MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday, 27 July 2014

SOUTH AFRICA DON CHOOSE SON OF THE SOIL EPHRAIM MASHABA AS DIA NEW COACH



 

KESHI


 Dem say di devil u know is beta dan di angel u don't know as South Africa futbol assosiashun,SAFA, yestaday don choose di angel wey dem know Ephraim Mashaba and scata di hope of Stephen keshi to coach di bafana bafana.
Keshi as many tori pipo don report for di past 3 months dey eye di hot seat for Sauti as e imsef don even yarn say e dey posible say e fit leave di super eagles job and go work for South Africa.
But yestaday,SAFA choose Mashaba wey e guy name na "Shakes".
Mashaba don coach Bafana bafana 3 diferen times b4 and naim be di present coach of dia Under 20 nashona team wey dey Mali presently for training wit di team.
No be onli Keshi South Africa bin dey eye for di post bifor as forma Manchester united assistant to Alex Ferguson and di present Iran coach,Carlos Queroz naim get di brightest chance pass for di job but di salary wey him want big pass wetin SAFA get to pay.
Di gud news for Keshi be say,although him kontrat don finish wit Super eagles afta di world cup for brazil,but NFA executive comiti don announce for di small join bodi meeting on Monday for Abuja wey dem take impich and sack dia chairman,Aminu Maigari,say dem go soon stat to negoshate wit Keshi to renew im kontract.

Wednesday, 23 July 2014

SORRY ARSENAL FANS,LIONEL MESSI NEARLY PLAY FOR ARSENE WENGER LAST SEASON.



If you like call Arsenal 'Top 4 team' but di tin be say 4 time world futbola of di year and di best playa for Brazil 2014 world cup akordin to FIFA,Lionel Messi don tok say,Barcelona get luck,im for sign for arsenal last year.
He say like say Barca kontiniu dat dia shakara not to inkriz im salary,notin for make am no sign for Arsenal futbol club akordin to VOZPOPULI one ogbonge website wey dey for inside Spain.
Yes o!akordin to VOZPOPULI,Messi beg forma Arsenal captain,Cesc Fabregas make he yarn him agent,Darren Dein to arrange him waka to Arsenal but e be like say Barcelona hia di rumor naim dem quik quik giv Messi di salary wey di soca magician ask for.
Arsenal bank account for hear nwhi bicos di money wey Barcelona put for Messi head na 197 million pounds if u won buy am and na smol tin all di moni wey Arsenal don spend for dia history take pass dat moni.
But as di mata be now sha,di small engine big motto for world futbol,Lionel Messi dey on a salary of 16 million pounds a year kontract for Barcelona.

Thursday, 17 July 2014

OJUJU CALABAR DON CAUSE DI DEATH OF ONE 5 MONTHS OLD PIKIN.


 
 No be small tin o,as one masquarade don cause di death of one pikin for  Amakohia Ubi, Owerri West Local Government Area of Imo State.

As di masqurade dey pursue one 10 years old geh wey carry di pikin,she kon run enta backyard but eye of fear,naim di geh trow di 5 monts old pikin for inside 'mama put' pot of soup.
Akordin to Chika,one woman wey see evrytin as e take hapun,she say as di ojuju man see say di pikin don draw for di geh hand enta put of soup,naim e take yawa race.even di geh wey carry di pikin,fall yakata for near fire and na smol tin remain fire for roast her like corn and ube.
Although sha,di villagers try to reskiu di pikin but as dem rusham rich hospito,dokita kon tell dem say di baby don already kpeme.

Sunday, 13 July 2014

MESSI NEVA PLAY ANY BETA BALL FOR DIS WORLD CUP-GARY LINEKER OF ENGLAND

LIONEL MESSI




One of di stars of Italia '90 world cup,Gary Lineker of England don yan say 4 times world futballar of di year,Lionel Messi of Argentina neva play any beta futbol for dis world cup wey go end for Brazil today.
He say tho Messi and Argentina don qualify to play Germany for today final but di bobo neva impress at all apart from di bigining of di world cup wen dem play Bosnia,Iran and Naija.
Lineker say im na Messi nomba one fan and e neva see pesin wey get swit talent richam since afta Maradona.
Gary say he chop plenti colanut make sleep no katcham and e shine im eye welwel watch Messi for dia semi final match against Holland and di only time wey Messi leg toch ball for di goalkipa area na wen e play penarity.Lineker say no be di Messi wey him know be dat.
He say tho Messi don skor 4 goals wen di world cup fest stat but all di smol beta tins wey Argentina play for di match against Holland,Messi no dey involve for any one.
He say anyway sha,if Messi win di world cup e go hepam for di argument of who beta pass bitwin Messi and Maradona.
GARY LINEKER

Gary Lineker also tok say na Maradona be di best playa wey im don play against wen im stil dey tap leather.Lineker say as Maradona shot rich,di kain chocolate futbol wey di guy play no be here .




