam if not,Abacha for kilam for prison.
Tahir Shehu also yarn say,since Obasanjo no be God,weda he soport Atiku or not, Atiku go bikom naija president come 2019.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...