If u no dey di MKO Abiola stadium for Ogun State yestaday,naim be say u miss welwell as Baba Iyabo show some kain skills for field wen he play football match wit him friends and Govnor Ibikunle Amosun of Ogun State to celebrate im 78 years baitday.
If u see baba di way wey baba be for inside jersey and boot dat day,u go fear fear.
Pipo feel say dem go use ambulance carry baba comot for field but who sai!
Baba dey fit finish and he show say im get stamina pass dem John Terry and Lukaku.
Obasanjo naim be skippo for him Presidential Library team and he skor two goals why di Special Assistant to the governor for Special Duties mata,skor di only goal for Govnor Amosun team.
If no be say OBJ miss many skoring chance dat day he for skor reach ten goals.
Picture no dey lie.
Check out di pictures for bottom hia:
Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Thursday, 5 March 2015
Wednesday, 4 March 2015
WHY WE DEY KILL OURSELVES OVER NAIJA POLITICS WEN BODE GEORGE PIKIN DEY LIVE EASY LIFE FOR OBODO OYIBO(PHOTOS)
Why we dey kill oursef ova notin?
Why we dey allow politicians use our head dey play kalokalo and our politicians shidren dey abroad dey flenjo?
Dis na one question wey our politicians no dey want make you ask bicos u no go eva get any beta answer from dem.
So diafor,no mata how u ask dis question reach,u are on a long tin.
Take for example,one of di PDP godfather of naija politics,Oga Bode George model pikin,Yinka George just release some kain picture wey go make some gehs dey say,chai!see suntin!see fine bobo!
Talk true,bitwin me and u,u see di bobo like who go put im life for ground and ready to die for PDP,APC mata?
A word don do for di wise,so wise up naija pipo.
Check di bobo pictures yorsef for bottom hia:

![]() |
| YINKA PAPA,BODE GEORGE |
CAMEROON ARMY OGA DON YARN SAY BOKO HARAM MEMBERS PLENTY PASS SOLDIER ANTS
Colonel Joseph Nouma,Commanda of operation ALPHA,di millitary operation wey Cameroon govment form to take fight Boko Haram don yarn CNN say,Boko Haram membas plenti welwell no bi small.
He say di more dem dey kill dis terrorist,di more dem dey germinate like fresh vegetable.
He also talk say,e be like say Cameroon pipo sef don dey Join Boko Haram.
Akordin toram,he say boys and men bitwin di ages of 10 to 45 years from many Cameroon villages wey dey around Nigeria border,don dey join Boko Haram.
Anoda Cameroon army oga,Colonel Jacob Kodji,di interim commanda of di 4th millitary region, also yarn say,as dem dey kill Boko Haram na so dem dey recruit new membas too.
He say dis kain development dey make tins dey difficult for dem.

I GO RESIGN IF NFA EMPLOY KESHI-PAUL BASSEY
E be like say di tin wey dey delay di Nigeria Football Federation,NFF from announcing Stephen Keshi as Super Eagles coach go still continiu if NFF take wetin dia memba Paul Bassey yarn yestaday,sirios.
Memba of di NFF technical Commiti,Paul Bassey don yarn say im go resign if NFF appoint Keshi as Eagles coach.
Bassey say di tin dey buss im brain and e dey pain am reach im bone say dem still dey discuss weda to renew Keshi contract or not.
He say di day wey im hear say NFF announce Keshi name as Naija coach,na dat day im go resign.
He also yarn say him don work wit Keshi for good four years and he don find out say di coach nor get anytin new to offer us again.
Paul Bassey say di illa,Delta State born coach na legend for our football but if na for coach mata,Keshi no biam at all bicos akordin toram,di big boss know wia im coaching skills end but he dey form like say he sabi welwell.
He say we need new coach wey go bring fresh tactics and fresh tins enta di mata so make Keshi go siddon one place.
Stephen Keshi contract end last year and NFF kon sackam afta Super Eagles win Sudan 3-1 for Abuja for one nations cup qualifier but President Goodluck Jonathan say make dem call am back to handle di remaining matches and yet him no fit qualify Naija for di nations cup wey just end for Equitorial Guinea as na only draw instead of win naim dem play against di Bafana Bafana of South Africa.
Saturday, 7 February 2015
2FACE SAY MAKE GOVERNMENT INTRODUCE PIDGIN ENGLISH ENTER SCHOOLS
2baba don yarn say make govment use dia church mind and introduce pidgin
langua enta naija skuls espeshally all dose skuls dem for villa.He
yarn say all dose smallie for villa na pidgin english be most of dem
second language,so for dat rizin,e good make govment introduce am to
develop dia yarnings and to use am transfer knowledge to dem since dem
undastand di language like a,b,c.2face yarn all dis one on top dia join bodi talk for MTV Base wey dem dey call #Choose Or Lose Round table wey go start dis friday.
.jpg)
2face yarn say,dem fit employ some pidgin professors like you and me,pipo wey sabi di pidgin english langua reach ground.
He say dis na di only way wey dem fit take reduce di gap bitwin pipo wey dey use big big grammar and pipo wey dey soak pidgin language.
Wednesday, 4 February 2015
OSINBAJO DON PLEDGE TO GOD NOT TO THIEF PUBLIC SERVANTS MONEY
Di man wey go bicom di second in command for naija just incase General Muhammadu Buhari win next weekend presidential election,Profesor Yemi Osinbajo don say,if you no go believe am for anytin at all make u believe am for only one tin.
He say if he bicom di vice president,he can neva touch government money.
He say if dem like make dem givam Central Bank key,im no go touch govment kobo lailai.
He yarn all dis one yestaday on top twitter.
He say him don enta agreement wit Baba God say im no go tiff govment money bifor and afta.
Many pipo go say na lie lawyas take dey chop why many pipo go won biliv all dis kain talk if na pastor talk am.
Profesor Yemi Osinbajo na lawya and sinior pastor at di same time for Redeem christian church of God,RCCG.
You biliv say dis man no go touch gofment money if im oga,Buhari win Goodluck Jonathan for di election of who go bicom Nigeria presido for 2015?
ABOMINATION! ROBBERS DON ROB 60 YEARS OLD WOMAN OF PLACENTA
Two robbers run out of ideas yestaday for Agboju area of Lagos as dem snatch bag from 60 years old mama hand.
Di placenta of di baby boy wey her daughta just deliver for hospital dey inside di bag.
Money and some oda tins also dey inside di bag.
Di woman wey her name na Mrs Onwumere bin dey go troway di placenta but she kon stop for Agboju market to buy ingridients to take prepia pepper soup for her daughta base on say she just born.
All dis drama appun around 9 PM and mama sef dey veri sad for wetin di robbers do toram.
Na pipo wey dey around dat nite na dem kon gada money give di woman wey she take finally buy di pepper soup tins.
Subscribe to:
Posts (Atom)