MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday, 21 November 2014

MY MAMA WANT TO FINISH ME WITH JUJU AND OTUMAKPOR-ADEBAYOR


Tori pass tori and dis tori, na one tori wey go make u wonda for tori.
Di tori wey dey reach our backyard since morning be say,Tottenham hotspur and Togo attacker Emmanuel Seyi Adebayor, don tell one Ghana radio station say,why he abandon im mama na bicos she dey do juju to winshy im career.
Adebayor say, "why I no go mind my bizness and dey on my own jejeje, wen e be say na my own mama dey tell evribodi say my hussle no go pay".
He say make im maleh stop to do juju against am if dem want make dem settle dia quarel.
Akordin to wetin im sister,Mageret tell Peace Fm for Accra, Ghana , she say Adebayor don abandon dia momsie and drive dem comot from im hause and na padlock and polythene bag di mama dey sell now for Togo and Ghana border.
Maggie also say if no be dia junior broda for Germany, Kola Adebayor wey rent house for dem to stay, maybe na undabridge dem for dey sleep now.
Di Togo captain deny am and say na only im mama use her leg waka comot for di hause.
Di forma Africa footballer of di year also yarn say,im family no value all wetin he dey do for dem since including di 35,000 tausand dollars car wey im buy for di junior sista,Lucia and even di hause wey im build for dem for East legon.
He say dia own na to dey spoil im name and do juju do kill im destiny.
Dis season, Adebayor no dey form at all as he don score only one goal out of ten matches wey he don play for spurs.
Di Adebayors, na beg we dey, make una try settle unasef.

Thursday, 20 November 2014

MRS MUGABE PLANNING TO SUCCEED MR MUGABE


PRESIDENT ROBERT MUGABE AND MRS MUGABE
Jaguda get oga.
Zimbabwe president, 90 years old Robert Mugabe, di numba one oga jaguda for Zimbabwe, wey don get kwanta wit almost all America president and wey don rule Zimbabwe for almost 40 years, don dey hatch anoda hidden agenda, as  he don almost conclude plans make him wife,Grace Mugabe succeed am if he decide to step down akordin to reports.
Who no know go feel say na him wife Grace Mugabe be vice president as she don almost won take over di position of di vice president to her husband, Mrs Joice Mujuru .
LEAVE ME ALONE! VICE PRESIDENT, JOICE MUJURU DEY TELL MRS MUGABE

She tell Mujuru to resign bicos akordin to her, she no like di Mugabe's family.
49 years old Mrs Mugabe,also dey accuse Vice President, Joice Mujuru say she dey plan to kill her husband make she bicom Zimbabwe presido.
Wit di rally dem wey she dey hold all ova Zimbabwe now and di kain tins wey she dey yarn di crowd, u go know say Grace Mugabe don make up her mind to take over di role of her husband and her husband go take over di role of di first lady.
For one of di rally, she yarn di pipo say,time don reach for her to show di pipo wetin she be.she say she be no won enta politiks bifor but since pipo dey force am, she don ready to serve dem.
She say,"some say i won be president.Why not?no be Zimbabwe I come from too?
Di oposition to her husband no like her behavior as dem get one guy name foram, "Dis Grace".
Dem say na she dey force her husband not to step down bicos of she won kontiniu her large life of travelling abroad to dey shop for expensive jewelleries, gold, diamond and oda shakara tins.

I NO DEY CHARGE FOR COLLABOS-ICE PRINCE ZAMANI

Ice Prince don join di list of few artiste wey don yarn say, dem no dey charge any money bifor dem go do collabo wit oda musicians unlike Wizkid wey report confam some few weeks ago say,he charge Saeon N1.5milla to feature for her song "Boogie down".
Wizkid even yarn say if craze enta him head, he fit charge 10 million naira for collabo.
ABOKI, ICE PRINCE
But for one sharp tongue twisting to wetin Wizzy yarn, Chocolate City superstar rapper, Ice Prince Zamani, don yarn say,him no dey collect shishi to sing for pesin song but he say sha,di pesin music must sweet foram to get interest.
He yarn all dis one wen he dey answer questions wey radio and tv celebriti,Olisa Adibua dey askam for im show, The Truth.
Ice Prince say although evribodi get dia own laws on how dem dey run dia show but for him,he no dey charge any penny to do collabo.
He even say anybodi wey doubtam, make he ask di pipo wey im don feature for and dem go yarn dem di same tin.

Wednesday, 19 November 2014

3RD WORST HIT EBOLA COUNTRY DON QUALIFY FOR AFRICA CUP OF NATIONS

GUINEA FOOTBALL TEAM
I hope say dis one no go be a case of yanga dey sleep trouble go wake am as Equatorial Guinea, di new host of di Africa Cup of Nations get a lot to do afta dem agree to replace Morocco wey withdraw from hosting di tournament for fear of Ebola spread.
One of di kontri wey Ebola case for plenti pass, Guinea, don qualify for di tournament wey go take place for Equatorial Guinea for January 2015.
Infact dis latest Ebola wahala wey later spread enta Sierra Leone, Liberia, then Nigeria, na Guinea e for start last Decemba.
As at Novemba 11, na 1,919 Ebola case naim dem don report for Guinea out of wich, 1,166 pipo don die.

FOOTBALL FANS
Di tori now be say, how Equatorial Guinea go take fight dis war wey dem buy wit dia own hand as tausands of fans go travel enta di kontri wen di nations cup stat.
Since di quickest way to catch dis Ebola na thru handshake and sweat from bodi contact,Equitorial Guinea get a veri worryment work to do.
I wish dem and Africa di veri best of luck.

BYE BYE STEPHEN KESHI

Afta failing to qualify di defending champions, Super Eagles for di Equatorial Guinea 2015 nations cup with dis 2-2 draw with South Africa,i dey sure say dis na Keshi last match for Eagles.
Amaju pinnick over to you.

BETWEEN MAHEEDA,KIM KARDASHIAN, HUDDAH MONROE,...WETIN DIS WORLD DEY TURN TO? 18+ ONLY

Wetin dis world dey turn to?
For sometime now,many celebrities like Nicki Minaj, Kim Kardashian, Rihanna, Huddah Monroe and Vera Sidika from Kenya and even our own Maheeda,dey see am as normal ting to dey show dia kpekus for di world to dey see.
One tin come my mind and i dey ask, bifor dis pipo dey show dia nakedness and dia website, wey suppose to dey veri private, who dey give dem di go ahead?
Na dia husband/boyfriend or dem dey wake up and decide to craze on dia own?
Dia papa and mama no dey vex for dem at all?




Monday, 17 November 2014

THE WORLD GO RUN OUT OF COCOA BY 2020




For those of una wey love chocolate and love to dey drink light or thick tea, dis news no go sweet una for ear at all bicos di world go likely run out of cocoa by 2020 akordin to di report wey dey reach our table.
Di biggest chocolate company for di world, Barry Callebaut, wey base for Switzerland,don add dia voice join di talk of say, di world fit dey short of cocoa by 2020.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...