Saturday, 12 July 2014

CRISTIANO RONALDO BEAT LIONEL MESSI

CR7
Messi fit don qualify to play for di final of dis year world cup for Brazil but Messi moni dey learn for wia di kain moni wey Ronaldo resiv last year for all mata like adverts,salary and all oda gbogboyen.
Akordin to Forbe richest list of sports pipo,one ogbonge magazine wey di hole world dey respet,na only one bobo naim im moni long pass Ronaldo own and dat bobo name na Floyd May Weather Junior.
May Weather na one wicked boxer wey no dey use eye see im felow boxer for inside boxing ring.im blow plenti boxers face swell up and blood even dey rush for some nose and dia eyes.di true tori be say nobodi don defeatam once since e stat to fight. 



FLOYD MAYWEATHER


If u won know di list of di richest sports bobo for di hole of 2013,checkam for bottom hi

  RankNamePay
  #1Floyd Mayweather$105 M
  #2Cristiano Ronaldo$80 M
  #3LeBron James$72.3 M
  #4Lionel Messi$64.7 M
  #5Kobe Bryant$61.5 M
  #6Tiger Woods$61.2 M
  #7Roger Federer$56.2 M
  #8Phil Mickelson$53.2 M
  #9Rafael Nadal$44.5 M
  #10Matt Ryan$43.8 M.

NA ME GIVE MY SINIOR SISTER BELLE BUT NA BY MISTAKE-SHAMSU ISA


One bobo don enta big wahala for kano as e dey tochlite im sinior sista website steady and dis tochlighting don result to belle.
Shamsu Isa,one 25 years old man for Kano don yarn say she giv im sinior sista belle but na by mistake and di handwok of di devil.
Isa tok dis one for court for di mata wey one area fada of Takalmawa quatas report to police on july 4,say e suspect say Isa dey tochlite im sista website.
Isa nor drag all di tins wey dem accuse am of for court as im gree say na true say im giv im sinior sista belle and she dey carry dia baby but im be no mean to giam belle,na one smol tinrinrin mistake e take hapun.
Akordin to di tori,Isa Shamsu sinior sista wey her name na Naima Isa,get smol skonskon for head.she get fish brain and her mind weak finish.she no too complit for tinking and Isa kon take advantage of her fish brain dey sleep witam anyhow.
Di pesin wey dey incharge of di case,Corporal Ibrahim Abdulrazak kon beg court make dem postpone di case so dat police go fit complit di investigashon.
Di judge of di court,Ummi Sani Kurawa,say make dem stil kip Isa Shamsu for prison til wen dem go siddon for di mata again for court on August 4.

BURNA BOY DON SACK HIM MAMA AS HIM MANAGER.

BURNA BOY AND HIM MAMA
Burna boy one of di miuzishan wey dey reign scata for Naija right now,don yarn anoda one again.
Di bobo wey sing dat crazy jam"Like to party" wey plenti bobos and malawis love finish,don announce on top twitta say time don rich for him mama to chill to enjoy di fruit of her labor.
Burna boy mama,Mrs Bose Ogulu wey be him manager since di bobo show face for Naija miuzik,naim dey take kia of how much pipo go pay to fit carry him pikin for show,look for bizness for her pikin,market her pikin,run di day to day bizness and oda mata wey manager dey do.
But now Burna Boy don say"Ha! Mummy dis wok dey make pesin dey quik old,just chill for house and enjoy yor sweat,u don try welwel.anytime wey I won suck breast I go come house,u are my Sweet Mama for life".
Dis bomboy from River state Burna Boy tok say,witout him Mama,im for neva rich wia im dey today.
Di Afro dancehall reggae miuzishan also tok say time don rich for im manager to be im manager and time don also rich for im mama to remain as im mama.
He say from now on,if u won bookam for any show or any oda impotant mata,make u richam for dis address burnaboybookings@gmail.com and just 2 weeks ago di bobo just release one new muzik wey im call Don Gorgon.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...