Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Thursday, 28 February 2019
FEDERAL GOVMENT DON SHARE N610.36BILLION NAIRA GIVE FEDERAL SERVICE, STATE AND LOCAL GOVMENT AREAS FOR Di MONTH OF FEBRUARY
If you be civil servant and dem neva arrange your salary give you,naim be say tori don dey enta be dat.
Why be say,federal gofment don share N610.36 billion give both state and local gofments plus even the federal service too.
No need to fear sha as I biliv say di money go reach evri evri.
Wednesday, 27 February 2019
PRESIDENT BUHARI DON FLAT ATIKU ABUBAKAR TO PIECES TO CONTINUE AS PRESIDENT FOR ANODA 4 YEARS FOR THE PRESIDENTIAL ELECTION RESULT WEY INEC RELEASE
President Muhammadu Buhari of APC don win Atiku Abubakar of PDP for di preidential election afta INEC announce say Buhari score 15,191,847 to win Atiku wey score 11,262,978.
Dat na ova 4 million votes naim Sai Baba take win Atiku but as e be so,PDP don come out dey spit fire say,na pure magomago naim APC do to take win dis election.
E be like say na court go end am as dem don reject di result.
Tuesday, 26 February 2019
E DON SHOW SAY BUHARI DON DEY FLAT ATIKU FOR THE 17 STATES FOR THE PRESIDENTIAL ELECTION RESULT WEY INEC DON RELEASE SO FAR
President Muhammadu Buhari don dey flat Atiku for the election wey dem do on Saturday.
Saturday, 23 February 2019
2 SECONDS AS DAY BREAK,ELECTION DON START TODAY TO TAKE CHOOSE PIPO WEY GO RULE NIGERIA FOR Di NEXT 4 YEARS ESPECIALLY WHO GO BECOME PRESIDENT
Afta dem postpone di election from last Saturday to today,finally Nigerians don dey vote for who go rule dem for di next four years.
Today ns elections for house of reps,senate and presidential election.
Report wey dey enta our tori room be say,crowd rili come out to vote.
Friday, 22 February 2019
FORMA SUPER EAGLES PLAYER 'OSAZE ODEMWINGIE' DON YARN TORi PIPO SAY,70% OF AFRICAN PLAYERS BILIV IN JUJU POWER
Forma Super Eagles winga Osaze Odemwingie don yarn say 70% of football players wey be Africans biliv say juju na evritin for football.
He say Africa players biliv juju sotay if dem injure,dem biliv say na juju man medicine naim go cure dem.
Tuesday, 19 February 2019
GHANA MUSICIAN 'MZVEE' DON YARN TORi PIPO SAY,SHE DON SWEAR SAY,SHE NO WAN MARRY BICOS GHANA MEN DEY TREAT WOMEN LIKE SLAVE
Ghana star Mzvee don yarn say,Ghana men dey treat girls like slave and na dus one go make her swear say she nk go marry.
Monday, 18 February 2019
GUN MEN DON KILL APC CHAIRMAN BONIFACE OKOLOHO OF IHIMINI LOCAL GOFMENT AREA FOR BENUE STATE
APC chairman for Ihimini local gofment area for Benue state don die just like dat afta gun men kpai am.
Subscribe to:
Posts (Atom)





