MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday, 31 October 2018

THE NIGERIA LABOUR CONGRESS,NLC, DON DEY DRAW NAIJA PIPO EAR SAY,MAKE DEM BUY 'FOOD FULL HOUSE' BIFOR NOVEMBER 7 BICOS,SERIOUS STRIKE DEY COME


Akordin to di Nigeria Labour Congress NLC, di strike wey go start on Novemba 7,go  sirious pass high fever.
And dem don advice say buy rice,buy beans,buy onions,buy any food wey go last you bicos, di strike wey won start by next week go tie wrappa and wear agbada on top.
For some time now,NLC don dey beg gofment make dem inkriz workers salari wey oyibo dey call minimum wage from 18k to 56k.
Dem don dragam tire wit gofment sotay dem don say make govment dey pay workas 30k but di govnors now dey yarn say na N22,500 salary dis pawa reach and na dis one make NLC dey draw our ears say,dis time around di strike go carry high current so diafor,buy food for house.

Tuesday, 30 October 2018

BIG FISH 'CRISTIANO RONALDO' DON BREAK ANODA RECORD AS HE DON BECOME Di PESiN WIT THE HIGHEST NUMBER OF FOLLOWERS ON TOP INSTAGRAM FOR Di WORLD


Juventus and Portugal soccer star Cristiano Ronaldo don kontiniu from wia he stop as he don kontiniu to tumble more records.
He don break records tire for field and now di records don kontiniu to fall on top sosha midia.
Just yestaday,Ronaldo break di Instagram records as he bikom di pesin wit di highest numbers of followers on top Instagram.
Bifor we enta our tori room,di bobo don get over 144 million three hundred and somtin followas.
Na America singa Selena Gomez bin dey wit di record since 2016
She bin take ova from anoda singa Ariana Grande.

Monday, 29 October 2018

SEE GOBE! OLAMIDE AND WIZKID CONCERTS GO HOLD FOR THE SAME DAY (DECEMBER 23RD,2018) AND LAGOS BALLERS DON DEY DIVIDED ON WHICH PESIN OWN DEM GO ATTEND



Di Made in Lagos show wey Wizkid dey do for Eko hotel and di OLIC4 wey Olamide wan do for Eko Atlantic,go appun for di same day wey be December 23,2018.
Dis na problem for fans for Lagos as dem dey konfiuz on which pesin own dem go attend.
See gobe!

Sunday, 28 October 2018

RAPPER 'YCEE', DON YARN TORi PIPO SAY,FOR Di INDUSTRi DiS YEAR,NOBODY DESERVE THE 'MUSICIAN OF THE YEAR' PASS BURNA BOY



Omo Alhaji and Jagaban rappa 'Ycee' don choose Burna Boy as him miuzishan of di year.
He postam on top him twita account and e be like say him no joke about am.
Afta he yarn am,many pipo wey yarn concerning di mata gree say,dis year belong to Burna Boy.
True true di boy dey on fire afta he bless di industri wit him 'Outside Album' early dis year.
If you dey follow up,you suppose know say about two years ago,naija intanashona singa 'Jidena' yarn tori pipo say,Burna Boy na confam talent and we nor know di talent wey God bless us wit yet.
And true true di Port Harcourt propati neva disappoint.

Saturday, 27 October 2018

OBA OF LAGOS DON YARN TORi PIPO SAY,IF PRESIDENT BUHARI WIN THE 2019 ELECTION AGAIN,HIM GO ADVISE AM TO CLOSE OUR BORDERS MAKE OBASANJO NO ESCAPE



Di Oba of Lagos Rilwan Akiolu don kontiniu him fight wit forma khaki and sivilian presido Olusegun Obasanjo.
He say instead of Obasanjo to face naija problems dat time wen he win election for 1999, na as he won take kapchor Lagos naim he pursue for him first four years.
Di good ting akordin to di Oba be say him no givam dat chance.
He say Obasanjo no be beta pesin and if President Buhari win next year election, him go make sure say him advise am make he close down our borders make Obasanjo for no eskape.
Di Oba go selibrate him 75 years birthday few days from now.
I go siddon for fence dey watch wetin Obasanjo get to yarn for dis mata and imidiateli he ansa di Oba,una go ridam hia.

Friday, 26 October 2018

TIWA SAVAGE DON TALK SAY,IF THE 'GUM BODY' WEY SHE AND WIZKID DEY DO..DEY GIVE ANYBODY HIGH BLOOD PRESSURE, MAKE Di PESiN CHARGE HER TO COURT



The pipo of di moment,Tiwa Savage and Wizkid friendship,don dey give wahala big problem.
Some pipo don dey call Tiwa Savage names since dem take dia gumbodi go di next level espeshali afta she fichor for Wizkid record breaking video 'Fever' wey don turn di world upside down.
Some say she be Olosho,some say she be afta one',some say she be old mama youngie wey dey fool hersef for small boy Wizkid.
Mama Jamjam hersef don come out yarn say,anybodi wey get ploblem wit she and Wizkid kemistri,get right to charge di mata to court.
One ting for di mata be say,pipo dey forget say dis pipo na entatainas and dem get right to push dia karia to di next level wit all manners of stunt.
If you dey follow up,you go don notice say dis dia joinbodi don fetch dem records.
Dem win award last year for di best colabo wit Tiwa song 'Malo' and Tiwa sef don yarn say dis na just di beginning of dia friendship.

Thursday, 25 October 2018

MANY AFRICANS DON DEY PRAISE LIBERIA PRESIDENT 'GEORGE WEAH' AFTA HE DECLARE FREE EDUCATION FOR ALL PUBLIC UNIVERSITIES FOR Di KONTRi


Weda di free education for univasitis wey di 1995 World footballer of di year and Liberia president 'George Weah' declare go last or not,Africans don show say dem no wan know.
Di only ting wey dey dia head right now be say,foram to statam at all,dem dey veri hapi as many Africans still dey shawa praises on di man of di moment afta he say,no more school fees for Liberia public univasitis .
Dat kontri dey live on low budget and even for one year dem no fit make di kain money wey Nigeria dey make for one day but yet,our leaders dey fall our hand.
We need freedom for dis kontri.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...