Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Wednesday, 30 January 2019
TANZANIA STAR 'DIAMOND PLATNUMZ' DON DEY BEG DIA GOVMENT MAKE DEM DECLARE HIM MARIAGE PUBLIC HOLIDAY MAKE ALL HIM FAMILY MEMBERS FIT ATTEND
Diamond Platnumz don kneel down dey beg di Tanzania gofment make dem declare him marriage day as public holiday so dat him famili membas go fit liv work attend di marriage.
Although him bin don get Pikin wit him baby mama bifor but now him don decide to marry him Kenya model girlfriend Tanasha.
Him bin fix di marriage for Valentine day but bicos Tanasha mama go dey work dat day,him kon shiftam go front small make di babe mama fit show for di ground.
Monday, 28 January 2019
IF YOU BIN DEY LOOK Di 50 YEARS OLD YORUBA ACTOR 'FUNSHO ADEOLU' WIT BADBOY EYE,HE SAY U NO TRY AT ALL BICOS HIM DEY CHURCH KWAYA SINCE 1982
One ting about film be say,if you dey act bad pesin role,pipo go dey see you as bad pesin for real life.
One bobo wey no sabi quick laff for film Funsho Adeolu,don yarn tori pipo say,him na gentle man for real life even tho say dem dey look am wit badboy eye bicos of film.
Di popular 50 years old nollywood Yoruba actor also yarn say,na since 1982 him join kwaya for church.
Nice one sir but you join kwaya no mean say you no fit still be bad boy.
Sunday, 27 January 2019
AFTA ACTRESS LIZZY ONUWAJE CONFESS SAY SHE NO DEY WEAR PANT AGAIN BICOS OF YAHOO BOYS RITUALS,ANODA ACTRESS'NAZO EKEZIE' SAY,SHE DON STOP TO WEAR PANT TOO
Nollywood actress Nazo Ekezie say she don stop to wear pant bicos rumors don full town say guys mostly yahoo guys dey use girls pant do rituals make maga for dey pay wella.
Dis one dey come few days ago afta anoda nollywood actress Lizzygold Onuwaje also confess say she don stop to wear too bicos of di same reason.
Wen dis drama go end?
Saturday, 26 January 2019
SINGA 'MR EAZI' DON CLEAR PIPO SAY,E DEY WRONG WELWELL FOR ANYBODi TO THINK SAY HE GET TEMI AS HIM GIRLFRIEND BICOS OF HER PAPA FEMI OTEDOLA BILLIONS
Leg over singa Mr Eazi,don yarn say,him no dey afta billionaire Femi Otedola money as pipo dey talk.Femi Otedola daughta Temi,na Mr Eazi girlfriend and pipo don dey yarn say,na di girl papa money he dey afta but Eazi say anybodi wey dey tink like dat get sef worth issues.
Wednesday, 23 January 2019
SINGA 'NINIOLA' WEY BE THE SENIOR SISTA TO 'MY PAPA NO BE DANGOTE SINGA 'TENI,DON BUY JAMB FORM GIVE 30 STUDENTS
Niniola don use her foundation and office 'Adopt a child education'take buy Jamb forms for 30 pipo.
Dis na veri good behavior and koret example to copy.
If you dey follow up,Niniola na sinior sista to di babe of di moment 'Teni' and two of dem don show say talent dey dia famili.
Tuesday, 22 January 2019
FEDERAL HIGH COURT FOR ABUJA DON STOP EFCC FROM ARRESTING FANI KAYODE AND YINKA ODUMAKIN UNTO THE FAKE NEWS WEY DEM SPREAD SAY,EFCC DON ARREST CHIEF JUSTICE ONNOGHEN
A division of di federa high court for Abuja don stop EFCC from arresting PDP FANI Kayode and Chief Yinka Odumakin afta di two of dem carry fake news say EFCC and DSS don go Chief justice of Nigeria Walter Onnoghen.
If you dey follow up you go know say Federal gofment bin get ploblem wit Onnoghen unto say dem say he get some kain wuruwuru bank accounts and he no declare all him propatis wey him get afta dem make am Chief Justice.
Sunday, 20 January 2019
FALZ DON YARN TORi PIPO SAY,THE REASON WHY HIM NO DEY GO CHURCH NA BICOS,ANY CHURCH WEY HIM GO THE PASTOR DEY LIKE INTRODUCE AM TO CHURCH MEMBERS BICOS HIM NA STAR
Falz the badt guy,one of naija baddest rapper don say make pastors focus on wetin go make dia membas know God beta instead of dem to dey worship supastars.
Some days ago,Falz mama Funmi Falana dey pray make God touch Falz heart make him bigin go church.
Falz imsef don come out to say no be say him no be Christian but him stop to dey go church bicos anytime wen him go church,na so pastors go telam to stand up make evribodi rekognaiz say supastar dey church.
He say di ting dey make am shame and no be wetin dem sopose to dey do be dat.
The bobo say wetin impotant pass na make di pastors kontiniu to dey teach di membas di word of God wey dem go use take see front.
Subscribe to:
Posts (Atom)








